By: Ayobami Dada
Peter Obi say hin record as Anambra gofnor show say e fit improve Naija if Nigerians give am chance to become presido for 2027.
Obi promise say e go fight corruption, cut gorment waste, bring order to gofnance, stop election rigging and focus on health, education, security and poverty.
Dis come after hin former running mate, Yusuf Datti Baba-Ahmed, say none of di politicians wey dey challenge Tinubu for 2027, including Peter Obi, fit improve Naija.