Blog masonry

Background

National

Governor Sule Insist Dat Law Go Decide Rivers Governor Impeachment

By: Esther Ayoola Nasarawa State Govo, Abdullahi Sule, say govos wey dem elect under All Progressives Congress (APC) no dey worry bodi about di impeachment wey involve Rivers State Govo, Siminalayi Fubara. Govo Sule tuk for TV sit don tuk, say, di mata don already dey court. E explain dat, di impeachment process dey follow law and due process and dat APC govos nor get any hand inside.

todayJanuary 30, 2026 13

National

Senate Form 7-Man Committee To Arrange Views On Electoral Act Bill

By: Esther Ayoola Wi Senate don form one seven-man committee to gather and arrange all lawmakers’ views on dabiiii Electoral Act Amendment Bill, 2026. According to report, di committee, wey include Senators Adamu Aliero, Aminu Tambuwal, Adams Oshiomhole, Danjuma Goje, Tony Nwoye, and Titus Zam, go submit one final report to Senate by next Tuesday. Di decision  dey drop afta  more than two hours of Senate discussion of di bill for closed-door session. Say, Senate dey take dis step to […]

todayJanuary 30, 2026 13

National

President Tinubu Drop SMS For Nigerians To Dey United, Courageous

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu in honour of late Chief Samuel Akintola, don drop advice for Nigerians, to always dey courageous, and avoid bitterness and division. Baba Seyi deliver dis message through di Secretary to di Government of di Federation (SGF), Senator George Akume,  wey go represent am,  for di 2026 Samuel Akintola Memorial Lecture wey shelle for University of Ibadan. Tinubu tuk for di lecture wey dem title “Unity in Diversity: Lessons from Chief Ladoke […]

todayJanuary 30, 2026 20

National

Govo Aiyedatiwa Share Plans For Joinbodi Development

By: Esther Ayoola Ondo State gorment and dia mehn don dey clear field to celebrate di state 50th anniversary, as Governor Lucky Aiyedatiwa declare pipo cantered development plan. Na for TV sit don tuk for Akure, di govo drop updates about di state Golden Jubilee, dat, dem dey spend money for key projects. Baba Aiyedatiwa say, Ondo gornment dey invest for important things like roads and buildings, town renewal, healthcare, schools, and agriculture.

todayJanuary 30, 2026 12

National

First Lady Remi Tinubu Charge Youths As Dem Launch Dream Centre For OAU

By: Esther Ayoola Wife of wi oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don tell Nigerian youths to dream big and work hard to make dia dreams come true. She yarn dis one on Thursday for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, during di opening of Oluremi Tinubu Dream Centre, one digital library wey  di Ooni of Ife build for her, with hellep from NITDA. According to di First Lady, di centre na big step for her mission to hellep young pipo  reach dia […]

todayJanuary 30, 2026 11

Lagos

Police Carry Lagos Protesters Go Court Over Anti-Demolition Protest

By: Esther Ayoola Lagos State Police command don carry activist Comrade Hassan Taiwo wey dem sabi as Soweto, and Dele Frank go Yaba Magistrate Court over protest wey dem go do against illegal demolition, di protest wey dem carry go Lagos Assembly. According to Prosecutor lawyer, Anthony Ihiehie, di two of dem join hand for di January 28 protest for Alausa and House of Assembly area wey cause wahala, block road, threaten pipo and sing abusive songs against gornment and […]

todayJanuary 30, 2026 14

Lagos

Police Nab Lagos Couple Wey Fake Kidnap

By: Esther Ayoola Di Lagos state police command don go arrest one couple wey call demselves Fred and Goodness afta dem stage dia own kidnap to collect N10 million ransom from family and friends. According to Police source, say dem fake di kidnap for January 7 because di man wan travel  back to US and  as money no dey, so dem make di plan together. Say, na for one school area for Mushin, police go catch dem as dem dey […]

todayJanuary 30, 2026 16

Lagos

UNILAG And UK University Join Bodi Set Up New School Unit For Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola University of Lagos (UNILAG) and University of Birmingham for UK don sign Memorandum of Understanding to set up Transnational Education Unit, inside, UNILAG. Dis agreement go make dem work with Nigeria Ministry of Education to prepare plans, with aim to start teaching students by 2027. According to report, di courses go include Applied Intelligence, Digital Communication and Media, health sciences and engineering. Education Minister, Dr Tunji Alausa, wey wet di ground for our UK brodas, sha explain […]

todayJanuary 30, 2026 10

Sports

Wilfred Ndidi Pay Emotional Tribute Giv Im Late Papa

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, Wilfred Ndidi, don pay emotional tribute to im papa, Mr Sunday Ndidi wey tragically die yesterday afta one car run am for Umunede, near Agbor for Delta State. Ndidi Turkish Super Lig club, Besiktas, don announce say senior Ndidi don die for dia X handle yesterday, and dem still send condolence to di retired soldier. Di Super Eagles Captain for emotional post for im Instagram page, yarn say e dey very sad say e […]

todayJanuary 29, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds