Blog horizontal

Background

Local

ADC Disown Obi Say Im Registration No Follow

By Ebi Oboko One faction of the African Democratic Congress (ADC), wey Nafiu Gombe dey lead, don reject Peter Obi. Ontop yrnings with tori pipo,  the ADC faction talk say Obi no follow correct procedure when e register for the party for Enugu. Di faction call demself di real leaders of ADC. U sabi say   Obi announce dat,  im ma don join ADC for event wey hold for Nike Lake […]

todayJanuary 1, 2026 5

National

Senate Presido, Akpabio Repent Sake Of New Year Mass Message Wey Touch Im Heart

By Ebi Oboko Wi oga Senate Presido, Senator Godswill Akpabio, in the spirit of the new year don tell him lawyers make dem withdraw all di defamation cases wey e get against some people for inside the obodo naija. Akpabio speak on Thursday for Sacred Heart Parish, Uyo, say e get almost nine cases for court against people wey e accuse of defaming am. E explain say e hear di […]

todayJanuary 1, 2026 6

Lagos

Lagos APC Yansay Dia Full Support For Tinubu New Year Reforms

By Ebi Oboko Lagos State All Progressives Congress, APC,  tuk tuk, Hon. Seye Oladejo, don tuk again oh, say the party dey fully support oga  Presido, Bola Tinubu New Year message and reforms. According to Oladejo, through one official statement, say because dem believe say Tinubu dey take hard but necessary decisions to fix Nigeria, dem go support am beta style. Oladejo say for Lagos, APC see signs dat economy […]

todayJanuary 1, 2026 11 1

obodo oyinbo

Russia Accuse Kyiv Say Dem Do New Year Drone Attack For Moscow

By Ebi Oboko Russia don go put  accuse for  Kyiv head say dem  jet li drone attack wey kill at least 20 people for hotel for Moscow-controlled part of Kherson, Ukraine, for new year day. Vladimir Saldo, wey be Russia-appointed governor for Kherson, talk say three drones hit cafe and hotel wey people dey celebrate New Year. Russia Investigative Committee don open probe into di attack, wey still wunjor plenty […]

todayJanuary 1, 2026 8

Sports

Chelsea Fc sharpaly turn Maresca to EX

By Ebi Oboko Chelsea Football Club don announce say dem and dia  head coach Enzo Maresca don agree to part ways on Thursday. During him time, Maresca lead Chelsea win UEFA Conference League and FIFA Club World Cup. Club tuk say di decision follow dia ongoing plans and ambitions for the team. Chelsea thank Maresca for im contribution and say im achievements go remain important part of the club history.

todayJanuary 1, 2026 10 4

Lagos

First Lady Oluremi drop lines Say Naija Economy Face Show

By Ebi Oboko First Lady, Senator Oluremi Tinubu, don talk say 2026 come with fresh hope and assurance of God blessings for Nigeria. She talk this one for her New Year message wey she post for her official X handle on Thursday. Senator Oluremi say she full with gratitude to God as Nigerians enter di New Year with joy and big expectation for better future. Mama Tinubu greet Nigerians for […]

todayJanuary 1, 2026 11 6

Lagos

Speaker Obasa to Lagosians Say Beta Governance Dey Come For 2026

By Ebi Oboko Speaker of Lagos State House of Assembly, Mudashiru Obasa, don troway beta salutation  Lagosians  for dia courage and support throughout 2025. Obasa tuk this one for him New Year message wey he release for Lagos on Thursday. He say even with all di economic wahala for di country, Lagos people still stand gidigba and support government. Di Speaker assure say 2026 go bring beta governance, more achievements, […]

todayJanuary 1, 2026 10

obodo oyinbo

Gaza Enter 2026 With Wahala Say Isreal Block Dia Helpers

By Ebi Oboko Israel don start bad character wey dem learn yesterday block 37 international aid groups, including Doctors Without Borders, wey dey help people for Gaza. Di government revoke their licences and accuse dem of wahala wey dem never prove. People for Gaza enter 2026 with worry and despair as humanitarian situation continue to dey worwor.

todayJanuary 1, 2026 11 6

Obodo Niger

DHQ Confamate say Damage Check Sti Dey on For Di US–Nigeria Air Strikes Site

By Ebi Oboko Defence Headquarters don talk say dem still dey do full check to know the level of damage from the recent air strikes wey US forces and Nigerian military do together. US President Donald Trump announce the strikes for Christmas Day, say dem target Islamic State camps for northwest Nigeria. On Wednesday, Major General Michael Onoja tuk say assessment still dey go on as people sti dey ask […]

todayJanuary 1, 2026 7

National

President Tinubu Drop New Year Message

By Ebi Oboko Wi Oga Presido, Bola Tinubu don give new year message, say 2026 go mark di start of stronger economic growth for Nigeria, as him promise to reduce inflation, boost foreign reserves, and maintain GDP growth. Tinubu yarn this one for him New Year message to Nigerians on Thursday. Oga Presido,   say Nigerians get strong collective spirit and believe say 2026 go better for di country and everybody […]

todayJanuary 1, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app