Blog horizontal

Background
president Bola Tinubu

Politics

Tinubu Dash Jang Pikin Big Aso Rock Position, Surprise Crowd for Jos

By: Jolayemi Olajide Presido Bola Tinubu don appoint Yakubu Jang, pikin of former Plateau Gofnor Jonah Jang, as Senior Special Assistant for Office of di Presido, and Vice Presido Kashim Shettima announce am on Saturday during Chief Jang 80th birthday celebration and book launch for Jos, Plateau State. Shettima tok say na on behalf of Presido Tinubu e make di announcement, as di appointment land for front of plenty top […]

todayAugust 1, 2026 7

south west

Kwara Police Shut Mouth, Say “176 People No Dey Our Record!”

By : Jolayemi Olajide Di Kwara Commissioner of Police, Ojo Adekimi, don burst di 176 kidnap gist wey dey fly everywhere, tok for Ilorin on Friday say no official security record show say terrorists carry that kind number of people for Woro and Nuku communities inside Kaiama Local Government Area. Adekimi yarn say yes, di attackers truly carry some residents comot, but anybody wey dey shout say na exactly 176 […]

todayAugust 1, 2026 8

south west

 Police Burst Kidnap Gang, Rescue Woman as One Suspect Waka Go Meet Maker

By : Jolayemi Olajide Di Enugu State Police Command don rescue one woman wey suspected kidnappers carry for Anuka Road, Okpuje inside Nsukka Local Government Area, after intelligence-led operation on Saturday end with one suspect kpai. Police spokesperson SP Daniel Ndukwe tok say di incident happen around 10:10 a.m. on July 31, when armed men comot from nearby forest storm di area and forcefully carry di woman go. Ndukwe explain […]

todayAugust 1, 2026 8

OBODO NAIJA

Heavy Flood Don Swallow Delta High Court, Houses and Shops for Agbarho

By: Esther Daniel Heavy flood on Friday morning don cover Delta State High Court, houses and business places for Agbarho community in Ughelli North Local Gornment Area after overnight heavy rain from Thursday night . Residents say communities like Orhokpokpor, Ehwere, Ughrwughelli and Oviri suffer serious damage as flood destroy furniture, electrical appliances, food items, clothes and other valuables inside many homes. Shop owners suspend business while motorists and pedestrians […]

todayJuly 31, 2026 18

obodo oyinbo

Liberia Presido Sack 12 Officials As Big Cocaine Scandal Burst

By: Esther Daniel Liberia Presido, Joseph Boakai don sack 12 gornment officials and order investigation into some others after massive cocaine seizures shake di country and spark public anger. Boakai announce di decision through official statement on Thursday night, say di move na to tighten di fight against drug trafficking and hold people accountable. Earlier dis month, security agencies seize almost four tonnes of cocaine worth about 317 million dollars […]

todayJuly 31, 2026 9

Education

New JAMB Boss Draw Battle Line, Say Exam Fraud No Go Fly Again

By: Esther Daniel New Joint Admission Matriculation Board, JAMB Registrar Prof. Segun Aina don vow say anybody wey wan spoil di integrity of JAMB through exam malpractice or admission fraud go face di full weight of di law. Aina make di promise on Friday during di official handover ceremony for JAMB headquarters, Bwari, Abuja, saying fairness, trust and transparency go remain di foundation of di board. Di new registrar warn […]

todayJuly 31, 2026 11

OBODO NAIJA

Makinde Set Up Panel To Dig Deep Into Oyo School Kidnap

By: Esther Daniel Oyo State Govnor Seyi Makinde don set up eight member Judicial Commission of Inquiry on Friday for Ibadan to investigate di abduction of students and teachers wey happen for Esinele and Yawota communities, Oriire Local Gornment Area, on May 15, 2026. Makinde, wey inaugurate di panel for Executive Council Chamber, Agodi Secretariat, say di commission no be to question security agencies but to uncover di truth behind […]

todayJuly 31, 2026 11

Lagos

Airport Police Grab 13 Suspects Wey Dey Loot Building

By: Esther Daniel Airport Police Command for Lagos don arrest 13 suspects wey allegedly go thief airport  building materials from construction site for Murtala Muhammed International Airport. Airport Police ASP Mohammed Adeola naim konfam dis on Friday. Adeola say na betalicious joinbodi doigns by joint Monitoring Task Force  dem take go gbab di suspects on July 30. Police recover expensive copper cables, iron components and oda building materials from di […]

todayJuly 31, 2026 11

Sports

Team Nigeria Dey Pepper Africa, Still Hold Number One Spot For Commonwealth Games

By: Esther Daniel Team Nigeria still dey reign as Africa number one team for Glasgow 2026 Commonwealth Games after dem pile up more medals and hold dia ground for di table. National Sports Commission confirm on Friday say Nigeria don gather 16 medals,eight gold, five silver and three bronze to sit fifth for di overall standings. Di strong medal haul don keep Nigeria ahead of every oda African country wey […]

todayJuly 31, 2026 10

Entertainment

Davido Don Ready To Enter Nollywood, Say Acting Na Di Next Move

By: Esther Daniel Afrobeats star Davido don reveal say im don ready to enter movie industry, as he talk say acting na di next level for im career after already producing two films. Davido yarn dis during one recent interview, where he also reveal say one big documentary about im life and journey don ready and go soon drop. Di singer explain say music dey change every day like technology, […]

todayJuly 31, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds