Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Tinubu Reforms Dey Make Airfares Come Down

By: Mariam Ajayi Minister of Aviation and Aerospace Development, Festus Keyamo, say Tinubu reforms for aviation sector don make airfares come down. E tuk say  dis move don attract new airlines plus aircraft enter Nigeria market. Keyamo talk this for Abuja as Naija aviation market now rank fourth-largest for Africa, with more than 18.8 million domestic and international passengers recorded for 2025. FAAN say di figure represent 11.9 per cent increase compared with di previous year, as more airlines and […]

todaySeptember 23, 2026 13 14

Lagos

Suspected Cultists Kpai One Man For Ikorodu

By: Mariam Ajayi Suspected cultists allegedly , don go kpai persin, wey name na  Tosin.  after dem rob am for Egbin area of Ijede, Ikorodu, on Tuesday, September 15. Tosin reportedly, just  travel from Ondo State come attend one event for the community, as im just comot di party go one side na dis badness hapun. According to  source say some Jagudas  allegedly attack am, collect im gold chains, mobile phones and other belongings, before dem con kpai  am. As […]

todaySeptember 23, 2026 14

obodo oyinbo

Iran Oga Dem Dust Dia Shoe, Waka Comot For UNGA

By: Rilwan Agbomeji Iran officials and members of dia delegation don waka comot out of di UN General Assembly, as dem reject US Presido, Donald Trump’s threat to destroy Iran if Tehran no agree deal with Washington. Trump make di threat during im speech for di 81st UN General Assembly for New York, where e defend di US military campaign against Iran and warn say e fit escalate di conflict. E also say Cuba communist government dey fail and “go […]

todaySeptember 23, 2026 17

OBODO NAIJA

Federal Gornment Nor Give Me 50 Billion Naira – Seyi Makinde

Oyo State Govo, Seyi Makinde don accuse Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike say he dey drop banga. Makinde tok dis one on Tuesday for Makinde/Daura 2027 Presidential Town Hall meeting for Katsina, say Oyo State Gornment no receive any N50bn from di Federal Gornment, say na di state gornment use dia money take upgrade di Ladoke Akintola International Airport for Ibadan. Remember say, Wike do interview with tori pipo on Monday and na there he make di claim say […]

todaySeptember 23, 2026 16

obodo oyinbo

Iran Cancel Flights To Iraq And Oman

Iran don cancel flight go Baghdad for Iraq and Muscat for Oman from midnight on Tuesday, just hours before US  punishment against Iran go start. Tok tok pesin for Iran civil aviation tell media tok tok pipo say Baghdad and Muscat airports no go accept Iran flight again, but flight to other area like Istanbul go continue normal  normal. Iran flight oga dem dey follow Iraq yarn to move Baghdad flight to Najaf, where many Iranian worshipers dey travel go, […]

todaySeptember 23, 2026 29

Sports

Mbappe Miss Training As Sickness Worry Am

France captain Kylian Mbappe miss training on Tuesday after sickness wey resemble flu catch am, double mind don dey weda e go play di coming Nations League games. Di Real Madrid player remain for France training camp as new coach Zinedine Zidane dey train di rest of di squad. French Football Federation konfamate say Mbappe nor come because of di sickness, but dem never talk when e go come back. France go monitor im condition before dem decide weda e […]

todaySeptember 23, 2026 12

Sports

20 Super Eagles Players Don Reach Camp For AFCON Qualifiers

Twenty Super Eagles players don reach camp for Ikot Ekpene ahead of dia 2027 AFCON qualifying matches against Madagascar and Guinea-Bissau. Di team open camp on Monday for Four Points by Sheraton Hotel, Ikot Ekpene, with coach Éric Chelle, im assistants and other backroom staff among di first people wey arrive. Captain Wilfred Ndidi, Samuel Chukwueze and goalkeeper Stanley Nwabali dey expected to join di team later today, while dem go hold dia first training for Godswill Akpabio International Stadium, […]

todaySeptember 22, 2026 17

obodo oyinbo

Gunman Open Fire For Turkey School, Wunjure 11 Pipu

One Gunman open fire outside one high school for Manisa, western Turkey, on Tuesday morning, as 11 pipu wunjure and two of dem dey critical condition. Police don gbab one 15-year-old boy wey dem suspect say na im shoot, while dem also hold im parents and granpapa, wey dem say get di gun. Di shooting happen outside di school before di suspect run comot from di place. Dis one na di third school shooting for Turkey dis year, as authorities […]

todaySeptember 22, 2026 14

OBODO NAIJA

FG Give Committee Free Hand To Torch Light Di Death Of 37 Pipu For Niger

Federal Gornment don give di 10-pipu committee full hand to touchlight how 37 pipu wey Nigerian Security and Civil Defence Corps gbab for Niger State take kpai on Thursday, September 17. Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, tok dis one for Abuja on Tuesday, September 22, saying di committee fit bring experts, check documents and facilities, visit places connected to di matter. E say di committee fit also ask members of di public for information, and interview anybody wey fit help dem […]

todaySeptember 22, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds