Blog horizontal

Background

National

Atiku Drag Tinubu Gorment Say Dia Response To South Africa Xenophobia To Slow

By: Esther Ayoola Former Vice presido, Atiku Abubakar don drag wi oga presido Bola Tinubu, once again, say im nor dey try at all, di way im take respond to di news of xenophobic tension for South Africa. According to Statement from Atiku, Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, baba Seyi and im response team too slow, telling, say make dem go learn from Ghana E tuk say, […]

todayMay 18, 2026 8

south west

IGP Order Heavy Security For Oyo Forest Afta Deadly Attack

By: Esther Ayoola Senior man IGP, Olatunji Disu don order make police deploy more tactical team to guide Oriire Local Government Area, Oyo State, afta deadly attack and kidnapping wey hapun around nearby forest areas. Di incident hapun early hours of Friday, 15 May 2026 for Oriire area. Police tuk, tuk, DCP Anthony Placid, tuk say di IGP give di order during im personal visit to Oyo State because of […]

todayMay 18, 2026 14

National

Makinde PDP Branch To Screen Over 3,000 Aspirants For 2027, General Elections

By: Esther Ayoola Say confusion gadima for Oyo State, as Pipos Democratic Party (PDP) , di branch of  Oyo State Govo, Seyi Makinde,  drop update say dem wan screen 3,181 pipo wey wan run for different position for di 2027 general elections. Di Oyo state govo put dis one for Inside statement wey dem release for X on Sunday. Say, out of all di pipo wey register, 2,122 dey go […]

todayMay 18, 2026 9

Lagos

APM Governorship Candidate Laja Adeoye Promise 4th Mainland Bridge

By: Esther Ayoola One Lagos governorship candidate, under di canopy of Allied Pipos Movement, Prince Laja Adeoye,  don promise say im go build 4th Mainland Bridge and create Amotekun Corps if im win 2027 election. Adeoye yarn dis on Sunday as im bin dey tell im pipo about im “RESET LAGOS Agenda 2027” wey dem tag “Àtunto Èkó 1.0, Re-Engineering Lagos for Inclusive Prosperity.” According to am, di plan, na […]

todayMay 18, 2026 9

Lagos

Police Gbab Six “One Chance” Suspects For Okota Lagos

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police Command don arrest six suspected members of “one chance” robbery gang, wey bin dey operate around Ago Palace Way for Okota, Lagos State. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, naim convasate dis mata for statement wey she post for X on Sunday. According to di police, di suspects bin dey inside one keke (korope), when officers stop and search dem during patrol operation. […]

todayMay 18, 2026 4

Lagos

Desmond Elliott Cry Out Say Mehn Dey Intimidate Am For Surulere APC Primary

By: Esther Ayoola Fire dey for mountain, or Surulere rather, say like dis Lagos lawmaker, Desmond Elliott, don accuse some All Progressives Congress, APC, leaders and local gornment, say dem dey intimidate im supporters. Im yarn dis one for one viral video wey circulate on Sunday, Elliott cast some party leaders. Di Surulere Constituency I representative also allege say dem remove some local gornment officials from office sake of say […]

todayMay 18, 2026 9

Economics

CBN Warn Say Election Spending toTrigger Inflation Ahead 2027

By : Jolayemi Olajide Baba Govo of di Central Bank of Nigeria and members of di Monetary Policy Committee, Olayemi Cardoso don warn say election spending cause inflation gbege. Di warning come from MPC personal statements released after dia 304th meeting wey hold on February 23 and 24, 2026, wia dem reduce Monetary Policy Rate from 27 percent to 26.5 percent. CBN Govo Olayemi Cardoso say although inflation fit continue […]

todayMay 15, 2026 18

OBODO NAIJA

Senator Gbenga Daniel Drag Governor Abiodun say make dem do Debate

By : Jolayemi Olajide Senator representing Ogun East, Gbenga Daniel don publicly drag Ogun State Governor Dapo Abiodun say make im appear for national TV con defend im performance. Daniel, wey serve as Ogun State govo from 2003 to 2011, throw di challenge on Thursday during one TVsit down tuk, Lagos. E say if Abiodun refuse to show up for di debate, e go take am as sign say di […]

todayMay 15, 2026 18

Health

Ebola Outbreak Hit Eastern DRC As Health Authorities Raise Alarm

By : Jolayemi Olajide Di Africa Centres for Disease Control and Prevention (Africa CDC) don konfam fresh outbreak of Ebola virus for eastern part of Democratic Republic of the Congo, on Friday. Say like dis, di disease don kpai some persons. Reports show say about 246 suspected cases and 65 deaths don already record, while 4 deaths don also happen among laboratory-confirmed cases. Africa CDC say di outbreak dey centered […]

todayMay 15, 2026 19

OBODO NAIJA

Tambuwal Withdraw From 2027 Race As ADC Pick Consensus Candidates

By : Jolayemi Olajide Former Sokoto State Govo, Aminu Tambuwal don withdraw from di Sokoto South Senatorial District race ahead of di 2027 general elections. Di African Democratic Congress (ADC) later endorse former Speaker of di House of Representatives Faruk Yabo as consensus candidate to replace am for di senatorial contest. Reports also show say Manir Muhammad Dan’iya, wey serve as Tambuwal deputy governor, naim be ADC consensus governorship candidate […]

todayMay 15, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds