By: Esther Ayoola
Lagos State Gornment don alert residents and motorists on Wednesday, say some fraudsters dey pose as parking operators for Computer Village, Ikeja to collect money from drivers.
LASPA General Manager, Adebisi Adelabu, tell newsmen dat dem don uncover how di fraudsters dey work with touts to illegally charge of N1,000 for parking.
She also explain say some illegal operators dey arrest cars without gorment permision, make owners pay big money to get dia vehicles and licence papers back.
Adelabu warn say management and regulation of parking within Ikeja and across Lagos State na only LASPA responsibility, and anyone wey dey do illegal parking dey risk arrest and prosecution.