Blog horizontal

Background

Lagos

Lagos CP Fatai Declare Say Old Police Doings Don Pass, Ready For Collabo

By: Esther Ayoola Lagos State Commissioner of Police, Fatai Tijani don drop promise say gone are those days wey pipo go dey fear police, say like dis na collabo doings di police dey do. Di new commissioner yan dis on Friday for command headquarters for Lagos ahead of 2026 Police Week wey go start on Monday. According to am, modern policing need cooperation, respect and trust, and na why dem […]

todayMarch 27, 2026 10

Lagos

How Lagos Gorment Do Give Away For Families Of Dia Late Civil Servant

By: Esther Ayoola Like dis now, di Lagos State Gornment don begin share N701 million plus to 232 families of public servants wey kpai while working for di gorment. Say na commissioner of finance, Abayomi Oluyomi ni run di parrol, praising Governor Babajide Sanwo-Olu for always putting  workers welfare first. According to report, di Families enter Ikeja on Friday for dia cheque presentation for insurance death benefits, dat some collect […]

todayMarch 27, 2026 10

National

Airport Police To Do Salutation For Fallen Heroes

By: Esther Ayoola Di Airport Police Command don arrange body to honor officers wey don kpai on duty for National Police Day 2026, dem title am, “Community Partnership: Building Trust.” Police tuk, tuk for Airport Command, Mohammed Adeola, ni post for X on Friday say di event go hellep public build trust. According to report, di celebration go start Monday, 30th March with cleaning exercise, continue with walkathon, public sensitization, […]

todayMarch 27, 2026 6

National

Turaki PDP Do Anoda Emergency Meeting For Abuja

Pipos Democratic Pati, under Tanimu Turaki National Working Committee and Adolphus Wabara board of trustees, don hold another emergency meeting for Bauchi govo lodge for Abuja. Turaki say, dem dey open to reconciliation and dat from all indication peace fit return to di parti. Meanwhile, Abdulrahman Mohamed-led caretaker committee wey Nyesom Wike back insist say dem sti wan hold planned national convention for 29 and 30 March. Say di mata […]

todayMarch 27, 2026 5

National

NURTW Beg Presido To Recognise Baruwa As Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Lawyer wey dey represent Comrade Ibikunle Baruwa, Tolu Babaleye, don call on Presido Bola Tinubu make im put bodi for di wahala wey dey shake National Union of Road Transport Workers, NURTW. Oga Laywer say gornment suppose recognise Baruwa as di real National President since courts don already rule in im favour. Babaleye yarn dis one for Abuja as e stand with Baruwa and im supporters. For […]

todayMarch 27, 2026 3

National

32 Governors, 8,450 Delegates Enter Abuja For APC Convention

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu say, im     go join im cabinet members, 32 state govos plus 8,453 delegates for Abuja today and tomorrow for di All Progressives Congress National Convention. Oga Minister of Information, Mohammed Idris, yarn for news tuk, tuk on Thursday. Idris say top party ogas and leaders from national, zonal, state and ward level go dey di convention as dem go elect new party leaders. […]

todayMarch 27, 2026 4

National

Former Senate Presido Saraki Insist Say PDP Sti Get Life

By: Esther Ayoola Former Senate Presido, Bukola Saraki, say like dis now, di Pipos Democratic Party (PDP) sti  dey pull crowd wetin nor good and dat di parti nor scata anything. E yarn dis one for TV sit down tuk, say di parti sti get beta grassroot connect. According to am, say na quarrel dey cause di wrong impression, as plenty Nigerians sti dey support di party.

todayMarch 27, 2026 5

National

ASUU Give FG 4 Days To Start Paying Dia Agreed New Salary

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don give Federal Gorment four days ultimatum to start to dey pay university lecturers with di new salary structure wey dem agree. ASUU Presido, Professor Christopher Piwuna, tuk dis one for one public lecture wey happen for Bauchi State. U sabi say Dem don agree on di new salary since December 2025, and e suppose start from January 2026. Piwuna […]

todayMarch 27, 2026 3

National

Vice Presido Explain How FG See Energy Security

Vice Presido Kashim Shettima don sti tuk say wi Federal Gorment nor go play wit energy security, because future of di country depend on am. Him yan dis one for di opening of Naija Electricity Liability Management Company (NELMCO) headquarters for Abuja. Shettima say, NELMCO na promise to handle every every as e take concern energy security. E press tuk, say dis administration sabi say energy security na di koko […]

todayMarch 27, 2026 3

National

Vice Presido Shettima promise To Protect Nigerians Right

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don go drop promise for international lawyers front, say Naija ready to protect human rights as e take dey inside constitution. Di Naija vice presido do dis one for Abuja on Thursday, when e dey open 2026 High-Level International Humanitarian Law Dialogue. Shettima say Naija ready every every, to collabo with other countries and follow International Humanitarian Law (IHL) for every conflict and […]

todayMarch 27, 2026 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app