Blog horizontal

Background

Lagos

Police Nab Lagos Couple Wey Fake Kidnap

By: Esther Ayoola Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends. According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel  back to US and  as money no dey, so dem make di plan together. Say, na for one school […]

todayJanuary 30, 2026 5

Lagos

UNILAG And UK University Join Bodi Set Up New School Unit For Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola University of Lagos (UNILAG) and University of Birmingham for UK don sign Memorandum of Understanding to set up Transnational Education Unit, inside, UNILAG. Dis agreement go make dem work with Nigeria Ministry of Education to prepare plans, with aim to start teaching students by 2027. According to report, di courses go include Applied Intelligence, Digital Communication and Media, health sciences and engineering. Education Minister, Dr Tunji Alausa, […]

todayJanuary 30, 2026 4

Sports

Wilfred Ndidi Pay Emotional Tribute Giv Im Late Papa

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, Wilfred Ndidi, don pay emotional tribute to im papa, Mr Sunday Ndidi wey tragically die yesterday afta one car run am for Umunede, near Agbor for Delta State. Ndidi Turkish Super Lig club, Besiktas, don announce say senior Ndidi don die for dia X handle yesterday, and dem still send condolence to di retired soldier. Di Super Eagles Captain for emotional post for im […]

todayJanuary 29, 2026 12

Konfam Mornin Jollof

Funky Palace – Why Some Men Dey Cheat Afta Dem Make Am and Wetin E Dey Do Marriage

Why some men dey change once dem don make am for life? For dis video, we go talk about why cheating dey happen after success, how e dey scatter marriage, and the lessons both men and women suppose learn from am. Na serious discussion about values, self-control, and how person suppose remain humble and grounded even when money and achievement don come. Watch full video for YouTube!

todayJanuary 29, 2026 37 8 2

Konfam Mornin Jollof

Know your Right- How to Use Freedom of Information (FOI) Act Take Get Government Information

Freedom of Information (FOI) Act give Nigerians right to ask and collect information from government offices. For dis video, we go explain how you fit use di FOI Act, which government bodies e cover, and di correct way to submit your request. Dis na important knowledge wey every Nigerian citizen suppose get to hold government accountable.   Watch full video for YouTube!

todayJanuary 29, 2026 31 6 2

Konfam Mornin Jollof

Bodi Mata – Waist Pain: How E Dey Affect Your Body and How You Fit Reduce Am

If waist pain dey slow you down, dis video na for you. We go break am down how waist pain dey affect your daily life like work, movement, and rest. You go also learn simple and realistic ways wey fit help reduce the pain make your body dey feel better. No stress, no complicated talk – na clear explanation and correct tips wey you fit start to use immediately.   […]

todayJanuary 29, 2026 32 7

OBODO NAIJA

Turkish Official Defend Tinubu Fall Wahala – Abike Dabiri

By: Rilwan Agbomeji Di palava wey burst for Naija over President Bola Tinubu small stumble during im official visit to Türkiye, Turkish officials don wave am comot hand, call am silly, according to Chairman of Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa. Dabiri-Erewa yarn dis one on Wednesday as she dey answer one post for X from Oguntoye Opeyemi wey talk about how Naija media carry di marras. She talk say, […]

todayJanuary 29, 2026 11

OBODO NAIJA

We No Giv Order Say Make Tear Gas Scatter Protesters – Lagos Lawmakers

By: Rilwan Agbomeji Lagos State House of Assembly don clear members of di House say dem no get any hand for alleged order wey talk make dem fire teargas and arrest protesters for di Assembly gate on Wednesday. No forget say plenti protesters jam di Assembly gate on Wednesday to show say dem nor happy with di demolition wey State Govment do for Makoko area. Di clarification dey inside statement […]

todayJanuary 29, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Ready To Strike US If Gbege Happen

By: Rilwan Agbomeji Iran foreign minister, Seyed Abbas Araghchi don yarn say Iranian army dey ready to immediately and powerfully strike back if US try attack dem. Di warning land just hours afta US Presido Donald Trump yarn again say dem fit carry military action come. Di USS Abraham Lincoln, one nuclear-powered aircraft carrier, na one of di many military tins wey US don send go Arabian Sea these past […]

todayJanuary 29, 2026 10

OBODO NAIJA

Jaguda Boys Gbab Youth Leader For Tinubu-Shettima Campaign

By: Rilwan Agbomeji  Jaduga boys wey people dey talk say na bandits don kidnap Ambassador Bashir Isa Gusau, North-West Youth Leader for Tinubu/Shettima campaign for Zamfara State. Di mata first show for public afta security analyst Bakatsine post am for X on Thursday. According to di post, pass 30 Jaguda boys waka enter Gusau house for Gusau town, gbab am as di gbebe dey happen. Gusau family dey distressed like […]

todayJanuary 29, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app