Blog masonry

Background

National

National Assembly Go Translate Laws Into Igbo Hausa Yoruba

By: Kofoworola Olayinka National Assembly Library Trust Fund say dem go soon translate Naija laws into Igbo, Hausa, Yoruba and other local languages to make legislative information easier for Naija pipu to understand. Executive Secretary of di Fund, Henry Nwawuba, yarn dis on Monday for Abuja during di 2026 National Assembly Library Week. Nwawuba say dem also dey upgrade di e-library and develop mobile app plus Bills Tracker wey go allow pipu follow bills as dem dey move through di […]

todaySeptember 29, 2026 10

Sports

Iwobi Go Captain Super Eagles Against Guinea Bissau

By: Kofoworola Olayinka Fulham midfielder Alex Iwobi go captain Super Eagles tonight for dia 2027 AFCON qualifier against Guinea Bissau. Regular captain Wilfred Ndidi go start di match from bench, as Iwobi lead di midfield. Iwobi, wey don make 102 appearances for Nigeria, go hope say e fit help di team build on dia 2-1 win over Madagascar for dia first qualifier Iwobi go dey lead one reorganised midfield as Super Eagles dey look for another three points wey go […]

todaySeptember 29, 2026 10

Business

Minister Say Naija Get 26 Minerals Wey US Dey Find

By: Kofoworola Olayinka Industry, Trade and Investment Minister Jumoke Oduwole say Naija get about 26 out of 60 critical minerals wey United States dey look for around di world. Oduwole tuk dis during interview, say di recent US critical minerals agreement na MOU and e no legally bind both countries. She say Naija  no go export di minerals raw, as gofment dey work with US to develop local processing, battery manufacturing and other value chains. Di minister assure Nigerians say […]

todaySeptember 29, 2026 19

National

NYSC Mourns Former DG Colonel Obasa

By: Kofoworola Olayinka National Youth Service Corps[ NYSC] don mourn former Director-General, Colonel Peter Kolawole Obasa, wey kpai on Monday, September 28, 2026. During condolence visit to di family for Ilorin, di current NYSC DG, Brigadier General Olakunle Nafiu, describe Obasa as one of di pipo wey build strong foundation for di scheme. Obasa serve as di third NYSC Chief Executive from 1979 to 1984, with General Nafiu saying di scheme go continue to build on di legacy wey im […]

todaySeptember 29, 2026 10

obodo oyinbo

Iran Say Make Ceasefire Happen Before Hormuz Open

By: Kofoworola Olayinka Iran Foreign Minister Abbas Araghchi say Qatar dey hope say dem go reach agreement by tomorrow to reopen di Strait of Hormuz. Araghchi say Iran don give conditions for reopening di waterway, including seven-day ceasefire across di Middle East. Di Strait of Hormuz dey carry about one-fifth of global oil and liquefied natural gas, making di blockade a major concern for global energy supply. Iran impose di blockade after US and Israel strike di country, while America […]

todaySeptember 29, 2026 7

Sports

FIFA Accuse UEFA of Misinformation Over World Cup Deal

By: Kofoworola Olayinka FIFA don accuse UEFA of running misinformation campaign as UEFA dey try force FIFA release documents about Gianni Infantino plan to sell part of World Cup business. For court case for Florida, FIFA tuk say UEFA attempt to get di documents fit also be move to influence next year FIFA presidential election. Infantino proposal for July to create commercial company wey private investors fit buy stake inside cause serious backlash, and FIFA later shelve di plan. FIFA […]

todaySeptember 29, 2026 10

OBODO NAIJA

Obi Promise To Bring Back Fuel Subsidy If E Win 2027 Election

By: Mariam Ajayi Presidential candidate of Nigeria Democratic Congress, Peter Obi, don promise say if Nigerians elect am for 2027, e go bring back petroleum subsidy, while e go first tackle corruption for di country. Obi make di statement for town hall meeting for Sokoto, where e say corruption na major problem wey dey affect Naija. E also promise say e go focus on security, education and development, including connecting all state capitals by railway to boost economic activities. NDC […]

todaySeptember 29, 2026 9

OBODO NAIJA

Police Recover 28 Human Skulls, Bones From Camps For Abia

By: Mariam Ajayi Police for Abia State don recover 28 human skulls and different human bones from some camps for di state during security operation. Authorities say di recovery happun as security operatives dey raid di camps, while investigation dey continue to find out how di human remains take dey there. Police also dey work to identify di remains and establish di circumstances surrounding di discovery.

todaySeptember 29, 2026 8

Sports

Mancini Explain Why Man City Problem Nor Be Him Palava

By: Mariam Ajayi Former Man City manager Roberto Mancini wash hin hands clean from di double contract scandal, say, na di club headache and not him own business. Premier League bin hammer City with over 100 charges, including say dem hide accurate money details for players and managers during Mancini time from 2009 to 2018. When reporters corner di current Italy coach during press conference before dia game with Turkey, e use style yarn say Found guilty of what? and […]

todaySeptember 29, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds