Blog horizontal

Background

National

Senator Adamu Never Leave APC – Nasarawa Party

By: Esther Ayoola Nasarawa APC don yarn on Friday for Lafia say no be true say former National Chairman, Senator Abdullahi Adamu, don waka go ADC. Party Organising Secretary, Hassan Abubakar, tuk say na fake news wey political enemies dey spread to spoil di elder statesman image. Dem explain say Senator Adamu, wey be former Nasarawa govo, still dey APC and na committed, card-carrying member. APC add say dis kain […]

todayJanuary 9, 2026 11

Lagos

INEC Chair Swear Say E No Go Be Magomago, Tech Go Run Am

By: Esther Ayoola Prof. Joash Amupitan (SAN), Chairman of INEC, yarn on Friday for Lagos during di 2026 Induction and Strategic Retreat say 2027 General Election go free, fair, transparent and dey run with technology. Im tuk say commission no go tolerate any misconduct to make sure election clean. Amupitan explain say INEC dey prepare for how election dey change fast and wan meet expectations of Nigerians. Di retreat wey […]

todayJanuary 9, 2026 13

National

Ogun Waste MD Burst Lies: No Money Enter My Pocket

By: Esther Ayoola Managing Director of Ogun State Waste Management Agency, Mr Abayomi Hunye, yarn on Thursday for a media parley wey Nigeria Union of Journalists, Ogun State organise, say no be true say him dey collect money from members of Ogun Waste Management Vendors and Recyclers Association. Him tuk say all payments dey go straight into agency account, and nobody don ever pay money enter him personal account. Hunye […]

todayJanuary 9, 2026 6

obodo oyinbo

Naija Collect $9.5M from Jersey – Govt Yarn

By: Esther Ayoola Authorities for Jersey, British Crown Dependency wey dey between UK and France, yarn say dem go return over $9.5 million (£7 million) wey belong Nigeria government. Attorney General for Jersey, Mark Temple KC, tuk say di money go dey used for infrastructure projects across Nigeria. Him yarn dis one follow Memorandum of Understanding wey dem sign with Nigeria government for December. Dis repatriation na continuation of past […]

todayJanuary 9, 2026 6

Lagos

Lagos State Varsity Don Open Job Recruitment For Students

By: Rilwan Agbomeji Lagos State University (LASU) don start recruit students enter LASU Cadet Corps, as dem officially announce am for X dis week. Di programme na student-focused paramilitary and leadership training, wey go help build discipline, patriotism, teamwork and leadership skills among undergraduates. How e go work be say cadets go also help with campus security, orderliness and official school events inside LASU. So if you be student wey […]

todayJanuary 9, 2026 14

Sports

CAF Comot Referee For Super Eagles Match Against Algeria

By: Rilwan Agbomeji CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech. Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule. Even though na di same man wey win Referee of di Year for […]

todayJanuary 9, 2026 19

Sports

Mahrez Yarn Say E No Fear Super Eagles Attack At All

By: Rilwan Agbomeji Algeria captain Riyad Mahrez don talk say e no dey fear  Super Eagles attack at all at all, ahead of Nigeria vs Algeria quarter-final for AFCON 2025 dis Saturday. Di Desert Foxes and Super Eagles go meet again for anoda big rivalry match as dem both enter knockout stage unbeaten. Nigeria don score 12 goals so far, pass any oda team for di tournament, but Mahrez still […]

todayJanuary 9, 2026 19 2

National

Kwankwaso: I Go Only Join Party If Dem Give Me Top Slot

By: Esther Ayoola National leader of di New Nigeria Peoples’ Party (NNPP), Senator Rabiu Musa Kwankwaso, don say e go only join any political party for 2027 election if dem offer am presidential or vice-presidential ticket. Kwankwaso tuk dis one on Thursday during one Kwankwasiyya gathering wey hold for im residence for Miller Road, Kano, while e dey address ongoing political realignments ahead of di next general elections. E explain […]

todayJanuary 9, 2026 12

Lagos

I No Get Rift With Abiodun – Govo Sanwo Olu

By: Esther Ayoola Lagos State Govnor, Babajide Sanwo-Olu, don come out clear tuk wey no true on top beef marras between am and Ogun State govrnor, Prince Dapo Abiodun. Na lie lie tuk, according to am. Di Govo yarn di tori straight for statement wey im media oga, Gboyega Akosile, drop yesterday. Sanwo-Olu con yarn say, make people calm down because nothing like dat dey happen at all, say both […]

todayJanuary 9, 2026 9

obodo oyinbo

Turkish Airlines No Dey Fly Tehran Again As Iran Protest Dey Hot

By: Esther Ayoola Turkish Airlines don cancel five Friday flights wey suppose go Tehran, Iran, afta di city don dey rocked by protests over rising living cost, di Istanbul Airport app report on Thursday. Di airport app also show say five oda  flights wey Iranian airlines dey operate don cancel, while seven others still dey go ahead as scheduled. Turkish authorities never comment on di situation yet, wey dey happen […]

todayJanuary 9, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app