Blog masonry

Background

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman get heated argument after one hour for match, and Osimhen […]

todayJanuary 7, 2026 8 1

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for Aden, then dem move go Dhale, so dem launch strike […]

todayJanuary 7, 2026 7 1

National

Jonathan Put Pledge to Join PDP Fight for 2027 Election

By Ebi Oboko Wi Former Presido, Goodluck Jonathan don knack hand for chest say e go dey more active for Peoples Democratic Party matter for 2027 election. Na PDP National Chairman, Tanimu Turaki (SAN) share dis update after private meeting with di  former presido on tuesday. Turaki waka go Jonathan Maitama office with all National Working Committee, some former governors, party founding fathers, and few selected state chairmo say dem dey find support and guidance.

todayJanuary 7, 2026 19 5

Lagos

Governor Sanwo-Olu Ginger Lagos Storytellers to Do More

By Ebi Oboko Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy. The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move Us,” wey hold for Wole Soyinka Centre, Iganmu, Lagos. Sanwo-Olu […]

todayJanuary 7, 2026 10 2

National

IGP Egbetokun Move DIG Gumel, 17 CPs Go Key Police Posts

By: Rilwan Agbomeji Inspector-General of Police, Olukayode Egbetokun, don deploy Deputy Inspector-General of Police Mohammed Usaini Gumel and 17 Commissioners of Police, suk dem for various departments, commands, and formations for inside di obodo Nigeria. According to di Force tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, di deployment na to make police work stronger, improve leadership, protect people well, and give beta service. Under di new arrangement, DIG Gumel go head di Force Intelligence Department (FID), CP Aina Adesola go Delta, CP Umar […]

todayJanuary 6, 2026 10 4

Sports

West Ham Striker Callum Wilson Open Touchlight Dey Find New Club

By: Esther Ayoola West Ham striker Callum Wilson don near agreement to end im contract early. Sources confamate say tuks don almost finish. Di 33-year-old join di club last summer for free and don score four goals in 18 games. New strikers Pablo Felipe and Taty Castellanos mean him chances to play first team go reduce.

todayJanuary 6, 2026 9

obodo oyinbo

UN Clear US Say Wetin Dem Do Venezuela President Break International Law

By: Esther Ayoola United Nations confamate marra say US air strikes for Venezuela and di way dem carry President Nicolas Maduro comot, say e break international law. U.N tuk say no country suppose use force or threaten another country sovereignty, and dem dey call world leaders make dem speak with one voice. US commando and military force carry Maduro and im wife go America, where e appear for New York court and say dem kidnap am. America and EU accuse […]

todayJanuary 6, 2026 13

National

Rivers APC Senoir Man Back National Secretary

By: Esther Ayoola One senior man for  APC, Rivers State branch, Darlington Nwauju,  don support wetin APC National Secretary, Ajibola Basiru talk say non-members no get right to interfere for party matter. Nwauju yarn dis one on Tuesday while e dey talk for Channels Television Morning Brief programme. According to am, Basiru don clearly talk say people wey no be APC members no suppose dey tell party how dem go run affairs for Rivers State. E add say im group […]

todayJanuary 6, 2026 11 4

National

Makinde Mourn Sarkin Hausawa Of Ibadan

By: Esther Ayoola Govnor of Oyo State, Seyi Makinde, don touchlight marra unto di death of Sarkin Hausawa of Ibadanland, Alhaji Ali Zungeru, say na big loss. For statement wey im aide release for Ibadan, Makinde describe Zungeru as man of peace and strong community leader. Im still condoled with Olubadan of Ibadanland, Oba Rashidi Ladoja, Hausa community for Oyo State, and Zungeru family, say di late Sarkin always stand for peace and development. Di Govo pray make God grant […]

todayJanuary 6, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app