Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Makinde Say No Panic As PDP Governors Dey Jump Ship

Oyo State Govo, Seyi Makinde say e no shake am say governors dey leave PDP, even though di party now get only two governors left. Zamfara Govo, Dauda Lawal announce on Monday say e don dump di party, leaving Makinde and Bauchi Governor Bala Mohammed as di only PDP governors. Makinde tuk dis one for PDP Board of Trustees meeting for Abuja, say di period na tough time for di party and for democracy for Nigeria. For di BOT chairmo […]

todayMarch 11, 2026 12

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Order 100,000 CNG Kits To Make Transport Cheap

Wi oga Presido Bola Tinubu don wire message say make dem deploy 100,000 CNG conversion kits for next two to three weeks as option to di hike of petrol price. Dis one dey come after meeting for State House, Abuja with Ismaeel Ahmed, Chairmo of Pi-CNG. Say, Tinubu wan make CNG dey everywia, so dat transport go cheap for Nigerians.  

todayMarch 11, 2026 13

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Send FCT 2026 Budget

Presido Bola Tinubu don send 2026 Federal Capital Territory budget go Senate make dem approve am on Tuesday. Im still ask Senate make dem confirm Taiwo Oyedele as Minister of State for Finance to replace Dr Doris Uzoka-Anite. Baba also want make Senate approve Magnus Abe as chairman of Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission. Senate Presido Godswill Akpabio na im sha read all di letters for Senate floor during plenary, straight up for everybody to understand di presido moves.

todayMarch 11, 2026 20

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Say Nigeria Don Overcome Economic Wahala

Wi oga Presido, Bola Tinubu  say Nigeria don overcome all di economic wahala under im gornment. Im yan dis one  for Presidential Villa, Abuja, when im  host religious and traditional leaders for interfaith breaking of fast. Say like dis, state govos no dey run go bank again to take loan to pay workers salary, say, indeed all im reforms dey work wella.

todayMarch 11, 2026 12

OBODO NAIJA

Ondo Governor Warn Kidnappers And Dia Sponsors

Ondo state govo, Governor Lucky Aiyedatiwa don sama warning  say any pesin wey dey sponsor terrorism or kidnapping wey dem go catch go face prosecution. Im tuk dis one wen e meet leaders of Miyetti Allah Cattle Breeders Association of Nigeria (MACBAN) for im office for Akure, Ondo State. Aiyedatiwa still say e dey worry am say one community don get three kidnapping cases for just two months, and dats why dem dey  move agbag di jaguda boys.

todayMarch 11, 2026 9

Lagos

How LASEMA Take Save Lives For Ogba School Building Collapse

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don tell residents not to fear after one four-storey building collapse for Ogba. Say dia quick action save plenty students and workers for one Comprehensive College, wey dey 11 Adudatu Street. According to report, dem see school bags, computers, and oda tins scatter for ground, plus two cars wey dey trapped under rubble. LASEMA say dem monitor di building early an even send  warning, and na why nobody loss im life for di collapse.

todayMarch 11, 2026 15

Lagos

Lagos Assembly Agree To Committee Report On Makoko, River Community  Demolitions

Lagos State House of Assembly  don accept di sugestion wey dia Committee on Rules and Business give about di demolitions wey hapun for Makoko, an oda areas. Chairmo of di Committee, Hon. Noheem Adams,  say di demolitions don displace plenty people, including elderly, sick, women, and children, and destroy their homes and properties. Im explain say di Committee come to dis conclusion after five meetings with di affected people and government officials, plus an oversight visit, based on say di […]

todayMarch 11, 2026 12

Lagos

Lagos Speaker Obasa Receive Appointment From Commonwealth

Speaker of di Lagos State House of Assembly,  Mudashiru Ajayi Obasa, don get appointment as Sub-National Representative for di Commonwealth Parliamentary Association African Executive Committee. Clerk of di House, Barr. Olalekan Onafeko,  na im read di letter on di floor of di Assembly in Lagos on tuesday, officially notifying lawmakers say Obasa go serve from 2026 reach 2029. Di letter tuk say Obasa go start im tenure by attending di 90th Executive Committee wey go hold for Swakopmund, Namibia, to […]

todayMarch 11, 2026 17

Lagos

Lagos Govo Sanwo-Olu Unveil IBILE Youth Ambassadors

Lagos State Gornment don promise say dem go still dey support youth leadership, community development and civic engagement for di state. Oga Govo, Babajide Sanwo-Olu tuk dis one Tuesday when dem unveil IBILE Youth Academy State and Divisional Ambassadors for Lagos House, Ikeja. Fifty youths show for di event, six of dem come from Ikeja, Badagry, Ikorodu, Lagos Island and Epe, and one go be State Youth Ambassador. Sanwo-Olu  sti press mata say, aside di leaders  dem get special plan […]

todayMarch 11, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds