Blog horizontal

Background

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 15

OBODO NAIJA

Federal Gornment explain how dem wan use ₦30 Trillion Boost Naija Economy

By Oluwatosin Ibrahim Wi Federal Gornment dey rake oh say dem don put beta doings in place to package naija mining sector, grow am reach ₦30 trillion before year 2030. Senior woman Seco of the Solid Minerals Development Fund (SMDF), Fatima Shinkafi, na yarn dis one during one lecture wey hapun for University of Lagos. Gornment say the reforms wey dem dey do for the sector don already dey bring […]

todayJuly 9, 2026 13

Sports

Adeyemi pick Barca, tell Dortmund say im wan comot  

By Oluwatosin Ibrahim Barcelona don submit official bid to Borussia Dortmund for winger Karim Adeyemi. According to transfer news tatafos,  Fabrizio Romano and Gerard Romero for  X (twitter) on Thursday say tuks between both clubs still dey go on but  Adeyemi don already show interest to join Barça.   According to am, Karim Adeyemi don agree personal terms with Barcelona and he don tell Dortmund say na only Barça e […]

todayJuly 9, 2026 19 6

obodo oyinbo

US And Iran Exchange Bomb scarra strait of Hormuz

By Oluwatosin Ibrahim America and Iran don share some goodies, bomb  diaself for di second day straight on Thursday scarra  di Strait of Hormuz. U sabi say, US Presido, Donald Trump, bin complain on Wednesday, say Iran nor dey hear English, dat when dem ready tuk peace, dem go calm down. According to di US military, dem hit about 90 military targets, including di store wey Iran dey keep dia […]

todayJuly 9, 2026 13

OBODO NAIJA

APC answer Peter Obi Alarm, say no level for di 2027 election

By Oluwatosin Ibrahim Nor be small tin for naija politics, as APC and opposition parties dey get am  hot, hot say, di 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, raise alarm, say im life fit dey danger.   Di All Progressives Congress through dia  National Seco, Senator Ajibola Basiru sharpaly dismiss di claim,say,  no level, and dat na fear dey do di NDC, and Obidient Movement […]

todayJuly 9, 2026 12

south west

Oyo State Govo Makinde Promise Justice After Ojoo Violence Kpai Two

By Oluwatosin Ibrahim Oyo State Gornment don  fry mouth beg residents say make dem maintain di clams  after  some anyhow doing  for Ojoo area of Ibadan kpai two people,. Nor be small gbege after unknown jaguda boys go kpai  one maruwa driber, na so area take scarra. Deputy Govo, Bayo Lawal, naim konfamate dis mata wia im go visit the area on behalf of Governor Seyi Makinde, beg especially di […]

todayJuly 9, 2026 16

Lagos

Agboyi Ketu LCDA to fine Pipo wey dey throway dirty yanagayanag for backyard

By Oluwatosin Ibrahim Residents for Agboyi-Ketu LCDA inside Lagos  dey squeeze face oh say of say council don declare  ₦50,000 fine or  six months for jail, if dem gbab abybody wey nor get  waste bin or drum for front of dia house, con dye dirty di environment. Di new rule dey inside one amendment bill wey di Sixth Assembly of di council present during di second day of Agboyi-Ketu LCDA […]

todayJuly 9, 2026 8

Sports

Saudi Powerbroker Dey Push For Mid-Night Fury vs Joshua Clash For Wembley

By Oluwatosin Ibrahim Saudi boxing powerbroker Turki Alalshikh don konfam say the heavy boxing match between Tyson Fury and Anthony Joshua fit still happen for Wembley Stadium. But he check say, this one go only happen if British authorities gree make the fight start very late for night so that pipo for America and across the world fit watch am for their prime time. Because of this one, Alalshikh dey […]

todayJuly 9, 2026 19

obodo oyinbo

UN Beg World Pipo to Bring $296m To Help Venezuela Earthquake victims

By Oluwatosin Ibrahim Di United Nations like dis now don dey beg for 296 million dollars to support Venezuela based on di  deadly earthquake  wey go kpai l more than 3,600 people and leave thousands homeless and missing. UN humanitarian chief, Tom Fletcher, say although donors don already contribute about 300 million dollars, dem still need more  attention to help 1.3 million people within di next six months. Venezuela Foreign […]

todayJuly 9, 2026 14

Lagos

Lagos Lawmakers back state police creation law

By Oluwatosin Ibrahim Lagos State House of Assembly don throway dia full support behind plan to create state police. Speaker Mudashiru Obasa porporly dis mata on Wednesday for plenary, say di  move smart move against  kidnappers, terrorism, banditry and other security wahala for Nigeria. Di senior man speaker con sti  insist say state gornments suppose get full control over how dem go recruit officers, appoint Commissioners of Police and run […]

todayJuly 9, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds