Blog horizontal

Background

National

Defence Minister Declare Say New Generals Must Fight Security Wahala

By: Rilwan Agbomeji Di minister of defence, Gen. Christopher Musa (rtd), don tell newly promoted Nigerian army generals make dem bring fresh and better strategies to tackle security wahala for di country. E talk dis one during di decoration ceremony of 28 major generals for Abuja. Musa remind dem say Nigerians dey watch dem and dey expect results, and di security challenges na everybody own, so dem must face am […]

todayDecember 11, 2025 6

Sports

Super Falcons Fall Enter 37th For FIFA Ranking

By: Rilwan Agbomeji According to report say Super Falcons don drop enter 37th position for latest FIFA Women World Ranking. FIFA release di new ranking on Thursday, and di Falcons no play any match during di last international break. Dem bin before dey 36th position for di world. Even with di drop, Naija still dey hold number one spot for Africa.  

todayDecember 11, 2025 9

foreign

How Tanker Wey US Seize Take Hide Im True Location

By: Rilwan Agbomeji US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast. Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement. Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover […]

todayDecember 11, 2025 5

National

Bayelsa Deputy Gov Collapse, Dem Rush Am Go Hospital

By: Rilwan Agbomeji Bayelsa Deputy Governor, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, slump for Government House Yenagoa and dem rush am go hospital sharp sharp. Reports wey land troway say di incident happen Thursday afternoon and di matter serious. Sources add say dem carry am go Federal Medical Centre Yenagoa for sharp treatment, but hospital officials never yarn anything. Di Deputy Governor media person, Doubara Atasi, confirm say di thing happen but e […]

todayDecember 11, 2025 6

foreign

Jaguda Boy Use Hand Touch Bristol Museum ,Thief 600 Artefacts

By: Alice Iduh Bristol  for inside United kingdom dey shake say, some Jaguda boys enter dia museum thief about 600 of dia precious artefacts wey dey show link between Britain and former British Empire don vanish. Police talk say dem comot am for museum since September 25. Avon and Somerset police don release CCTV wey show four men wey police dey find, dem dey outside di building wey hold di […]

todayDecember 11, 2025 6

Lagos

Lagos Police Clear Inspector Weh Dem Beat For Oshodi Say Im Nor Thief

By: Alice Iduh Lagos State Police don clear tori wey dey go viral, say one inspector wey area boys beat for Oshodi inside video dat im thief, nor thief anytin. Na for inside statement on Thursday by police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi,Police talk say na lie, say di officer dey do im official work wen di wahala hapun. Adebesi yarn mata dat,di inspector dey Lagos State Taskforce, and e […]

todayDecember 11, 2025 13

Lagos

Lai Mohammed Drop Bombshell Say No Massacre Happen For Lekki, Na Fake News

By: Alice Iduh What a bombshell, Former Minister of Information, Lai Mohammed, don  come out clear mata  say no bodi  die for Lekki Toll Gate during EndSARS, and dat di massacre na fake. E talk say na fake news and social media wahala dey spread di story. Mohammed yarn say one big wahala wey e face na to fight misinformation, and e still dey promote im new book.

todayDecember 11, 2025 14

Sports

Victor Osimhen Collobi Turkey Sportsman Of The Year Award

By: Alice Iduh Galatasaray striker Victor osimhen based on betterlicoius doings don win sportsman of di year award for turkey for 2025 gq türkiye men of di year awards. Di nigerian forward help galatasaray win plenty matches last season as e score 37 goals and give 7 assists across all competitions. Osimhen wey dey 26 years old, don still dey fire this season with 11 goals in 14 games.

todayDecember 11, 2025 13

obodo oyinbo

Venezuelan opposition Leader Maria Machado return After years of hiding

By: Alice Iduh Venezuelan opposition leader Maria Corina Machado don show face last last  for Oslo on Thursday after nearly one year wey she dey hide, as she win Nobel Peace Prize. Di Nobel Institute talk say Machado do “everything in her power to come to the ceremony,” say her journey  dey   dangerous,” but she reach too late to collect the prize. Machado herself tori pipo say, she dey go  […]

todayDecember 11, 2025 4

south west

Governor Adeleke explain say im sti love PDP

By: Alice Iduh Osun State Governor, Ademola Adeleke,  don reacts to tuk say im  abandon Pipos democratic party  after im use dem climb, now don run go  Accord Party. Ontop yanings for tv sit down tuk, the govo say im nor abandon any parti, say in fact,  im still love PDP, but wahala inside the party push am to find better platform for him 2026 re-election. Adeleke say he try […]

todayDecember 11, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app