Blog masonry

Background

Sports

Chelsea Make Premier League Record Loss of £262m

By: Esther Ayoola Say Chelsea don record one kain big loss for Premier League, dat dem loss £262.4 million ($349.3 million) before tax for di last year wey end June 30, 2025. According to experts, say dis record pass di one wey Manchester City get for 2010/11 wey be £197.5 million. Last year, Chelsea bin make profit of £128.4 million because dem sell dia women team to Blueco Midco for almost £200 million. Authorities say, dis big loss hapun because […]

todayApril 1, 2026 13

National

Fear Return For Jos Afta Plateau Curfew Lift

By: Esther Ayoola Tension don burst for Jos, Plateau State again, few hours afta di gornment commot dia 48-hour curfew wey dem put afta di Sunday night attack for Anguwan Rukuba. Eyewitnesses tuk say small-small wahala don start again for different part of Jos, however no bad report say person wunjur or kpai yet. Traders wey just start dia business today run because of fear, as everywia dey rowdy. Plateau State authorities sha don comment say make residents be calming […]

todayApril 1, 2026 15

National

Court Clear Turaki, PDP Chairman Arrest Warrant

One ogbonge Abuja High Court on Wednesday don vacate di bench warrant wey dem issue for March 26 for Kabiru Turaki, a factional PDP National Chairmo. Turaki appear for court today, tuk say e return from outside di country, na him lawyer, Chris Uche SAN, yan am wetin dey play. Uche apologise to court say both him and Turaki dey respect court mata wella. Justice Peter Kekemeke grant di request and cancel di arrest warrant afta hearing di explanation.

todayApril 1, 2026 16

National

EFCC Nab Abuja Agent Over N288m Fake Property Deal

Economic and Financial Crimes Commission don arrest one Abuja house agent, Hajia Adama Adamu, over alleged property scam of N288 million. EFCC tuk say dem catch Adama Adamu  tru dia  Ilorin zonal officers afta person send petition complain. Dem say, she collect di money from one Alhaji Tanko Yawale, promise say she go help am buy property for Abuja. But afta she collect di money, EFCC say she no fit provide correct documents for di property, make suspicion come rise […]

todayApril 1, 2026 8

National

El-Rufai Show Face For Court As Im Bail Mata Continue

By: Esther Ayoola Former Kaduna governor Nasir El-Rufai don show face for Federal High Court Kaduna dis morning around 9 o’clock as dem continue hearing for im bail matter. Say di Court dey under heavy security as police and Department of State Services officers full everywhere. Yesterday, Justice Rilwan Aikawa shift di case because defence and prosecution lawyers get some legal wahala to settle. El-Rufai lawyers first tuk say make judge step aside, but later withdraw, while prosecution still oppose […]

todayApril 1, 2026 14

National

Doctors Threaten To Enter Strike Over Colleague Attack For Ogun

By: Esther Ayoola Nigerian Association of Resident Doctors don raise alarm on Tuesday say danger don dey increase for health workers safety for Naija. For statement wey dia Presido, Mohammad Usman Suleiman, sign, dem say, di latest attack hapun for Olabisi Onabanjo University Teaching Hospital. NARD condemn di act, say di attack na shocking and barbaric act wey violate human dignity and endanger doctors for work.   Dem explain say na one female house officer dem attack after dem identify […]

todayApril 1, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment Tell Dia Childresis To Report Emergencies To 767, 112

Lagos State Gornment don train over 1,000 students on how to use emergency numbers 767 and 112. Say na di Lagos State Command and Control Centre organise dis parrol dey tell di students across di obodo Lagos For statement wey dem release on Wednesday, wey LSCCC, Head Public Affairs, Yemisi Sule sign, say di training na part of effort to improve emergency preparedness and responsible behaviour. She sti add say gornment go continue to spread safety education for schools and […]

todayApril 1, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Revolutionary Guards Threaten Apple, Google, Tesla If More Leaders Kpai

Iran Revolutionary Guards like dis, don cut chain say if more of dia top Iranian leaders kpai sake of dis war, dem go target big US tech companies like Apple, Google, Meta, Microsoft, Tesla and others. Say dem drop microsoft word for di workers for these companies make dem avoid office starting Wednesday 8:00 pm Tehran time to save dia life. Di Iran guards dey claim say, these companies dey help US track and plan assassination of Iranian officials, so […]

todayApril 1, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds