Blog horizontal

Background

Lagos

Lagos APC Members Ready To Put Body For Tinubu and Hamzat

National Chairmo of APC, Prof. Nentawe Yilwatda, Lagos party Chairmo, Cornelius Ojelabi, and baba Govo, Babajide Sanwo-Olu don tell all Lagos APC members make dem deliver di state for Presido Bola Tinubu for 2027. Dem make dis strong call on Monday for Eko Hotel and Suites inside Lagos during one special one-day retreat for party leaders and senior members of de PBAT-KOH Campaign Council. Di party leaders drag di matter […]

todayOctober 20, 2026 9

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Former Member For Oshodi

Lagos State Taskforce don arrest one dismissed officer, Yahaya Salami, wey dem also dey call Adams, for impersonation and extortion around Oshodi Bus Stop. Dem catch Salami on Saturday after im try drag with Taskforce officers wey call am for questioning. Dis arrest dey come after one video go viral for social media showing how officers take forcibly hold di suspect down, which make people dey tok online. Inside statement […]

todayOctober 19, 2026 11 2

obodo oyinbo

America No Warn Us Before Russia Bomb Our Tins – Zelensky 

Presido Volodymyr Zelensky don tok say Ukraine allies no give dem any early warning before Russia launch ballistic missiles touch dem energy facilities for Kyiv region. Zelensky reveal say Russia fire 16 ballistic missiles and over 200 drones go different parts of di country overnight, which make loud explosions sound across di capital. Dis attack dey come just one week after Ukraine tok say US no give dem heads-up for […]

todayOctober 19, 2026 9

Sports

Rangers International Report Algerian Fans To CAF

Nigerian football club, Rangers International, don submit petition to CAF over how Algerian fans destroy properties for MKO Abiola Sports Arena inside Abeokuta. Dis wahala happen after Rangers beat di Algerian team 2-0 for the first leg of dem CAF Champions League qualifier on Sunday. Rangers tok say over 400 fans force dem way inside without paying gate fee, break stadium gate and seats, and even attack dem own assistant […]

todayOctober 19, 2026 9

OBODO NAIJA

Breaking: Former Delta Govo Emmanuel Uduaghan Kpeme for Age 71

Former  Govo of Delta State, Dr. Emmanuel Uduaghan, don kpeme for age 71 after small sickness. Im family naim konfamate dis news inside one statement signed by Toju Andre Uduaghan on Monday. Di family describe im passing as big blow and loss to Delta State and di whole Nigeria. Late Dr. Uduaghan, dem born on October 22, 1954, serve as govo of Delta State from 2007 to 2015.

todayOctober 19, 2026 10

Sports

Mourinho Fire 19-Year-Old Diomande To Score Goal 

Real Madrid choacielala, di special one, José Mourinho, like dis don dey ginger  19-year-old Ivory Coast boy, Yan Diomande, say make hin sharp up with hin goal scoring to bench brazil super star Vini Junior. Dis one na after dem knack Sevilla 4-1  on Sunday. Romano report say Mourinho give press tok, say, in like di boy progress o, but di boy sti get fear in front of goal and […]

todayOctober 19, 2026 10

obodo oyinbo

Heavy Crucifix Pull Off Wall, Kpai Catholic Priest

Wonders dem say e nor get end, na so Catholic priest, Father Patricio Sánchez Molinari, take kpeme for Ecuador, nor be small village pipo doings, say one heavy wooden cross  fall untop am as hin  dey celebrate Mass for Our Lady of Perpetual Help Church for Guayaquil, Ecuador. Dis sad incident hapun on Saturday during one service signature, and di whole thing show live as e dey hapun on top […]

todayOctober 19, 2026 12

OBODO NAIJA

World Bank Share Fake Report Giv FG – Minister Tok

Wi  Federal Gornment look world bank eye ball to eye ball, say na nonsense dem dey do for di world bank, say which one be say Nigeria go pay 7.7 trillion naira just to pay interest for di money wey be say dem dey owe. World Bank bin share recent report say Nigeria don spend about 124 percent of gornment money untop servicing gbese. However, Finance Minister, Taiwo Oyedele, quickly […]

todayOctober 19, 2026 8

Lagos

Lagos Gornment Ready To Use Money Take Slap Developers Face

Lagos State Gornment don give serious warning to developers and construction workers make dem stop to dey dump building materials on top roads and inside gutter, or dem go seal dia site and slap dem with heavy fine. Senior man, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, fire dis mata one on Sunday as e dey do inspection work around Lagos Island area. Senior man see things upon things, […]

todayOctober 19, 2026 11

obodo oyinbo

Ukraine Russia War No Concern Zelensky – Trump Tok

US Secretary of State, Marco Rubio, on Monday deny say America don suspend intelligence sharing with Ukraine, as e tell Presido Volodymyr Zelensky say make e focus on how to end di war with Russia. Rubio tell tori pipu say no pause dey at all, and when dem ask am about Ukraine, he claim say America stop to dey send intelligence wey go hellep dem fight against Russia missile attacks. […]

todayOctober 19, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds