Blog horizontal

Background

National

Tinubu Appoint New Ogas for NECO, NBTE to Make Education Stronger

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don approve new appointments for key education agencies. Dis na according to a statement by im media aid, Bayo Onanuga tuk on Wednesday for Abuja. According to am, dis move na to strengthen institutions under Federal Ministry of Education and improve how dem dey run. Tinubu appoint Prof. Modupe Adeola Adelabu as chairmo for National Examinations Council board, while Prof. Ibrahim Wushishi […]

todayApril 22, 2026 11

Sports

Adepoju Back Iheanacho Return To Super Eagles After Di Striker Show Fine Form For Celtic

By: Esther Ayoola Former Naija player Mutiu Adepoju don call for Kelechi Iheanacho return to Super Eagles, based on di striker fine form for Celtic. Iheanacho join di Scottish club last summer, but injury wahala like hamstring problem reduce im game time dis season. Even with all dat, di 29-year-old sti score 6 goals and give 1 assist for 18 matches wey im don play for di club.

todayApril 22, 2026 14

Sports

Chelsea Chop 3-0 For Brighton As Fans Turn Red Eye For Coach Rosenior

By: Esther Ayoola Say like dis Chelsea fans dey vex for dia manager Liam Rosenior afta dem chop anoda 3-0 beating from Brighton, spoiling  dia small Champions League hope. Brighton use goals from Ferdi Kadioglu, Jack Hinshelwood and Danny Welbeck take jump pass Chelsea to sixth position for table. Na so for di second half, travelling fans turn choir, begin shout bad chants for Rosenior as di team continue dia […]

todayApril 22, 2026 11

Sports

D’Tigress Face Tough Test for World Cup Group B, Ready to Fight Back

By: Esther Ayoola Naija D’Tigress don enter tough Group B for 2026 FIBA Women’s World Cup with France, South Korea and Hungary. Dem go meet France and South Korea again, teams wey beat dem earlier for qualifiers for Lyon, but di girls dey expected to ready demselves wella for di fight dis time around. Dis tournament go happen for Germany from September 4 to 13, with top teams from all […]

todayApril 22, 2026 16

obodo oyinbo

Japan Soften Arms Export Rules, Open Door For Weapon Selling Abroad

By: Esther Ayoola Japan don announce say dem go loosen dia long-time strict rules on export of weapons, including lethal defence equipment. Dis na according to statement gornment tuk, tuk, Minoru Kihara on Tuesday. Say dis new move go allow Japan sell finished military products to other countries. According to Prime Minister, Sanae Takaichi say di change important as e go hellep, strengthen national defence and also grow Japan local […]

todayApril 22, 2026 9

obodo oyinbo

US Presido, Trump Give Big Announcement Say Ceasefire With Iran Likely To Continue

By: Esther Ayoola U.S presido, Donald Trump don make public announcement, say di ceasefire wey dey between US and Iran go sti continue till two countries go complete dia peace tuks. Di senior man sti put for im Truth social say, di blockade wey dem put for Iran ports go sti dey, until Tehran bring one clear and united proposal. Say like dis, nobody too sure how di US-Iran tuks […]

todayApril 22, 2026 10

National

Peter Obi Torch Light Federal Gorment 135bn Election Court Spending

By: Esther Ayoola Di 2023 presidential candidate of Labour party, Peter Obi once again don drag wi Federal Gornment oh, say dem spend billions for election court cases instead of to investing. Im yarn dis one for public lecture wey hapun for Coal City University, Enugu State, say di ₦135.22 billion wey dem plan for post-election mata, nor suppose dey. According to am, dat kind money fit help support graduates […]

todayApril 22, 2026 8

National

President Tinubu Do Small Cabinet Change, Edun To Pass Baton Oyedele

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve small cabinet reshuffle wey affect two ministers for Federal Executive Council. Minister of Finance, Wale Edun, go hand over to Taiwo Oyedele wey go become new Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy. Also, Minister of Housing and Urban Development, Ahmed Musa Dangiwa, go hand over to Muttaqha Rabe Darma wey don dey nominated as minister designate. […]

todayApril 22, 2026 13

National

VP Shettima Tuk Why Mehn Need Explain President Tinubu Policies

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don go tell Naija tuk, tuk pipo say make dem dey rep dis kontri wella, break down gornment policies, so dat mama Nkechi and baba Bayo go understand for market. Di vice presido yarn dis one for Kaduna during NIPR Week 2026, where dem gather Tuk, tuk pipo from different places, celebrate dem. According to Shettima, Baba Seyi reforms nor go make complete […]

todayApril 22, 2026 11

National

President Tinubu Declare Say No Shakement For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don make am clear say, e nor get how as e go be, say democracy for Naija go stand  fit,  no mata di intimidation. Im yarn dis one when im receive big delegation from Enugu State, wey Peter Mbah carry come State House. Tinubu praise Mbah for di work wey im dey do to fight insecurity and improve health, education, and infrastructure […]

todayApril 22, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds