Blog horizontal

Background

National

Kwankwaso: I Go Only Join Party If Dem Give Me Top Slot

By: Esther Ayoola National leader of di New Nigeria Peoples’ Party (NNPP), Senator Rabiu Musa Kwankwaso, don say e go only join any political party for 2027 election if dem offer am presidential or vice-presidential ticket. Kwankwaso tuk dis one on Thursday during one Kwankwasiyya gathering wey hold for im residence for Miller Road, Kano, while e dey address ongoing political realignments ahead of di next general elections. E explain […]

todayJanuary 9, 2026 11

Lagos

I No Get Rift With Abiodun – Govo Sanwo Olu

By: Esther Ayoola Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu, don come out clear tuk wey no true on top beef marras between am and Ogun State govrnor, Prince Dapo Abiodun. Na lie lie tuk, according to am. Di Govo yarn di tori straight for statement wey im media oga, Gboyega Akosile, drop yesterday. Sanwo-Olu con yarn say, make people calm down because nothing like dat dey happen at all, say both […]

todayJanuary 9, 2026 9

obodo oyinbo

Turkish Airlines No Dey Fly Tehran Again As Iran Protest Dey Hot

By: Esther Ayoola Turkish Airlines don cancel five Friday flights wey suppose go Tehran, Iran, afta di city don dey rocked by protests over rising living cost, di Istanbul Airport app report on Thursday. Di airport app also show say five oda  flights wey Iranian airlines dey operate don cancel, while seven others still dey go ahead as scheduled. Turkish authorities never comment on di situation yet, wey dey happen […]

todayJanuary 9, 2026 6

National

Ogun Teen Drown Die for Swimming

By: Esther Ayoola Ogun State Police don call for better safety for all recreational centres and swimming pools across di state after 17-year-old boy drown die. Police Public Relations Officer, Babseyi Oluseyi, tuk dis one on im X page on Wednesday, say di warning dey follow recurring drowning incidents for Ogun. Di police spokesman explain say di teenager lose im life during one recent swimming-related accident, wey happen inside di […]

todayJanuary 9, 2026 9

Sports

New Chelsea Boss Rosenior Face FA Cup Test

By: Esther Ayoola Liam Rosenior go start im first match as Chelsea manager dis weekend when e carry di Blues go face second-tier Charlton for FA Cup third round. Di FA Cup match dey tagged risky, as football pundits warn say small clubs fit shock big teams anytime. Tottenham manager Thomas Frank dey London dey fight to save im job, afta di team show poor form for Premier League. Meanwhile, […]

todayJanuary 9, 2026 7 1

National

I No Declare Presidential Race – Datti Baba-Ahmed

By: Esther Ayoola Former vice-presidential candidate of Labour Party,  Datti Baba-Ahmed,  don clear air say e never declare interest to contest presidency. E tuk dis one on Friday during one media sitdon tuk tuk, say some people twist wetin e tuk. According to am, e no make any announcement at all; e just tuk say e still dey inside Labour Party. E explain say di clarification come because political speculation […]

todayJanuary 9, 2026 12

Sports

I Go Pay Super Eagles Bonus If FG Fumble – Ndidi

By: Esther Ayoola Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, don yarn say if FG no pay team dia 2025 AFCON bonuses before Saturday, e go pay dem by imsef. FG, through Minister Doris Uzoka-Anite, don promise say dem go fast-track payment Thursday–Friday. Ndidi tuk say e dey push team to train well since second game, and e don promise players and staff say e go cover di bonuses if government fail.

todayJanuary 9, 2026 10

Sports

Anthony Joshua Pay Tribute Giv Im Padi Dem Wey Kpai For Motor Crash

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don pay heartfelt tribute to im two padi, Latif Ayodele and Sina Ghami, wey kpai for car crash on December 29 for Naija. AJ get small wunjury inside di accident, hospital discharge am, return back England, then later come back attend dia burial for last Sunday. E call dem “brothers” and “great men”, tuk say na only afta di crash,  e sabi how special dem […]

todayJanuary 9, 2026 7

obodo oyinbo

No Send Soldiers Go Ukraine, War Fit Sup – Russia Warn US, Europe

By: Esther Ayoola Russia don drop hard warning give US and Europe say make dem no try send soldiers go Ukraine, say if dat one happen, na bigger war go burst, as di fight don already drag near four years. Russia say foreign troops no go calm anything, e go only scatter di marras and cause face-to-face wahala. But US and European leaders still dey yarn about security cover for […]

todayJanuary 9, 2026 8

Entertainment

Ned Nwoko Yarn Say Regina Daniels Negative Drug Test No Mean Anything

By: Esther Ayoola Senator Ned Nwoko on Thursday, yarn say Regina Daniels negative drug test no mean anything, say na temporary abstinence. E post for im X page say recovery no be social media show, and no fit come from just one test result. According to am, short break no solve di real gbege as recovery need time, honesty and professional support. Di statement come from im media team, and […]

todayJanuary 9, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app