Blog masonry

Background

National

Katsina: ‘Release Our leaders, We Go Free All Captives’ — Bandits

Katsina State don see small small peace move as 20 out of 34 local government areas don enter truce with bandits, even as some communities still dey face attacks. Di agreement, wey council chairmen and traditional rulers from di LGAs attend, include di bandits demand make dem release dia comrades wey dey prison for di state. In return, di armed group promise to free all captives wey dey dia custody. Local authorities gree make security agencies and correctional facilities help […]

todayNovember 21, 2025 17

Entertainment

Tiwa Savage, Yemi Alade Don Finally Settle Beef Afta 7-Year Feud

Nigerian music stars, Yemi Alade and Tiwa Savage, don finally settle dia 7-year feud. Di wahala start for social media wen Yemi Alade throw subtle shade at female entertainers wey dey enhance dia backside for photos to “deceive dia fans.” Dis post show few hours after Tiwa Savage share pics wey show off her curves. Tiwa respond, warn Yemi make she no start war wey she no fit finish: “Don’t start a war you can’t finish.” Di reconciliation happen for […]

todayNovember 21, 2025 18

Sports

Aina Don Back Train After Injury

Ola Aina don return to training for Nottingham Forest after im long injury layoff. Di Super Eagles full-back bin sustain hamstring injury while on international duty with Nigeria for September, and e limp commot di pitch for di 10th minute of Nigeria 1-1 draw with Bafana Bafana of South Africa. Di 29-year-old later go under knife and now dey expected to return to action for Forest next month, something wey go be big boost for head coach Sean Dyche as […]

todayNovember 21, 2025 7

Sports

Palmer Break Toe, Go Miss 3 Chelsea Games

Cole Palmer don break one toe for house accident and e go miss di next three Chelsea games against Burnley, Barcelona and Arsenal. Palmer knack im small left toe for door, and dis one don scatter im return after e don dey out since September with groin injury. Chelsea head coach, Enzo Maresca, confirm say “for sure” Palmer no go dey available for di three matches. According to am, di toe fracture no be big wahala but e no go […]

todayNovember 21, 2025 12

Sports

Napoli President Go Court Over Fake Osimhen Transfer Accounting

Napoli president Aurelio De Laurentiis don enter serious wahala as Italian court don send am go trial over allegation say im falsify di figures for Victor Osimhen transfer. Osimhen join Napoli from French club Lille for 2020, and as part of di deal, goalkeeper Orestis Karnezis plus three Primavera players, Manzi, Palmieri and Liguori, move go Lille. But prosecutors dey accuse De Laurentiis of inflating di value of di four players to boost Napoli financial position. Reports from Tuttosport talk […]

todayNovember 21, 2025 8

Sports

Man City Don Suffer Double Injury Blow Before Newcastle Trip

Pep Guardiola don confirm say Manchester City go miss two key players for dem clash against Newcastle United on Saturday. Di City squad dey head to St James’ Park after dem don win four matches back-to-back for all competitions, including di recent 3-0 beating wey dem give Liverpool before di international break. Di win push Man City enter second place for Premier League table. Even though dem no fit pass Arsenal for top dis weekend, Guardiola men sabi say if […]

todayNovember 21, 2025 7

Sports

Yakubu Aiyegbeni Don Drag Chelle Over Why Im Pick Obasogie For Super Eagles Squad

Former Everton striker, Yakubu Aiyegbeni don question Super Eagles coach, Eric Chelle, over why im include Tanzanian-based goalkeeper, Amas Obasogie, for di squad wey go play 2026 World Cup qualifiers and playoffs. Yakubu talk say, Chelle don call Obasogie eight times but di Singida SC goalkeeper never even make im senior debut. Obasogie no play for Super Eagles under Chelle during di 2026 World Cup qualifiers and playoffs. For Home Turf podcast, Yakubu talk say: “Historically, di coaches dey put […]

todayNovember 21, 2025 6

National

Insecurity – Senate Vow To Restore Normalcy For S-East

Di Senate Adhoc Committee on South-East/North East for di Senate National Security Summit 2025 don assure people of di South-East say dem go restore normalcy and better security for di zone. Senator Austin Akobundu, wey be chairman of di committee, give di assurance during di security summit for Enugu yesterday. Di summit carry di theme: “Strengthening Nigeria’s National Security Architecture: Innovation, Collaboration and Resilience in a Changing World.” NAN report say stakeholders from traditional and religious institutions, President-Generals of communities, […]

todayNovember 21, 2025 8

National

Auditor-General Indict CBN Over Recycled N29.7bn Dirty Banknotes

Di Office of di Auditor-General of di Federation don indict di Central Bank of Nigeria under former Governor Godwin Emefiele for re-circulating dirty and unfit banknotes worth N29.77bn, violate di CBN Clean Note Policy. According to di newly released Auditor-General Annual Report on Non-Compliance and Internal Control Weaknesses for MDAs for year end December 31, 2022, several CBN branches for Abuja, Lagos, Bauchi and Jos issue out banknotes wey dem already classify as “Counted Audited Dirty”, notes wey suppose don […]

todayNovember 21, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app