Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Senate Release Billions to Boost Police Work Across Nigeria

By Oluwatosin Ibrahim Wi Nigeria Senate don approve total of ₦403.1 billion for Nigeria Police Trust Fund, with ₦170.1 billion for 2025 budget and ₦233 billion for 2026 budget say make wi niaja police take do beta ordechi work for across di country. According to report, dis money go cover workers salary, capital projects and running cost to improve di operational capacity of di Nigeria Police Force. Lawmakers tok say di fund go help provide better equipment, training, infrastructure and […]

todayJuly 9, 2026 13 4

OBODO NAIJA

Senator Oshiomhole porporlly matas say State Police na di way to go for Nigeria

By Oluwatosin Ibrahim Former Edo State Govo and Senator, Adams Oshiomhole, don scata table oh, say bad belle pipo wey dey fight against state police dem nor wise and dat state police na di way to go for Nigeria. Im yarn dis one on Thursday, for one TV town Hall meeting, wia im tuk im mind dat, normally dat Nigerians suppose to dey celebrate Wi oga Presido for creating state police. Oshiobaba explain dat gofners nor too get power if […]

todayJuly 9, 2026 16 2

OBODO NAIJA

Mulade Call for Envirnomental Emergency as Oil Spill Dey Affect Delta Communities

Chief (Comrade) Mulade Sheriff, one environmental rights and peace advocate from Delta State, don urge di Federal Government, Delta State Government and all relevant regulatory agencies to sharpaly declare environmental emergency over one major oil spill wey allegedly don affect many host communities for Warri South-West and Burutu Local Government Areas of Delta State. For one statement wey e release on Wednesday, Mulade describe di incident as serious environmental disaster wey fit cause long-lasting damage to di environment if authorities […]

todayJuly 9, 2026 23 4

OBODO NAIJA

AIG Beg Youths to joinbodi with Police to ensure Peaceful 2027 Election

By Oluwatosin Ibrahim Assistant Inspector-General of Police for Zone 2 Command, Olohundare Jimoh, don ginger area boys say make dem join force with police and other security agencies to fight election badness. According to am, as 2027 general election dey come, young people get big role to play by promoting peace, avoiding fake news and taking part in di election without violence. Jimoh say good policing no fit work without the support of di community, schools, organisations and youths.

todayJuly 9, 2026 10

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 13

OBODO NAIJA

Federal Gornment explain how dem wan use ₦30 Trillion Boost Naija Economy

By Oluwatosin Ibrahim Wi Federal Gornment dey rake oh say dem don put beta doings in place to package naija mining sector, grow am reach ₦30 trillion before year 2030. Senior woman Seco of the Solid Minerals Development Fund (SMDF), Fatima Shinkafi, na yarn dis one during one lecture wey hapun for University of Lagos. Gornment say the reforms wey dem dey do for the sector don already dey bring beta investors, and plenty money like dey enter Federal gornment […]

todayJuly 9, 2026 12

Sports

Adeyemi pick Barca, tell Dortmund say im wan comot  

By Oluwatosin Ibrahim Barcelona don submit official bid to Borussia Dortmund for winger Karim Adeyemi. According to transfer news tatafos,  Fabrizio Romano and Gerard Romero for  X (twitter) on Thursday say tuks between both clubs still dey go on but  Adeyemi don already show interest to join Barça.   According to am, Karim Adeyemi don agree personal terms with Barcelona and he don tell Dortmund say na only Barça e wan join.  

todayJuly 9, 2026 17 6

obodo oyinbo

US And Iran Exchange Bomb scarra strait of Hormuz

By Oluwatosin Ibrahim America and Iran don share some goodies, bomb  diaself for di second day straight on Thursday scarra  di Strait of Hormuz. U sabi say, US Presido, Donald Trump, bin complain on Wednesday, say Iran nor dey hear English, dat when dem ready tuk peace, dem go calm down. According to di US military, dem hit about 90 military targets, including di store wey Iran dey keep dia missile and drone, makachukwu, Iran don finish na Iran sef […]

todayJuly 9, 2026 10

OBODO NAIJA

APC answer Peter Obi Alarm, say no level for di 2027 election

By Oluwatosin Ibrahim Nor be small tin for naija politics, as APC and opposition parties dey get am  hot, hot say, di 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, raise alarm, say im life fit dey danger.   Di All Progressives Congress through dia  National Seco, Senator Ajibola Basiru sharpaly dismiss di claim,say,  no level, and dat na fear dey do di NDC, and Obidient Movement Worldwide. Wetin concern one faction of PDP, nor body know, […]

todayJuly 9, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds