Blog horizontal

Background

Politics

INEC Final List Don Set Stage For 2027 Senate Battle

By: Mariam Ajayi INEC don release final list of candidates for 2027 elections, as parties dey prepare for 109 Senate seats. Di election wey go hold for February 2027 go see gofnors wey go comot office, serve and former lawmakers, political newcomers and other aspirants fight to determine who go enter di 10th National Assembly. For Abia, Adamawa, Akwa Ibom, Anambra, Bauchi, Bayelsa, Benue, Borno, Cross River, Delta, Ebonyi, Edo […]

todaySeptember 14, 2026 5

Lagos

LAWMA Go Arrest Pipo Wey Buy From Roadside sellers

By: Mariam Ajayi Lagos Waste Management Authority, don warn say anybody wey buy goods from traders wey dey sell for road go face arrest and prosecution. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, announce dis for im office, say di new enforcement go target both illegal traders and pipo wey dey buy from dem. E explain say di action dey follow Section 151(2) of Lagos State Environmental Management and Protection Law […]

todaySeptember 14, 2026 6

Sports

Zverev Flog Shelton, Win Second Grand Slam Title

By: Mariam Ajayi Alexander Zverev, flog America smallie Ben Shelton, wetin nor good 6-3, 7-6, 5-7, 6-2  to kpake  US Open final on Sunday, based on senior man doings. Dis na Di German man  second Grand Slam trophy dis year after e first kpake French Open, con dey make Shelton dey  cry like small pikin. With dis double trophy victory, Zverev don finally wipe away di heavy heart-break of 2020 […]

todaySeptember 14, 2026 6

obodo oyinbo

Trump Clear marras On China Role Of Iran Bombing US Base

By: Mariam Ajayi US presido Donald Trump, don clear tatafo say make dem rest, which one be China naim supply Iran informate to Bumb Jordan, kpai  three US Army. Trump yarn dis one inside Air Force One airplane, senior man first laugh, say US sef dey Spy China, dat one nor be news, and dat di mata sef nor get evidence. Di Senior man Presido, sti clear mata say di […]

todaySeptember 14, 2026 7

OBODO NAIJA

Tinubu Tell World Bank, UN Say Make Dem Change

By: Mariam Ajayi Tinubu don tell world leaders for India say make dem rearrange UN and world finance bodies. Senior man presido porporly dis mata through hin,  Vice, Kashim Shettima, inside di 2026 BRICS Summit for New Delhi. According to Tinubu, table gat turn, cause current doing nor dey really dey show economic and population of poor countries, make dem nor go think say Nigeria and other third world countries […]

todaySeptember 14, 2026 6

Lagos

NDLEA Burst Colos And Heavy Drugs Inside Cargo Across States

By: Mariam Ajayi National Drug Law Enforcement Agency, wan scarra plans for boys, say dem don gbab boys with  loads collos, wey dem hide  inside  music speakers, loaves of bread. NDLEA spokesman Femi Babafemi naim dey porporly dis mata  on Sunday. Say dia operatives catch two packages of Colos wey dem send from United Kingdom, plus another two parcels wey dem pack put inside big sound speakers for Lagos motor […]

todaySeptember 14, 2026 8

Local

NEMA Warn River Niger Communities Make Dem Ready for Flood

By: Kofoworola Olayinka NEMA official Madukwe don warn people wey dey live near River Niger and other flood-prone areas to stay alert and ready move to safer places if flood palava start. She say residents no suppose wait make water enter dia houses before dem take action, because early preparation fit reduce di damage flood fit cause. Madukwe say NEMA, SEMA and Nigerian Red Cross go continue to monitor River […]

todaySeptember 11, 2026 12

Local

Otti Wife Give 400 Women With Disabilities N20m Support

By: Kofoworola Olayinka Abia Gofnor Wife Priscilla Otti don give N20 million and food items to 400 women wey dey live with disabilities for Umuahia on Friday. Otti, through her Safe Tent Care Initiative, say di support na to help women wey dey face financial hardship and make sure dem no dey left behind. She say her office don dey support people with disabilities since 2023, with plans to train […]

todaySeptember 11, 2026 11

obodo oyinbo

Iran President Say US Pressure Don Reach Dangerous Level

By: Kofoworola Olayinka Iran Presido Masoud Pezeshkian say US pressure on Iran don reach critical and dangerous level, as e speak for India on Friday ahead of BRICS summit. Pezeshkian say heavy sanctions and economic pressure don make Iran matter worse, especially after US and Israel military attack on Iran. He say di world dey face unprecedented complexity, as di conflict don hit Iran economy wey international sanctions already weaken.

todaySeptember 11, 2026 10

OBODO NAIJA

Police Burst Fake 50,000 Recruits Training Story

By: Mariam Ajayi Police don expose fake statement wey dey waka round social media, say IGP Olatunji Disu don order training for 50,000 new police recruits. Police tuk say dem no issue or approve di statement, even as dem use Police letterhead and name of dia spokesperson package am. Di fake paper claim say Police don arrange training for di new recruits, with focus on discipline, professionalism and human rights. […]

todaySeptember 11, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds