Blog horizontal

Background

National

FG, Governors Honour Soldiers As Nigeria Mark Armed Forces Remembrance Day

By: Esther Ayoola Nor be small choir doings for Abuja, As Nigeria mark 2026 Armed Forces Remembrance Day on Sunday, both federal and state gorments do beta collabo sing for soldiers wey dey serve, retired ones, and those wey don die for duty. Church services hold all over di country as leaders pay respect to di selfless sacrifices of di military for unity, peace, and protection of Nigeria. Minister of […]

todayJanuary 12, 2026 14

National

Pope Warn Say Surrogacy Na Wrong Way To Build Family

By: Esther Ayoola Pope Leo XIV don condemn surrogacy, say e dey make family mata comot from normal doings. Surrogacy na arrangement wey woman carry pikin for anoda woman  wey no fit get own. Oga pope tell diplomats say make church no support any practice wey dey exploit life or waka against how life suppose be. Di practice don dey more popular worldwide because infertility dey rise, IVF technology dey […]

todayJanuary 12, 2026 5

Lagos

Chimamanda Adichie Drag Lagos Hospital Over Pikin Death

By: Esther Ayoola Senior Nigerian writer, Chimamanda Adichie, don drag one private hospital for Lagos, Euracare, say make dem come answer for wetin happen afta her 21-month-old pikin, Nkanu Nnamdi, kpai for di hospital. Her Mata sef dey raise worries about di hospital as plenty, plenty pipo sef dey accuse di hospital of medical negligence and professional misconduct. Say, like dis, Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don also order investigation […]

todayJanuary 12, 2026 7

Lagos

Lagos Gorment Release Plan For Waterside Business

By Ebi Oboko Lagos State  gorment don release new plan say, dem wan turn all   watersides for  di state to beta business wey go bring state  money. Based on yanings with tori pipo,  Di  Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tuk say, dis new policy go hapun dis  2026 and say, e show beta workings for  2025. Before now, say  people dey buy land dem for di waterside, dem […]

todayJanuary 12, 2026 15 4

National

Wike Challenge Haters to Tell Tinubu to Sack Am

By Ebi Oboko FCT Minister, don tell im haters say make dem dey dia dey,  say, na only President Bola Tinubu get power to sack am from im cabinet, not people wey dey criticize am. Di minister yarn this one on Sunday when e go Obio/Akpor LGA for Rivers State for the last part of im “thank you” visit. Wike say if Tinubu feel say e no get anything to […]

todayJanuary 12, 2026 16

foreign

Iran Presido, Pezeshkian Promise to Listen to Protesters

By Ebi Oboko Iran presido, Masoud Pezeshkian, don bow to pressure,   say  dem go  rearrange di iran economy wey dem spoil, dey warn protesters to be calming down. Pezeshkian dey beg for tv sit don tuk, say make di protesters nor go do until  “rioters” and “terrorist elements”  con take over di mata, say dat one  go be big  wahala. The protest don enter third week after market people for […]

todayJanuary 12, 2026 13

Sports

El Clasico Final: Barcelona Conquer Real Madrid 3-2

By Ebi Oboko Barcelona don go beat  Real Madrid 3-2 for El Clasico for Spain Super Cup final for Saudi Arabia, ni dem run dis one. Raphinha shine shine bobo, score two goals for  di Catalan side. Barcelona  wey dey top La Liga  qualify for di final afta dem hammer Real Betis 5-0 for semifinal. Real Madrid beat Atletico 2-1 for di second semifinal before dis final. Last year, Barcelona […]

todayJanuary 12, 2026 23 5

Sports

Super Eagles To Buy Waka To Rabat For AFCON Semis

By Ebi Oboko Unto update for AFCON, say Super Eagles go waka from Fes go Rabat on Monday afternoon for dia semi-final match wey dem go play against AFCON 2025 host Morocco. Team media officer Promise Efoghe na im yan one. On Sunday, Super Eagles don return Fes and dem do recovery session by 6:15pm for Saardienne football complex. Now, all the players and officials go travel to Rabat,  ready […]

todayJanuary 12, 2026 19 2

National

Dangote Drag Former NMDPRA Boss Go EFCC Over Corruption

By: Esther Ayoola Chairman of Dangote Industries, Aliko Dangote, through im legal representative, don submit corruption petition against former NMDPRA Managing Director, Farouk Ahmed, for EFCC headquarters. Dangote Group media team tuk dis one on Friday through one statement wey dem give our correspondent. According to di statement, Dangote take di marra go EFCC for investigation, accusing Ahmed of alleged corruption and financial misconduct. Di move come afta Dangote earlier […]

todayJanuary 9, 2026 12

obodo oyinbo

Trump Warn: US Fit Hit Nigeria Again Over Killings

By: Esther Ayoola US President Donald Trump don warn say America fit launch more military strikes for Nigeria if violence against Christians no stop. Trump tuk dis one on Thursday during wide interview with The New York Times, as e respond to question about di US airstrike wey happen on Christmas Day for northwest Nigeria. According to am, di December 25 strike target Islamic State-linked militants at di request of […]

todayJanuary 9, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app