Blog horizontal

Background

Sports

Osimhen Burst Turkish Champs Waka, Carry Dem Go Back-To-Back UCL Win

Victor Osimhen brace help Galatasaray carry 3-1 win comot Bodø/Glimt for UEFA Champions League on Wednesday, as Turkish champions record back-to-back European win after dem no fit win before for 18 main-draw matches. RamsPark stadium crowd burst gidigba when Mario Lemina slide ball give Osimhen, wey sharply finish beat goalkeeper Nikita Haikin just 3 minutes after game start. Osimhen pressure continue as e head two crosses from Leroy Sané, but […]

todayOctober 23, 2025 7

Lagos

LASTMA Hail Officer Wey Reject N20,000 Gift From Motorist

Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) don praise one of dia officer, Muibi Ademola (Bravo 27), wey reject ₦20,000 wey one motorist try give am for Ago–Ibiwoye area for Okota, Lagos. According to statement wey Director of Public Affairs, Adebayo Taofiq, release on Wednesday, dem talk say Ademola action na rare show of integrity, discipline, and professionalism. Di motorist call Ademola to report traffic jam for di area, and di […]

todayOctober 23, 2025 7

Lagos

Lagos Don Ready To Shut Down Old Dumpsite

Lagos State Government don announce say dem go decommission major landfill dem wey don old for use, as part of plan to improve waste management and protect environment for di state. Tokunbo Wahab, di Commissioner for Environment and Water Resources, talk dis one for X (formerly Twitter) after meeting with all 57 Local Government and Local Council Development Area chairmen. Wahab yarn say dem go shut down landfills like Olusosun […]

todayOctober 23, 2025 8

National

NDLEA Don Launch Online Portal to Run Drug Test & Visa Clearance Sharp-Sharp

National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don drop new digital platform wey go make drug integrity test and visa clearance waka easy, sharp and without stress. Dem unveil di portal for Abuja on Tuesday as part of di new system wey dem call Drug Integrity Test and Visa E-Administration System (DITViCAS). NDLEA Oga, Gen. Buba Marwa (wey dem represent by Secretary Shadrach Haruna), talk say dis move na big shift […]

todayOctober 22, 2025 11

National

Senate Don Begin Move To Increase Salary For Soldiers And Security People

Di Nigerian Senate go debate one motion on Wednesday, October 22, wey wan push for better salary and working condition for Armed Forces and other security agencies. Di motion wey Senator Ali Ndume from Borno South carry come Senate floor talk say soldiers and security people dey suffer under “grossly inadequate” pay despite risking dia lives every day for Nigeria. He yarn say junior officers dey collect just ₦50,000 to […]

todayOctober 22, 2025 23

International

Algeria Oppos Leader Ghares Don Jam Jail For Yabbing President Tebboune

Algerian court don sentence opposition polititian Fethi Ghares to two years jail for Facebook post wey dem talk say insult President Abdelmadjid Tebboune, lawyer talk dis one on Tuesday, October 21. Ghares na well-known secular leftist wey dey criticize government, im lawyer Abdelghani Badi talk say Ghares guilty for “talk wey concern president.” Ghares no dey court when dem give verdict, and defence team dey plan to appeal. Another lawyer […]

todayOctober 22, 2025 9

Sports

Bayern Munich Extend Vincent Kompany Contract Till 2029

Vincent Kompany don sign new contract wey go keep am as head coach for Bayern Munich till summer 2029, extend im original deal wey suppose end for 2027. Di Belgian coach take over Bayern for summer 2024 and quickly lead dem win Bundesliga title, snatch am back from Bayer Leverkusen. For August, Kompany still add Franz Beckenbauer Supercup to dia trophy cabinet. Kompany yan say e feel like say e […]

todayOctober 22, 2025 10

National

ISWAP Dey Plan Fresh Attack for Ondo, Kogi — DSS

Di Department of State Services (DSS) don raise alarm say Islamic State of West Africa Province (ISWAP) dey plan fresh coordinated attack for some communities for Ondo and Kogi states. Confidential memo wey DSS Ondo State Command sign, dated October 20, 2025, warn Brigade Commander for 32 Artillery Brigade, Nigerian Army, say credible intelligence confirm say ISWAP insurgents dey ready to attack places like Eriti Akoko and Oyin Akoko for […]

todayOctober 22, 2025 6

National

130 Million Nigerians No Get Mobile Internet Access

Sub-Saharan Africa (SSA) remain di region wey get di lowest mobile Internet usage, with only 25% of di people dey use am and di biggest coverage gap at 10%. For other regions like North America, Europe and Central Asia, plus East Asia and Pacific, over three-quarter of di people dey access mobile Internet on top dia own devices. GSMA report for The-State-of-Mobile-Internet-Connectivity-2025 talk say mobile Internet adoption no too change […]

todayOctober 22, 2025 4

Lagos

Army Deny Ojo Cantonment Shooting, Blame Cult Wahala

Nigerian Army don clear air say no be dem shoot person for inside Ojo Military Cantonment for Lagos as people dey talk for social media. Army talk say di shooting happen outside di barracks near Mammy Market abattoir gate on October 18, 2025, and e relate to cult wahala, no be soldiers fault. Troops of 81 Division rush go di scene after dem hear shooting, dem find one man, Rilwan […]

todayOctober 22, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app