Blog masonry

Background

Sports

Newcastle Stand Fit With Coach Eddie Howe

Newcastle United don clear matas say dem nor dey change dia coachie, Eddie Howe, go remain head coach till end. Rumour bin dey fly say based on Newcastle poor form, say di board wan drive di Howe However, club Chief Executive, David Hopkinson, don clear di mata on Tuesday say, dem nor get any plan to change coach. Hopkinson press tuk say di club dey prepare for summer transfer window, whether dem qualify for Europe or not.

todayMarch 31, 2026 16

Sports

Senegal To Show AFCON Trophy For Home Fans, Snub CAF Decision

Senegal Football Federation tuk say dem go parade dia AFCON 2025 trophy on Tuesday for Abdoulaye Wade Stadium during friendly match against Gambia, as part of pre-match ceremony. Dem yarn dis one for official programme wey dem post, say gate go open 2pm, show start 4pm, and trophy presentation go happen by 5:45pm before kick-off 7pm. According to dem, di move na to celebrate with home fans and show say dem sti stand gidigba despite CAF decision to collect di […]

todayMarch 31, 2026 15

Sports

Germany Beat Ghana 2-1 As Undav Finish Dem Late

By: Esther Ayoola Germany don give Ghana dia second defeat for dis international break beating dem 2-1 with Deniz Undav late goal. Kai Havertz naim score first from penalty give Germany di lead. Ghana, wey lose 5-1 to Austria before, try fight but no fit stop Germany attack. Germany don win seven games straight now, and dem don win three and draw two for five matches against Black Stars now.

todayMarch 31, 2026 15 2

Sports

Quadri Aruna Face Early Exit Afta Pucar Hammer Am 3-0 for ITTF World Cup

By: Esther Ayoola Quadri Aruna dey face wahala for di ITTF World Cup as e lose 3-0 to Tomislav Pucar for him first Group 6 match for Macao on Monday. Pucar carry di win with scores 11-4, 12-10, 11-6 for dia first ever match. Like dis now, Aruna, wey be di only African wey don reach World Cup quarterfinal before, gats beat Sora Matsushima for him next match if e wan continue for di tournament. Say na Only di group […]

todayMarch 31, 2026 12 2

Sports

Victor Boniface Return Werder Bremen Afta Injury Rehab

By: Esther Ayoola Victor Boniface don return to Werder Bremen afta e finish him rehabilitation for Bayer Leverkusen. According to reports, Di 25-year-old player do surgery for January afta e wunjor for training. Originally, pipo bin dey think say e no go fit play again dis season. But with di latest development e be like, im go sti show workings before di season go end.

todayMarch 31, 2026 12

obodo oyinbo

Sweden Police Gbab 62-Year-Old Man For Sexual Assault

By: Esther Ayoola For northern Sweden, say police don charge one 62-year-old man wey be former Hell’s Angel for serious pimping, several rapes, and assault. Police tuk say im wife report am last October afta she tell dem say im dey pressure her to dey have sex with men for money, about 120 men. Authorities explain say, di man don dey do am for years to make money, forcing im wife to perform sexual acts.

todayMarch 31, 2026 12

obodo oyinbo

South Africans Protest Di Appointment Of Naija King For Dia Country

By: Esther Ayoola Say nor bi small tin for south Africa, dat Pipo for East London, South Africa dey protest di coronation of one Nigerian wey call himself king, Solomon Ezika, on Monday. Community groups and traditional leaders naim lead di wahala, wey start peaceful but later turn violent. Police tuk say dem fire rubber bullets to scatter di crowd, and say di alleged stabbing of one protester tori sef, nor dey anywia. Say na More than 10 car nai […]

todayMarch 31, 2026 26

National

ASUU Say No To FG-UK Coventry University Campus Agreement

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities (ASUU) like dis don reject Naija gornment agreement with UK to create branch of Coventry University for Naija. Im tuk dis one on Monday during public lecture wey ASUU Sa’adu Zungur University branch organize for Bauchi state. Piwuna say dem nor want any Coventry University branch for Naija because e fit spoil Nigerian university system. According to di ASUU oga, say e no fair say Nigerian students dey struggle to get […]

todayMarch 31, 2026 10

National

FCT Police Kick Off 2026 National Police Day With Big Clean-Up

By: Esther Ayoola Di Federal Capital Territory Police Command, like dis don start dia 2026 National Police Day celebrations with big cleaning exercise and free medical outreach for Abuja on Monday. Oga Commissioner of Police, Professor Ahmad Sanusi naim by imself lead di team say police nor dey fear social service. Oga Sanusi explain say di cleaning exercise na to sti show pipo of di Naija decision headquarters say, dem ready to serve dem untop policing.

todayMarch 31, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds