Blog masonry

Background

National

NiMET Share Update Say Haze, Sun And Thunder Go Hit Nigeria This Week

By: Esther Ayoola Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don yarn say from Wednesday reach Friday, plenty haze and sunshine go dey across Nigeria. NiMet tuk dis on Tuesday for Abuja. For north, sky go dey sunny and hazy every day, while for south, sky go dey sunny with small clouds. NIMet also tuk say small chances of thunderstorm and light rain fit happen for Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom, and Cross River later for di day. Dem explain say dis kain […]

todayJanuary 7, 2026 1

National

FG Sukili N1.98tn For Electricity Subsidy

By: Esther Ayoola Based on wetin di Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) report tuk, di Federal Government don spend N1.98tn for electricity subsidy from October 2024 reach September 2025. For di fourth quarter of 2024, dem spend N471.69bn, first quarter of 2025 na N536.4bn, second quarter N514.35bn, and third quarter N458.75bn. NERC tuk say dis subsidy na because electricity tariffs never reach cost-reflective level, so gornment gatz cover di gap. Dem still warn say if tariffs no balance, government go […]

todayJanuary 7, 2026 1

Lagos

Lagos Taskforce Arrest 32 ‘Omotaku’ Weh Dey Block Roads

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest 32 street children wey dem dey call Omotaku, say dem dey cause wahala for area, dey block road across Island and Mainland, for areas like Apongbon, Fadeyi, Jibowu, Yaba, Lagos Island, Ojuelegba, and Surulere, According to Taskforce tuk, tuk yarnings on Tuesday, Raheem Gbadeyan, dem catch di children because dem dey stop trucks, tankers, and private cars anyhow, dey smoke hard drugs, and dey disturb people. Say, di operation hapun as part […]

todayJanuary 7, 2026 7

Lagos

Family Set Jan 14 Burial Date to Bury Three Broders Wey Kpai for the GNI Fire

By Ebi Oboko Unto updates for lagos fire accident marras, say three Omatu brothers wey kpai for di fire wey burn Great Nigeria Insurance House for Lagos Island, say dem go bury dem on January 14. Na As dem sister, Mimi Nonyerem, tuk dis week, dem go do service of songs on January 7, while burial go happen on January 14. U sabi say, Di fire start from fourth floor come spread reach sixth floor before e take over di […]

todayJanuary 7, 2026 4 1

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman get heated argument after one hour for match, and Osimhen […]

todayJanuary 7, 2026 5 1

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for Aden, then dem move go Dhale, so dem launch strike […]

todayJanuary 7, 2026 4 1

National

Jonathan Put Pledge to Join PDP Fight for 2027 Election

By Ebi Oboko Wi Former Presido, Goodluck Jonathan don knack hand for chest say e go dey more active for Peoples Democratic Party matter for 2027 election. Na PDP National Chairman, Tanimu Turaki (SAN) share dis update after private meeting with di  former presido on tuesday. Turaki waka go Jonathan Maitama office with all National Working Committee, some former governors, party founding fathers, and few selected state chairmo say dem dey find support and guidance.

todayJanuary 7, 2026 10 5

Lagos

Governor Sanwo-Olu Ginger Lagos Storytellers to Do More

By Ebi Oboko Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy. The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move Us,” wey hold for Wole Soyinka Centre, Iganmu, Lagos. Sanwo-Olu […]

todayJanuary 7, 2026 5 2

National

IGP Egbetokun Move DIG Gumel, 17 CPs Go Key Police Posts

By: Rilwan Agbomeji Inspector-General of Police, Olukayode Egbetokun, don deploy Deputy Inspector-General of Police Mohammed Usaini Gumel and 17 Commissioners of Police, suk dem for various departments, commands, and formations for inside di obodo Nigeria. According to di Force tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, di deployment na to make police work stronger, improve leadership, protect people well, and give beta service. Under di new arrangement, DIG Gumel go head di Force Intelligence Department (FID), CP Aina Adesola go Delta, CP Umar […]

todayJanuary 6, 2026 5 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app