Blog horizontal

Background

OBODO NAIJA

FG Clear Air, Say Light Bill No Go Rise Now

By: Esther Daniel Federal Gornment don clear Nigerians say no plan dey to increase electricity tariff, as Power Minister Joseph Tegbe tok say Tinubu gornment wan focus on better light, no be higher bill. Tegbe yarn dis on Friday for Abuja, say gornment main target na make more Nigerians get steady electricity, everybody get meter, and people pay only for di light wey dem use. Di Minister still reveal say […]

todayJuly 31, 2026 9

OBODO NAIJA

Ironsi Family Burst Out, Tell FG Say Dem Still Owe Dem Apology And Compensation

By: Esther Daniel Wahala don reopen as family of Nigeria first military Head of State, General Aguiyi Ironsi, don face Federal Gornment, demand apology and compensation over di killing of dia son. Di family head, Imo Aguiyi-Ironsi, yarn on Thursday for sidun tuk say Ironsi na correct leader wey get vision for Nigeria, but dem cut him journey short after just six months for office. Imo talk say Ironsi no […]

todayJuly 31, 2026 9

Sports

FIFA Boss Infantino Receive Heavy Blow As Top Adviser Quit Over World Cup Deal

By: Esther Daniel FIFA Presido Gianni Infantino don suffer big setback as him senior adviser Carlos Cordeiro resign on Friday over plan to sell part of di World Cup business operations. Cordeiro, wey be former US Soccer Federation president, talk say he no fit support di move because he believe say di deal no good for football. Di former banker and lifelong football fan explain say him decision come because […]

todayJuly 31, 2026 13

OBODO NAIJA

Peter Obi Burst Out Over Hunger Wahala, Say Nigerians Don Tire For Suffering

By: Esther Daniel NDC presidential candidate Peter Obi don raise alarm over hunger and insecurity for Nigeria, say oga Presido Bola Tinubu-led APC gornment never do enough to fix di serious problems wey dey face Nigerians. Obi drop di heavy words during funeral service for late Okaji Simon Okorie Abaa for Isiama, Ebonyi State, where crowd gather as he charge Nigerians to stand strong and defend dia votes for 2027. […]

todayJuly 31, 2026 8

Sports

Tobi Amusan Open Up, Say Injury Carry Am Enter Commonwealth Final

By: Esther Daniel Nigeria hurdles queen Tobi Amusan don reveal say knee injury wey she pick from training camp fall disturb her before she enter 100m hurdles final for Glasgow Commonwealth Games. Amusan yarn say di injury make her dey doubt if she go fit compete well before Thursday race, as she battle to recover on time. Di world-class sprinter still push through di pain to grab bronze with 12.60 […]

todayJuly 31, 2026 9

OBODO NAIJA

Kenneth Okonkwo Tell Tinubu Say INEC Never Prove Dia Self

By: Esther Daniel ADC big man Kenneth Okonkwo don blast oga presido  Bola Tinubu over him defence of INEC, say di electoral body never prove to Nigerians say dem dey fair and neutral. Okonkwo react after Tinubu talk am on Tuesday during meeting with Catholic Bishops for State House, Abuja, where di presido defend di commission. Tinubu insist say INEC still dey independent and say people wey dey question dia […]

todayJuly 31, 2026 8

Entertainment

VeryDarkMan Say Tyla No Go Perform For Lagos

By: Esther Daniel Social media activist VeryDarkMan don kick against South African singer Tyla concert wey dem plan for Lagos, say di move na to protest di xenophobic attacks against Nigerians and oda Africans for South Africa. VeryDarkMan drop di message for one video on him verified Instagram page, where he call on concert organisers and South African celebrities to speak out against di attacks. Di activist make am clear […]

todayJuly 31, 2026 9

OBODO NAIJA

Keyamo Blast Peter Obi, Say Na Lie Him Talk

By: Esther Daniel Aviation Minister Festus Keyamo don blast NDC presidential candidate Peter Obi, accuse am of lying over him e claim say airport officials harass am for Abuja. Keyamo yarn on Thursday say Obi no bring any proof to support di allegation and say di claim don paint airport workers bad for no reason. Di Minister insist say workers for Nnamdi Azikiwe International Airport do dia job professionally and […]

todayJuly 31, 2026 11

obodo oyinbo

Gas Explosion Wipe Out 34 Coal Miners For Pakistan

By: Esther Daniel Methane gas explosion don kill 34 coal miners inside one coal mine for Balochistan, Pakistan, after di blast scatter di underground pit on Thursday night. Disaster officials confirm di death toll for Quetta on Friday, say di powerful explosion trap di miners underground before rescue teams reach di scene. Joint rescue teams later recover all 34 bodies as emergency workers use heavy equipment take clear di deep […]

todayJuly 31, 2026 4

Sports

Football World Dey Mourn As AC Milan Legend Franco Baresi Die

By: Esther Daniel Football world dey mourn as former AC Milan captain and Italy legend Franco Baresi die on Friday morning at di age of 66. Baresi spend all him playing career for AC Milan from 1977 to 1997, where he play over 700 matches and become one of di greatest defenders football don ever see. Di Italian icon win six Serie A titles, three European Cups and plenty oda […]

todayJuly 31, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds