Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

INEC Bring QR Code Make Lagos Voters Check Dia Names

By: Jolayemi Olajide INEC don bring QR code wey Lagos voters fit use find where dem go check dia names for voter register. INEC Resident Electoral Commissioner for Lagos, Prof. Ayobami Salami, announce dis one on Tuesday, as e say dem don start to display voter register since October 9 for all 245 wards across di state. Di exercise go end October 15, and e go help voters check dia details and correct any mistake wey dem notice. Salami urge […]

todayOctober 13, 2026 11

Lagos

Fire Burn House For Itire, Two Men Rescue

By: Jolayemi OlajideĀ  Firefighters don rescue two men, age 75 and 42, after fire burst for Onitire Road, Itire, Lagos, Tuesday night. Lagos State Fire Service talk say dem receive emergency call around 9:10 p.m. and reach di place by 9:35 p.m. Di fire burn one eight-room bungalow and damage part of another building wey dey nearby. Di 42-year-old man wey burn as e try rescue di elderly man don dey receive treatment for Gbagada General Hospital.

todayOctober 13, 2026 8

Sports

Shakiru Giwa Comot As Inter Lagos Coach

By: Jolayemi olajide Shakiru Giwa don comot as head coach of Inter Lagos for Naija Premier Football League, NPFL. Di Lagos club announce di news for dia X account on Tuesday, October 13, 2026, confirm say Giwa no dey in charge of di team again. Giwa na di first coach wey comot im position dis season, but Inter Lagos no talk wetin make am leave. Di club thank am for di work wey e do to help dem achieve recent […]

todayOctober 13, 2026 6

OBODO NAIJA

Wike Tok Say Na Hin Chase Lawal Comot From PDP

By: Jolayemi Olajide FCT Minister, Nyesom Wike, don fire back at Zamfara Governor, Dauda Lawal, after e call am dat guy. Wike tok dis one on Tuesday during media parley, as e claim say na im make Lawal comot from Peoples Democratic Party, PDP. E talk say even though Lawal get money, im and im people no fit stand against am when dem still dey inside PDP.

todayOctober 13, 2026 6

Lagos

Police Gbab 4 Suspected Cultist For Lekki, Ajah Area

Lagos State Police CommandĀ  don do small Rambo go krampĀ  four suspected cultists jaguda boys, say dem bin dey do jaguda doings forĀ  Lekki, Ajah and Elemoro area. According by statement wey police tok tok pesin, Adebisi Abimbola release say dem arrest one Arisekola Ojo, Oluwatobi Oyewole, Oluwaseyi Odunewu and Olumagba Ifatope. Abimbola konfamate say police nor be winch say na information wey di suspects by diasef give during di touchlighting dem take recover one locally made short gun for […]

todayOctober 13, 2026 7

OBODO NAIJA

How Women Leaders Raise Hand Support Tinubu/Shettima Ticket

Di election breeze take dey blow nor be small, group just dey do alignment support group up and down, na so yesterday one women political group wey call demselves Nigerian Women for Tinubu/Shettima 2027 (NWFTAS 2027), go promise re-election for Tinubu/Shettima ticket inside Aso rock. For una wey never get voter card, oyo na your case oh, women dey play front for Abuja like dis like dis. Senior man vice presido,Ā  Shettima kon also promise hin own in return say […]

todayOctober 13, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Cut Chain Follow Pikin Former Girl Friend

Senior man Presido of America, Donald Trump don open case and plan to sack hin pikin former girlfriend, wey be US ambassador to Greece, Kimberly Guilfoyle, based on say she bin use back door clear her loans. As tori pipu ask Trump wetin hin go do to hin first pikin Donald Trump Jr former fiancee,Ā  senior man squeeze face, tokĀ  say make dem leave di mata to am, say hand go touch her, if dem find her guilty. All dis […]

todayOctober 13, 2026 8

Sports

Ronaldo Near 1,000 Goals as Im Score 981st Career Goal

Cristiano Ronaldo don score im 981 goal for career as Al-Nassr beat Neftchi Fergana team from Uzbekistan 3-1 for di AFC Champions League Elite match on Monday. Di 41-year-old Portuguese superstar score di second goal for Al-Nassr for di 42nd minute after Angelo Gabriel bin open score for 33rd minute inside Al-Awwal Park stadium for Riyadh. Sadio Mane float one sharp cross from di left, Aiman Yahya use im chest direct di ball give Ronaldo, and di man just turn […]

todayOctober 13, 2026 6

Lagos

LAWMA Close Over 25 Buildings Say Dem Dey Dirty Lagos

Lagos waste management pipo, don carry dia hammar knack, betaĀ  akpako untop over 25 buildings, including one filling station, lock everywia forĀ  Ago Palace Way, Okota, Lagos, say na dem dey make lagos dey smell. LAWMA oga Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, naim by himself lead di operation with hin street sweepers naim dem take package di clearing Dem also kramp some boys wey dey use dia small barrow dey park dirty for 5k perload.  

todayOctober 13, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

Ā 

listen with your app

This will close in 0 seconds