Blog horizontal

Background

Lagos

Lagos Seal Plenty Illegal Reclamation Work For Ikota River Wey Dey Off Orchid Road

Lagos State Government don seal plenty illegal reclamation work and issue stop-work order for Ikota River wey dey near Partibons Homes Estate and Bee-Forth Estate Phase II off Orchid Road, Lekki. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, wey lead di enforcement team talk say some people dey reclaim river parts and dey build illegal structures to sell to people wey no know. Wahab yan say dis kind action […]

todayOctober 13, 2025 5

Lagos

LASG Don Promise Say Dem Go Dey Pay Pension Sharp Sharp

Lagos State Government don assure public servants wey dey near retirement say dem go collect dia pension money sharp sharp once all dia documents complete. Dem talk dis one during di 29th Retirement Benefit Documentation Seminar wey happen on Friday for Adeyemi Bero Auditorium, Alausa, Ikeja. Head of Service, Bode Agoro, hail Lagos State Pension Commission (LASPEC) for di way dem dey make retirement process smooth for workers wey dey […]

todayOctober 13, 2025 6

Lagos

Sanwo-Olu Wife Dey Champion Mental Health Awareness

Wife of Lagos State Governor, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, don beg people make dem show love and empathy to those wey dey face mental health wahala instead of to dey stigmatise dem. For statement wey come out from her office on Saturday, Ibijoke talk say mental illness don turn big concern across all di local government areas for Lagos. She follow Orunsii WellCare Foundation waka go Ikorodu to mark World Mental […]

todayOctober 13, 2025 6

Lagos

Lagos Don Confirm Say Dem Still Stand Gidigba For Girl-Child Empowerment

Lagos State Government don confirm say dem still dey solidly behind girl-child matter, as dem pledge to continue support programmes wey go help girls dream, lead and succeed. Special Adviser to di Governor on Health, Dr. Kemi Ogunyemi, yarn dis one on Saturday for event wey dem do to mark di 2025 International Day of di Girl Child for Dansol High School, Agidingbi, Ikeja. She no show for di event […]

todayOctober 13, 2025 9

National

Two Sisters Fight As One Missed Her Flight Because Of Late Coming

Serious gbege break out between two adult sisters for Nnamdi Azikiwe International Airport, Abuja, on Sunday after dem miss dia United Airlines flight because dem reach di terminal late. Eye-witnesses talk say dem book same flight but by di time dem show, boarding gate don close. As per Nigeria Civil Aviation Authority Act Part 19, passengers suppose land airport at least two hours before boarding time, but these two no […]

todayOctober 13, 2025 8

National

“I Dey Go Blind, Native Doctor Dey Cry From Cell o”

One close padi of di native doctor wey dem detain for Anambra, Chidozie Nwangwu, wey people sabi as Akwa Okuko Tiwa Aki, don raise alarm say di spiritualist dey go blind for detention. Di associate, wey no gree make dem call her name, talk say she recently yarn with Akwa Okuko from one secret detention centre and di man cry give am say im eye don dey fail and e […]

todayOctober 13, 2025 7

International

China Man For Die, But Pig Liver Save Am For 170 Days

Doctors for China don score big win for science as dem report say one 71-year-old man live 171 days after dem transplant gene-edited pig liver give am. Di pig liver stay for him body for 38 days, dey work well as support system, na di first time wey pig-to-human liver transplant go enter peer-reviewed journal. Dem do di surgery for May 2024 for First Affiliated Hospital of Anhui Medical University, […]

todayOctober 10, 2025 21

Sports

Mahrez Lead Di Charge As Algeria Dust Somalia 3-0

Ex-Manchester City and Leicester winger, Riyad Mahrez, show say e still dey fire as e provide cross wey Mohamed Amoura volley enter early, then bang him own rising half-volley for 19th minute. Mahrez wey captain di team play mind game with him marker before e create di third goal for Amoura 12 minutes into second half, after which dem both comot. Algeria almost add another goal from Youcef Belaili, but […]

todayOctober 10, 2025 8

Entertainment

“I Fit Fail As Musician, But Not As Papa” – Adekunle Gold

Nigerian singer, Adekunle Gold, don pour him heart out as he reveal say na him wife, Simi, and dia daughter, Adejare, dey run things for him life now. Di music star yarn dis one for NotJustOk podcast, where he talk say him number one mission na to give Adejare soft life wey go beta pass wetin him hustle through as pikin. According to am, he no dey ever reason make […]

todayOctober 10, 2025 18

Sports

Mbappé: Madrid Don Reset My Brain, Leg Don Balance

Kylian Mbappé don talk say him move go Real Madrid help am “put head and leg back for ground” and him sharp start to di season show am well. Di France striker don score 16 goals for 14 games for club and country, and e only fail to score for one match since e start him second season for Spain. Even though e take reach January to get same number […]

todayOctober 10, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app