Blog masonry

Background

Politics

Wike Claim Say Adeleke Join Tinubu Camp Ahead 2027

FCT Minister, Nyesom Wike, don drop another political bombshell, say Osun State Govo, Ademola Adeleke, na member of im political camp and dem all dey support Presido Bola Ahmed Tinubu. Wike talk dis one for Abuja on Friday, as political realignment dey gather momentum ahead of 2027. He say more politicians and groups still dey prepare to join Tinubu camp, while he dismiss claims by some ADC members say dem get credit for Adeleke victory.

todayAugust 21, 2026 14

Politics

INEC Set January 16 For 2027 Presidential Election

INEC don confirm say Presidential and National Assembly election go hold January 16, 2027, while Governorship and State Assembly election go follow on February 6. INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, say di Commission dey prepare well to make voting smooth, secure and transparent. He point to di recent Osun election as example of wetin INEC fit achieve, with most polling units opening on time and BVAS working well. INEC also plan to deploy about 1.4 million ad-hoc workers across more […]

todayAugust 21, 2026 11

Sports

Arsenal Sign Konsa To Boost Defence After Saliba Wunjury

Arsenal don sign England defender Ezri Konsa from Aston Villa to strengthen dia defence after William Saliba suffer back injury. Konsa fit make im Arsenal debut against im former club, Aston Villa, on August 31. Di defender say e happy to join Arsenal and hungry to win trophies with di club. Arsenal sporting director Andrea Berta describe Konsa as a quality defender with strength, calmness and good tactical understanding.

todayAugust 21, 2026 12

Politics

Tinubu Knock Atiku Over Plan To Bring Back Fuel Subsidy

By: Kofoworola Olayinka Presido Bola Tinubu don criticise former Vice Presido, Atiku Abubakar over im plan to bring back fuel subsidy if e win di 2027 presidential election. Tinubu talk dis one on Thursday for State House, Abuja, saying Atiku plan show say e no understand gofnance and economy well. Di President say before fuel subsidy comot, 27 states no fit pay worker salary and gofrnors dey come Abuja dey ask for bailout.

todayAugust 21, 2026 13

Politics

Benue Assembly Wan Suspend Kwande Chairman For 3 Month

By: Kofoworola Olayinka Di Benue State House of Assembly don recommend three-month suspension for Kwande LGA Chairman, Vitalis Neji, over allege gross misconduct and abuse of office. Di recommendation come after an ad hoc committee investigate di tuk against am. Di committee chairman, Peter Ipusu, say Neji appear before dem but e no fit properly defend himself against di allegations.

todayAugust 21, 2026 10

obodo oyinbo

DR Congo Get 70,000 Ebola Vaccine Doses To Fight Outbreak

By: Kofoworola Olayinka Di International Coordinating Group don release 70,000 dose of Ervebo vaccine to Democratic Republic of Congo to help fight Ebola outbreak. 50,000 dose go reach health worker, while 20,000 go dey used for clinical trial to check whether di vaccine fit protect people against Bundibugyo virus. WHO and Africa CDC say dem never confirm whether di vaccine fit protect humans against di virus, although early tests show say e fit provide some protection.

todayAugust 21, 2026 6

south east

Two Die As Road Crash Happen For Anambra

By: Kofoworola Olayinka Two people don die while two others sustain injury for road crash wey happen opposite Jezco Filling Station along Awka-Enugu Expressway for Anambra State. Di crash happen late Thursday and e cause serious traffic jam for di road, as di vehicles block large part of di expressway. Eyewitnesses say four adult men dey inside di two commercial vehicles when di accident happen. Two die for di spot, while two others sustain different levels of injury.

todayAugust 21, 2026 11

crime

EFCC Don Withdraw Cybercrime Case Against BUK Student

By: Kofoworola Olayinka Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don withdraw di cybercrime charge against final-year Bayero University student, Maryam Shehu, and another Nigerian, Abubakar Abdulhamad. Di two of dem face separate case for Federal High Court for Abuja on Thursday over alleged cybercrime and spreading bad information about EFCC. EFCC accuse Maryam of making social media post wey allege say some EFCC pipu beat one man and collect N20 million bribe.

todayAugust 21, 2026 12

Sports

Fury Say Fight With AJ Fit Scatter Over Money Matter

By: Kofoworola Olayinka Fight between Tyson Fury and Anthony Joshua never officially confirm yet, as money matter don dey cause problem for di proposed fight. Fury, 38, say negotiation don stall because Eddie Hearn and im team dey demand more money. Fury talk dis one for video while e dey exercise, saying di financial disagreement fit stop di fight from happening.

todayAugust 21, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds