By: Mariam Ajayi
Super Eagles striker Victor Osimhen don pick groin injury as Galatasaray confirm say e get serious strain for di muscle around him right groin.
Osimhen pick di injury during Galatasaray 3-2 win over Istanbul BaÅŸakÅŸehir on Friday, after e score di first goal before dem carry am comot for 33rd minute because e dey feel pain.
Galatasaray say Osimhen don start treatment, but dem never give time when e go return, while di injury fit affect him for Nigeria upcoming 2027 AFCON qualifiers against Madagascar and Guinea-Bissau.