Blog horizontal

Background

National

Jaguda Boys Enter Church With Bad Character Kill Priest Wife For Anambra

By: Esther Ayoola Some armed Jaguda boys, based on rugged movement, don carry their bad character enter St. Andrews Anglican Church for Isiokwe, Lilu, Ihiala, Anambra State early Sunday, burn priest house and  kill two people. According to Eye wey see,   one of di persons wey kpai, na di wife of di priest, as them scatter  vehicles and properties scatter for the church compound. Di whole wahala happen early Sunday,  […]

todayDecember 8, 2025 14

National

Oga Presido Tinubu, Macron Align Marras On Naija Security

By: Rilwan Agbomeji Presido Tinubu and France oga patapata, Emmanuel Macron don reason for phone on Sunday on top di security gbege wey dey shake Naija. Di phone call happen for di same time when one US delegation and dia big big officials land Abuja go meet Nuhu Ribadu to reason di tori on top Christian persecution and killings.  Macron later yarn for X say France ready to stand gidigba […]

todayDecember 8, 2025 24

National

President Tinubu Salute Naija Army For Protecting Democracy

By: Alice Iduh Wi Oga Presido Bola Tinubu,  based on doings don cut cap  for  Nigeria armed forces for di way dem rush  help Republic of Benin stop coup wey scarra the country Sunday. According to di President, wey him talk through him Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, di military restore democracy after di coup plotters capture National TV and one military camp. Tinubu yan say di forces […]

todayDecember 8, 2025 13

Sports

Neymar Lead Santos To Big 3–0 Win As Dem Escape Relegation.

By: Alice Iduh Santos don pull off one big miracle escape, as dem beat third-place Cruzeiro 3–0 for the last match to hold their spot for Serie A. Neymar, wey dey emotional and still dey feel pain, still show up when e matter pass. Di 33-year-old wey just come back from long knee injury na him lead di team comeback for di end of di season.

todayDecember 8, 2025 16

Sports

Liverpool Table Salah Marra Ahead Of Chapion’s Leaque

By: Alice Iduh Liverpool star mohamed salah fit miss team waka to italy for champions league match against inter on tuesday. According to reports, di club dey hold internal talk after salah yarn some strong words earlier dis week, Transfer expert, fabrizio romano post for x, coach arne slot go talk to press later today to explain wetin dey happen and go reach decision today.

todayDecember 8, 2025 36

Lagos

Two Pipo Die, Two Injured For Early-Morning Accidents Across Lagos

By: Esther Ayoola Nor be small tin oh,  Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) again don sama warning give  motorists  say make dem drive carefully after  Two separate accidents for Lagos early mor mor on monday claim two lives and leave two others badly wunjured. Na for inside  statement wey  agency  release give tori pipo, them give report that, The first crash happen around 2:30 a.m. for Otedola Bridge when […]

todayDecember 8, 2025 24

obodo oyinbo

Benin: 14 Pipo Land Jail After Soldiers Try Overthrow Talon

By: Esther Ayoola Unto updates, say na About 14 pipo don land for jail after dem try run coup on Sunday to comot benin Republic Presido President Patrice Talon According government tuk tuk persin, Wilfried Leandre, Di attempted coup burst December 7, when some soldiers talk say dem don overthrow President Patrice Talon, even carry control of government and state TV small time, hwoever, say dem don arrest 14 pipo […]

todayDecember 8, 2025 17

Lagos

Lagos Security Trust Fund Begin Waka Improve Security

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don come again with another plan say dem want  make people dey involved, accountable, and join hand with others to improve security for Lagos. According, the new CEO of the trust fund,  Ayodele Ogundan to aThe Fund go soon form, monitoring team, to dey oversee things. Ogundan talk say dem wan make sure say every contribution dey make difference for street and […]

todayDecember 8, 2025 20

Entertainment

Yvonne Jegede Explain How She Land 2baba ‘African Queen’ Video

By: Esther Ayoola Nollywood actress Yvonne Jegede  don clear clear marras for ground on  how she land role for 2Baba classic hit, African Queen, and the story full with wahala and surprise. The movie star explain oh, that she bin  dey shoot movie, Missing Angel, when her phone ring, and that call  actually change her life as she nor take expect. Chairmo  Charles Nova self bin dey near her, when […]

todayDecember 8, 2025 42

International

Benin Coup Fail As Loyalist Troops Hold Ground

By: Alice Iduh Benin republic presido, Patrice Talon, don show for TV clear  citizens, say di coup mata  wey soldiers try run, shake everywhere for the kontri,  don dey under control.   E hail di army and dia oga-dem wey hold loyal ground, no shakement at all.   The government talk say dem don succeed scarra  mutiny hours after a group of soldiers bin declare for  national tv dat dem […]

todayDecember 8, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds