Blog masonry

Background

Lagos

LASRERA Seal Ikorodu Office of Fake Real Estate Agent

By: Esther Ayoola Di Lagos State Real Estate Regulatory Authority (LASRERA) tuk say dem seal di office of some fake real estate agent for Ikorodu on Wednesday. Dem accuse di company of pretending to be licensed realtor and dey use fake registration number. Untop yarnings with newsmen, Special Adviser to di Governor on Housing, Barakat Odunuga-Bakare, say dem dey do dis to protect residents from fraud and restore trust for property business. Say LASRERA do di operation together with State […]

todayMarch 19, 2026 12

National

Oyo Police Re-Catch Suspected Kidnapper Weh Escape Custody

By: Esther Ayoola Oyo State Police Command don re-arrest one suspected kidnapper wey escape from police hand before. According to police tuk tuk, DSP Ayanlade Olayinka on Wednesday, di Police catch di man, Ayomide Kareem, 25 from Osorun’s Compound, Oyo, for Irepo Junction, Ojongbodu, around  during one routine stop-and-search patrol. Dem stop am because e dey waka suspicious, and wia dem con see say  na di same person wey escape from Jobele Division custody on March 10 over suspected kidnapping […]

todayMarch 19, 2026 13

National

VP Shettima Vow Say FG Go Crush Terrorists, Visit Maiduguri Bomb Blast Victims

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don tuk say Federal Government go make sure say dem defeat terrorism, and anybody wey dey behind recent attacks go face serious action. E tuk say apart from order wey president don give security chiefs, government dey put more money for equipment and logistics to strengthen di fight against terrorism. Shettima yarn dis one for Maiduguri when e go visit people wey bomb blast injure for University of Maiduguri Teaching Hospital where dem […]

todayMarch 19, 2026 10

National

CDS Oluyede Insists Say Borno, Yobe Pipo Must Join Fight Against Boko Haram

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, on Wednesday for Maiduguri Say na some residents for Borno and Yobe dey support insurgents, say if not, why dem nor dey share informate with security. Di Army chief  yarn dis one afta one four-hour security meeting wey include Army Chief Waidi Shuaibu and Operation Hadin Kai commander Abdulsalam Abubakar, as dem review how Boko Haram and ISWAP sti dey operate. According to am, on new plans, na to do collabo […]

todayMarch 19, 2026 9

National

Police Pay N2.4B Insurance Money To Officers, Families

By: Esther Ayoola Say di Naija Police don pay over N2.4 billion insurance money to 1,075 officers and pipo wey lose dia life on duty, under di Group Life Assurance plus IGP Family Welfare Schemes. Di Inspector-General of Police, Olatunji Disu, ni give di cheque to families on Wednesday for Force Headquarters, Abuja. Dat di money cover different years, including 2018 reach 2026, plus some old once wey dem never pay before.

todayMarch 19, 2026 13

National

Labour Party Faction Fix May Dates For Primaries

By: Esther Ayoola Nenadi Usman-led faction of Labour Party say dem go conduct presidential primary election on May 23, 2026 ahead of 2027 general elections. Dem make dis one afta dia National Executive Council meeting, where dem also fix May 15, 2026 for governorship, National Assembly and State Assembly primaries. According to dem, dem put di dates to ensure better planning and smooth process.

todayMarch 19, 2026 6

National

Court Fine EFCC N500k For Always Delaying Emefiele Trial

By: Esther Ayoola Justice Hamza Muazu for Federal High Court, Abuja don fine EFCC N500,000 based on say dem ask for adjournments for di trial of former CBN Governor, Godwin Emefiele. Dem tell di EFCC on Wednesday to call dia last witness, and pay di  fine to Emefiele. Nor be amebo say, EFCC dey prosecute Emefiele for 20-count charge wey include criminal breach of trust, forgery, and collecting money by false pretence. EFCC tuk say Emefiele collect $6.23 million wey […]

todayMarch 19, 2026 12

obodo oyinbo

US Intelligence Clear Iran Say Dem Nor Rebuild Nuclear Weapon After US-Israel Attack

By: Esther Ayoola US intelligence don shake table say Iran nor even rebuild dia nuclear machine wey US and Israel destroy last June 2025. Trump ally and US national intelligence director, Tulsi Gabbard, na tuk dis one for her written testimony to Senate intelligence committee on Wednesday for Washington, DC. She explain say afta Operation Midnight Hammer, Iran nuclear plan end and dat Iran nor do any rebuild, reason wey President Trump take dey bomb Iran. U sabi say, Trump […]

todayMarch 19, 2026 9

obodo oyinbo

Saudi Arabia Clear Iran Say Dem No Go Tolerate Anymore Attack

By: Esther Ayoola Saudi Arabia Foreign Minister Prince Faisal bin Farhan Al Saud don warn Iran on Thursday, for Riyadh say dem no go dey tolerate any more attacks for Saudi Arabia and neighbouring Gulf states. Im yan dis give tori pipo for di Saudi capital, dat Iran don dey attack dem since dem keep quiet nor mean say Saudi Arabia nor get power, dat dem get strong military power, if dem choose to respond. Prince Faisal explain say dem […]

todayMarch 19, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds