Blog masonry

Background

obodo oyinbo

World’s Youngest King, Oyo, Dies at 34

By: Blessing Aminu King Oyo Nyimba Kabamba Iguru Rukidi IV, wey become king at just three years old, don die for Uganda at age 34. Di Tooro Kingdom Prime Minister, Calvin Armstrong Rwomiire Akiiki, announce im death on Friday and describe am as big loss to di royal family and Tooro people. We neva know di cause of e death, but Ugandan media tok tok pipu tok say di king bin dey  sick wella wella and e bin dey receive […]

todayAugust 28, 2026 14

Sports

Must Read: Big Facts About World Cup Wey You No Know

By: Blessing Aminu Since di 2026 World Cup just add another chapter to football history, e fit make sense to look back at some of di unbelievable moment wey make di beautiful game special. From historic victory and strange records to players wey overcome incredible challenges, football history get plenty tori wey still dey surprise fans today, we get beta football history fact for here: First FIFA World Cup na 1930 Make we go back to 1930, when World Cup […]

todayAugust 28, 2026 19 2

obodo oyinbo

US Pull Some Troop Comot Nigeria After Joint Operation

By: Kofoworola Olayinka US and Nigerian forces don carry out joint military operations for Lake Chad Basin wey lead to di killing of Abu Bilal al-Minuki, wey US identify as senior Islamic State commander. Pentagon Africa Command spokesperson, Colonel Becky Heyse, say di joint operation show say temporary US military presence fit deliver strong security results. According to reports, Washington dey plan to reduce some of im military presence because di main mission wey bring di larger contingent don achieve […]

todayAugust 28, 2026 14

Politics

Atiku: I Go Bring Back Petrol Subsidy If I Win 2027

By: Kofoworola Olayinka ADC presidential candidate, Atiku Abubakar, don talk say e go restore petrol subsidy if e win di 2027 election because Nigerians never see how gornment use di money wey dem save. Atiku talk dis for BBC Hausa interview on Friday while explaining how e wan tackle di hardship wey Nigerians dey face. E say e no oppose di removal of petrol subsidy, but e dey question where di money wey gornment save from am don go. Atiku […]

todayAugust 28, 2026 12

crime

Police Don Save Two Bike Thieves From Angry Pipu for Kebbi

By: Kofoworola Olayinka Kebbi Police don save two men, Rufai Salihu and Aliyu Muhammad, wey angry pipu wan injure over alleged motorcycle theft for Gesse Phase 1, Birnin Kebbi, on August 26. Police PPRO, SP Bashir Usman, talk say officers quickly enter the matter, rescue di suspects wey sustain injuries and carry dem go hospital. Police recover one Boxer motorcycle from di suspects, while di angry pipu later allegedly try attack police facility for di area. Police don take over […]

todayAugust 28, 2026 7 3

Entertainment

Odumodublvck Don Choose Arsenal League Trophy Over Grammy

By: Kofoworola Olayinka Nigerian rapper Odumodublvck don talk say e go choose Arsenal to win Premier League title over make e win Grammy Award. E make di statement for one viral interview with DJ Semtex, where e talk about im love for Arsenal and dia title chase. Odumodublvck say e meet Super Eagles midfielder Eberechi Eze during New Balance advert shoot after Arsenal lose to Manchester City. E say Eze assure am say Arsenal still go win di league despite […]

todayAugust 28, 2026 11 3

Politics

Atiku: Na Me Start Opposition Group

By: Kofoworola Olayinka Atiku Abubakar don reject claim say e dey block opposition group ahead of 2027 election, saying na im start di group. E talk dis while e dey push to unite opposition politicians against APC for di 2027 presidential election. Atiku say most of di politicians wey start di group still dey together despite dia gbege, but Peter Obi and Rabiu Kwankwaso don comot. E insist say na only Obi and Kwankwaso leave, while di rest still dey […]

todayAugust 28, 2026 12

obodo oyinbo

Trump Don Comot Maduro From Power for Venezuela

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don send American forces enter Venezuela on January 3, 2026, where dem reportedly capture Presido Nicolas Maduro and im wife, Cilia Flores, before dem carry dem go America. Trump later tuk say US go oversee Venezuela political transition, while America also move to take control of how Venezuela crude oil go dey sell and how di money go dey handle. Di move mean say US military enter another sovereign country, comot di sitting […]

todayAugust 28, 2026 14

crime& security

Military Vehicle Crash Kpai Five Traders for Taraba Market

By: Kofoworola Olayinka Five traders don reportedly kpai while several others sustain injuries after military vehicle from FOB Wukari crash into people for Peva Market, Takum LGA, Taraba State, on Wednesday afternoon. Resident, Tony David, confirm di incident, saying di victims dey display dia goods by roadside when di military vehicle lose control and hit dem. Di vehicle dey escort traders from Wukari to Takum to provide security because of repeated kidnapping and killings along di road. Di crash don […]

todayAugust 28, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds