Blog horizontal

Background

obodo oyinbo

US Navy Seize Iranian Ship For Gulf, Iran Vow To Retaliate

By: Esther Ayoola US Presido and Im Navy don go intercept one Iranian cargo ship wey dem dey call Touska for Gulf, as part of dia blockade dey cause serious gbege. Trump explain for im Truth Social say di ship no respond when dem warn am make e stop, naim make dem seize am. Iran dey vex for di other side, say na violation of ceasefire and dem go retaliate, […]

todayApril 20, 2026 11

National

JAMB Release 1.2 Million UTME Result Again

By: Esther Ayoola JAMB don announce di release of result for candidates wey write 2026 UTME on Friday 17 April and Saturday 18 April. According to dia tuk, tuk, Fabian Benjamin, over 1,264,940 results for those two days don ready for candidates to check. Dem also tuk say dis one, say e dey follow di earlier batch wey dem release for people wey write exam on Thursday 16 April. Candidates […]

todayApril 20, 2026 7

National

SSANU Reject 30% Salary Raise, Threaten Strike For Federal Schools

By: Esther Ayoola Say wi Federal gorment bin approve 30% pay increase for non-academic staff for federal universities, polytechnics and colleges of education, but like dis, SSANU don reject di 30% increase. Nor be amebo say di Minister of Education, Dr Tunji Alausa, put for one letter wey e write on March 30, 2026, say di raise go come as Consolidated Non-Teaching Tools Allowance to reduce salary wahala and settle […]

todayApril 20, 2026 9

National

Fintiri Launch Big Campaign Movement For President Tinubu

By: Esther Ayoola Adamawa state govo, Ahmadu Fintiri don launch one movement to campaign for di re-election of Bola Tinubu for 2027 inside Adamawa State. Im yarn dis one on Saturday for APC congress wey hapun for Mahmud Ribadu Square for Yola. Fintiri announce one group wey dem call Adamawa Renewed Hope Movement, wey go get plenty gornment pipo and ward councillors as members. Im sti promise say dem go […]

todayApril 20, 2026 6

National

Benue Hail Security As Dem Rescue Kidnap Victims For Benue Road

By: Esther Ayoola Benue state Govo, Hyacinth Iormem Alia don praise security agencies as dem successfully rescue passengers wey kidnappers carry from Benue Links bus for Makurdi–Otukpo road. Di governor tuk dis one on Sunday, when e receive di freed victims for Old Banquet Hall inside Government House for Makurdi. E thank di Commissioner of Police and other security operatives for dia strong effort wey make di rescue possible. Alia […]

todayApril 20, 2026 8

National

NYSC DG Explain How Dem Wan Take Protect Corpers Nationwide

By: Esther Ayoola NYSC oga, Brigadier-General Olakunle Nafiu, don tuk say dem dey put more effort to protect corpers for all over Naija. E yarn dis one for interview wey e get with news pipo for Abuja, as pipo dey worry about security, kidnapping and corpers welfare. E sti explain say security na general problem for di country, and NYSC dey depend on security agencies to provide correct information and […]

todayApril 20, 2026 8

Lagos

Ogun Police Arrest 3 Suspects, Recover Local Gun, Charms

By: Esther Ayoola Ogun State Police Command say dem don do small jet li arrest three suspects for different operations for Mowe and Sagamu area, and dem recover local gun, cartridges and charms wey dem believe say dey linked to cult and crime activities. According to police tuk tuk, Oluseyi Babaseyi, statement on Sunday, dem carry out di arrest between April 14 and 18, 2026 through intelligence work and stop-and-search. […]

todayApril 20, 2026 9

Lagos

Lagos Prepare To Gather Big Men, Kings, Soyinka For Ogbonge Art Exhibition

By: Esther Ayoola Say like dis lagos State dey prepare to host one big art exhibition wey dem call “Gregorian Art Exhibition” to honour legendary artist Bruce Onobrakpeya. Organisers wey be St. Gregory’s College Old Boys Association put for news statement, say di event go bring top dignitaries, traditional rulers and art lovers come together to celebrate am. Dem also tuk say Nobel laureate Wole Soyinka, Obi of Onitsha Nnaemeka […]

todayApril 20, 2026 12

Lagos

How Lexus Jeep Askident Kpai Hawker For Okokomaiko, Lagos

By: Esther Ayoola Road accident wey hapun for Okokomaiko area for Lagos State don go kpai one roadside hawker. According to Statement on Sunday by LASTMA tuk, tuk, Adebayo Taofiq, e tuk say di victim, wey be adult man, kpai for di spot. E explain say di crash involve one Lexus Jeep wey hit di hawker for road. Taofiq sti tuk say LASTMA officers quickly respond to di distress call, […]

todayApril 20, 2026 12

Lagos

Lagos Launch Cybersecurity Rules To Protect People And Businesses

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don bring new cybersecurity guidelines wey go hellep improve digital safety for businesses, gornment offices and pipo wey dey Lagos. Commissioner for Information and Strategy, Gbenga Omotoso, tuk dis one for statement, say, di policy dey timely, as cyber risks dey increase for Naija every day. Say di framework go set protection rules and systems wey go help secure online activities as Lagos dey […]

todayApril 20, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds