Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

China Residents Begin Cleanup After Deadly Flood

By: Yusuf Abuh At least 39 people naim don die while nine others still dey miss after one serious flood hit Guangxi region for southern China, as rescue and cleanup work still dey go on like dis. Authorities tok say 26 of di deaths hapun after Liulan Reservoir break, while seven people still dey missing for dat area. According to reportĀ  plenty rescue vehicles and security personnel enter Liulan village […]

todayJuly 10, 2026 14 1

OBODO NAIJA

Tinubu Meet Security Senior Mehn For Aso Rock

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido, Bola Tinubu dey complain oh, in fact im do closed-door meeting with top security chiefs for Aso Rock Villa, Abuja, to check how security mata be for di country. According to report Di meeting focus on fight against terrorism, banditry, kidnapping and oda security wahala wey still dey worry Nigerians. National Security Adviser Nuhu Ribadu, Defence Minister Mohammed Badaru, top military commanders, DSS, NIA […]

todayJuly 10, 2026 13

south west

Ogun Police Rescue Abducted Prince, Kill Two Kidnappers

By: Yusuf Abuh Ogun State Police Command don rescue Prince Idris, one prince from Okun Owa for Odogbolu Local Government, after kidnappers jaguda go carry am comot from im house on June 30. According to police tuk, tuk person, DSP Oluseyi Babaseyi,Ā  wey konfam dis mata, dem put serious pressure on di kidnapping gang before intelligence operation lead to di killing of two kidnappers. During di operation, police recover one […]

todayJuly 10, 2026 11

OBODO NAIJA

Fifth Batch Of Nigerians Return From South Africa

By: Yusuf Abuh Federal Government don bring back another batch of Nigerians from South Africa as fifth evacuation flight land for Lagos on Thursday evening. Air Peace carry more dan 180 Nigerians come back after one technical problem stop di plane from flying as earlier planned. Di latest returnees, mean say about 1,000 Nigerians don now return home since di xenophobic attacks start for South Africa. Government say evacuation exercise […]

todayJuly 10, 2026 15

OBODO NAIJA

Three Kpai as Heavy Windstorm Scatter Houses for Yobe

One strong windstorm wey blow for Wednesday evening don kpai three pipo and wunjure several others for Gashua, headquarters of Bade Local Government Area for Yobe State. Di Chairman of di LGA, Ibrahim Babagana, tell media tuktuk pipo say di windstorm last for just 30 minutes and e fit confirm say three pipo don kpai. E describe di incident as one of di worst windstorms wey e don ever see, […]

todayJuly 9, 2026 14

OBODO NAIJA

France Go Face Morocco as World Cup Quarter-Final Wahala Begin

France go face Morocco on Thursday for one heavyweight World Cup quarter-final clash as di tournament don enter di business end. After one month of action wey produce 280 goals in 96 matches, only eight teams remain, all chasing di World Cup trophy wey go be decided on July 19 for East Rutherford. France, wey many people see as one of di strongest teams for di tournament, go meet Morocco […]

todayJuly 9, 2026 17 7

OBODO NAIJA

Senate Release Billions to Boost Police Work Across Nigeria

By Oluwatosin Ibrahim Wi Nigeria Senate don approve total of ₦403.1 billion for Nigeria Police Trust Fund, with ₦170.1 billion for 2025 budget and ₦233 billion for 2026 budget say make wi niaja police take do beta ordechi work for across di country. According to report, dis money go cover workers salary, capital projects and running cost to improve di operational capacity of di Nigeria Police Force. Lawmakers tok say […]

todayJuly 9, 2026 16 4

OBODO NAIJA

Senator Oshiomhole porporlly matas say State Police na di way to go for Nigeria

By Oluwatosin Ibrahim Former Edo State Govo and Senator, Adams Oshiomhole, don scata table oh, say bad belle pipo wey dey fight against state police dem nor wise and dat state police na di way to go for Nigeria. Im yarn dis one on Thursday, for one TV town Hall meeting, wia im tuk im mind dat, normally dat Nigerians suppose to dey celebrate Wi oga Presido for creating state […]

todayJuly 9, 2026 20 2

OBODO NAIJA

Mulade Call for Envirnomental Emergency as Oil Spill Dey Affect Delta Communities

Chief (Comrade) Mulade Sheriff, one environmental rights and peace advocate from Delta State, don urge di Federal Government, Delta State Government and all relevant regulatory agencies to sharpaly declare environmental emergency over one major oil spill wey allegedly don affect many host communities for Warri South-West and Burutu Local Government Areas of Delta State. For one statement wey e release on Wednesday, Mulade describe di incident as serious environmental disaster […]

todayJuly 9, 2026 24 4

OBODO NAIJA

AIG Beg Youths to joinbodi with Police to ensure Peaceful 2027 Election

By Oluwatosin Ibrahim Assistant Inspector-General of Police for Zone 2 Command, Olohundare Jimoh, don ginger area boys say make dem join force with police and other security agencies to fight election badness. According to am, as 2027 general election dey come, young people get big role to play by promoting peace, avoiding fake news and taking part in di election without violence. Jimoh say good policing no fit work without […]

todayJuly 9, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds