Blog masonry

Background

National

NNPP Chief Galadima Advice APC On Security

By: Esther Ayoola One Senoir man for New Naija Peoples Party, Buba Galadima, don shake table jigijigi say boys fit serious with 2027 election, sake of say, dem nor dey get am clear for di President Bola Tinubu gorment. Di NNPP senior man dey yan dis one for TV sit don tuk on  Thursday, say, if Nigerians fit comot President Goodluck Jonathan from office dat time because of security, dem fit run am again against Tinubu. Galadima say make di […]

todayFebruary 27, 2026 3

National

INEC Fix New 2027 Election Dates, President Election Go Be Jan 16

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission (INEC) don announce say Naija go hold new elections by January, 2027. INEC National Commissioner, Mohammed Haruna, tuk dis one for Abuja on Thursday. Dem don fix Presidential and National Assembly elections for Saturday, January 16, 2027, and Governorship plus State Assembly elections for Saturday, February 6, 2027. Haruna say dem change di dates because of wetin di new Electoral Act, 2026 don add on pre-election activities and gbogbonye gbongbonye.

todayFebruary 27, 2026 4

National

Opposition Kick Against Tinubu Electoral Law, Say Make Dem Do Fresh Amendment

By: Esther Ayoola Opposition political parties don reject di 2026 Electoral Act wey President Bola Tinubu sign into law, say some parts of di law fit spoil free and fair election for 2027. For press briefing wey dem hold for Abuja on Thursday, leaders like Atiku Abubakar, Peter Obi and Rotimi Amaechi say National Assembly must remove wetin dem call “obnoxious provisions,” especially di clause wey allow manual transmission of results if network fail. Dem argue say Naija get enough […]

todayFebruary 27, 2026 2

National

Oluremi Tinubu Bag “Light of God” Title for Warri, Call For Unity

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Oluremi Tinubu, don receive traditional title of Utukpa-Oritse (Ugbone) for Warri Kingdom as dem honour am for her public service and humanitarian work. Di ceremony hapun for her maternal home, Warri, Delta State, where di monarch, Ogiame Atuwatse III, welcome am and praise her effort for women empowerment and social welfare. For her speech, Mama Oluremi, say make Nigerians dey united and live as one, no mata di tribe, religion or political difference, say […]

todayFebruary 27, 2026

National

Ondo Police Gbab Six Allege Fake Pastors For Fake Miracles

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command say dem don gbab six men dat dem sell miracle for Idanre LGA, dey pose as pastors, dey do fake miracles up and down. Police tuk, tuk, Jimoh Kazeem, say di arrests happen on February 16, 2026, afta tactical team and Community Safety Officers follow intelligence. Police say, di suspects, wey dem identify as Fadahunsi, Kolade, Tijani, Iyanuoluwa, Arijesulola and Ademola, dey do fake miracle for money, health, and other problem, dat dem […]

todayFebruary 27, 2026 1

National

Makinde Say Na Competence, Loyalty Go Decide Im Successor For 2027

By: Esther Ayoola Baba govo of Oyo State, Seyi Makinde don share update say, na sabi man and loyalty to Oyo State go decide who go succeed am as govo for di 2027 elections, and by loyalty to im di governor. Di Govo make di statement for inside di 12th Omituntun Annual Ramadan Public Lecture wey shelle for Ibadan. Makinde yan plenty, show report card, say im gornment don pay over ₦25 billion, clear old gratuities and increase monthly payment […]

todayFebruary 27, 2026

Lagos

NLC, FOBTOB Lock NAFDAC Office For Isolo, Protest Di Ban Of Sachet Alcohol

By: Esther Ayoola Members of di Naija Labour Congress (NLC) and di Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association (FOBTOB) don sti go block di office of di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) for Isolo, Lagos,  dey shout say “No work for us, no work for you,”. Say di protest cause serious wahala as NAFDAC staff no fit enter the Lagos office until police from Odi-Olowo Division come intervene around. Nobodi fight sha, but say, […]

todayFebruary 27, 2026

Lagos

Customs Join Bodi Wit Navy To Secure Apapa Port

By: Esther Ayoola Apapa Area Command of Naija Customs like dis, don join body wit Nigerian Navy to make port security strong and trade smooth. Customs Area Controller, Comptroller Emmanuel Oshoba, ni go visit Rear Admiral Abubakar Mustapha, di Flag Officer Commanding Western Naval Command, dey  share dis beta collabo. Oshoba say di visit na part of di three policy palava of Consolidation, Collaboration, and Innovation wey di Comptroller-General of Customs, Dr Bashir Adeniyi, don introduce. Wey say make dem […]

todayFebruary 27, 2026 1

Lagos

Lagos Assembly To Stop Further Demolitions For Makoko, Shogunle

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don komfam say dem no go allow any more demolitions for Makoko and Shogunle. On Thursday, during committee meeting with community leaders, Speaker Mudashiru Obasa, through Majority Leader Noheem Adams, fry mouth wetin on wetin dem wan do now, say each community go form 10-person committee to work with gornment. Di Lawmakers say dem go finish settlement with di communities within two weeks to make sure say, peace return. Dem also approve […]

todayFebruary 27, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app