Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

MURIC Tell Adeleke Make E Begin Pack Comot Gornment House

By: Esther Daniel Muslim Rights Concern (MURIC) don tell Osun State Govo, Ademola Adeleke, make e begin prepare to leave Gornment House, say plenty people for di state don reject im administration. For statement wey Executive Director of MURIC, Professor Isiaq Akintola, sign on Monday, di group accuse Adeleke say e deceive Osun people with promises wey no match wetin dey happen for ground. Akintola also claim say one flyover wey govo commission for Osogbo don begin show signs of […]

todayJuly 27, 2026 20 2

OBODO NAIJA

Suspected Herdsmen Kill Three People for Fresh Benue Attack

By: Esther Daniel At least three people don lose dia life while two oda people sustain injury after suspected armed herdsmen attack Elulu and Agadagba communities for Ohimini Local Government Area of Benue State. Di attacks happen separately between Friday and Saturday night, as di gunmen first invade Elulu before dem later attack Agadagba community. One resident of Agadagba, wey identify imself as Ameh, tok say di suspected herdsmen enter dia village on Saturday night to rustle cows, but some […]

todayJuly 27, 2026 13 2

Sports

Enzo Fernandez Fit Leave Chelsea? former Star Morris Tell Club Make Dem Sell Am

By: Esther Daniel Former Chelsea player, Jody Morris, don advise Chelsea make dem sell midfielder Enzo Fernandez if di player still dey push to leave di club for dis summer transfer window. According to Morris, if Fernandez no get mind to stay for Stamford Bridge, e better make Chelsea cash out now instead of waiting. Di Argentina international wey join Chelsea from Benfica for 2023 don reportedly show interest to move join Real Madrid, and e don raise questions about […]

todayJuly 27, 2026 22 2

OBODO NAIJA

Peter Obi Tell Tinubu To Come Out, Talk Directly To Nigerians

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don call on Presido Bola Tinubu to speak directly to Nigerians instead of leaving government aides and spokesmen to explain government policies. Obi yarn dis one for siddun tok on sunday say Nigerians vote for Tinubu and want hear from am, adding say di Presido don turn Aso Rock into "bunker" and no longer dey communicate with di people. Di former Anambra State governor also question […]

todayJuly 27, 2026 26 2

OBODO NAIJA

APC Chairman Yilwatda Don Reposition Party Ahead Of 2027 Election, Aide Tok

By: Esther Daniel Senior Special Assistant on Media to APC National Chairman, Yusuf Abubakar Dingyadi, don tok say Prof. Nentawe Yilwatda don reposition di ruling party to prepare for victory in di 2027 general election. Dingyadi make di statement on Sunday for Sokoto as dem mark Yilwatda first anniversary as APC National Chairman. According to am, APC don record more unity, wider support across Nigeria and stronger cooperation among party members under Yilwatda leadership. E also tok say Yilwatda focus […]

todayJuly 27, 2026 26 2

OBODO NAIJA

Female Students Raise Alarm Over “Sex-For-Marks”, Cult Activities For Kogi Poly

By: Esther Daniel Fear don grip Kogi State Polytechnic, Lokoja, after some female students raise fresh alarm over alleged sex-for-marks, cult activities and other misconduct for di school. Di students tok say since new rector resume office, some disciplinary measures wey stop some bad activities before don weak, allowing di problems to return. Di students, wey beg make dem no mention dia names because dem fear victimisation, accuse some lecturers of demanding sex or money in exchange for better grades […]

todayJuly 27, 2026 17 2

OBODO NAIJA

Peter Obi Blast Tinubu Renewed Hope Agenda, Call Am “Renewed Hopelessness”

By: Esther Daniel 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, don blast Presido Bola Tinubu Renewed Hope Agenda, describe am as "failure and renewed hopelessness." Obi tok during interview for Channels Television Sunday Politics programme say if Nigerians elect am as Presido, e go give dem real and tangible hope wey everybody go see. According to am, Tinubu policies never improve di lives of ordinary Nigerians and dem never give people confidence about di future. Obi […]

todayJuly 27, 2026 13 3

OBODO NAIJA

Babachir Lawal Say Obi-Kwankwaso Joint Ticket Fit Win 2027 Election

By: Esther Daniel Former secretary to di Gornment of di Federation, Babachir Lawal, don tok say joint presidential ticket between Peter Obi and Rabiu Kwankwaso get better chance to win di 2027 presidential election than if both of dem contest separately. Lawal make di statement during one interview wey e take assess di chances of top political leaders ahead of di next general election. According to am, if Obi and Kwankwaso join forces under one ticket, e fit give dem […]

todayJuly 27, 2026 24 3

Sports

Police Grab Suspect Wey Tif Super Falcons Players Money For Morocco Hotel

By: Esther Daniel Police don arrest one suspect wey confess say e tif cash from some Super Falcons players for Marriott Hotel, Casablanca, Morocco, few days before Nigeria first match for 2026 Women's Africa Cup of Nations. Di suspect go return all di money wey e thief, while criminal case don ready to start against am. Midfielder Esther Okoronkwo tok say she, goalkeeper Chiamaka Nnadozie, defender Michelle Alozie and captain Rasheedat Ajibade na among di players wey lose more than […]

todayJuly 27, 2026 23 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds