By Oluwatosin Ibrahim
America and Iran don share some goodies, bomb diaself for di second day straight on Thursday scarra di Strait of Hormuz.
U sabi say, US Presido, Donald Trump, bin complain on Wednesday, say Iran nor dey hear English, dat when dem ready tuk peace, dem go calm down.
According to di US military, dem hit about 90 military targets, including di store wey Iran dey keep dia missile and drone, makachukwu, Iran don finish na
Iran sef no waste time, as dem sharpaly wrap bomb inside bitter leaf, giv US military base for Arifjan and Ali Al Salem inside Kuwait, as well as Juffair and Sheikh Isa inside Bahrain.