Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Minister Umahi Fry Mouth As Plans Dey Go For Lagos Calabar Coastal Highway

You sabi dat report wey bin fly up and down yesterday say di federal gorment wan change plans for di Lagos Calabar costal highway, story don change oh, in fact wi Minister of Works, David Umahi, say make Nigerians nor mind bad belle pipu wey dey spread fake news. Say di plans for di 750-kilometre Lagos-Calabar Coastal Highway project sti dey intact. Oga Umahi clear di air give Baba Seyi for Aso Rock Villa after e meet Presido Bola Tinubu […]

todayOctober 13, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Drag Putin, Zelenskyy to stop Dia Nonsense War

US Presido, Donald Trump don blow grammar for ground again oh, say make both Russia and Ukraine  stop to attack, say na war wey nor make sense dem dey fight. Trump tok dis one on Monday even as Ukrainian President Volodymyr Zelenskyy dey complain say Russian soldiers don sti go bomb at least six energy centers for Ukraine after peace agreement on Sunday When reporters ask Trump about di new attack dem, e reply say e go check am wella, […]

todayOctober 13, 2026 8

Sports

Jay-Jay Okocha Back Mbappe For 2026 Ballon d’Or

Super Eagles legend Jay-Jay Okocha don back Real Madrid star Kylian Mbappe to win di 2026 Ballon d’Or award. Di former PSG playmaker tok dis one during interview with French paper Le Journal du Dimanche, wia fry mouth  say Mbappe goal-scoring record make am stand out pass order top players like Harry Kane and Lamine Yamal. Okocha explain say Mbappe deserve di big prize because e finish as top scorer for World Cup with 10 goals, Champions League with 15 […]

todayOctober 13, 2026 10

Sports

Kayode Oke Score Goal After 18 Seconds

Kayode Oke, wey dey play for Bendel Insurance, score di quickest goal for dis season NPFL as e put ball for net just 18 seconds after match start against Sporting Lagos for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Even though Oke give im team early lead, Bendel Insurance no fit maintain di lead as Sporting Lagos fight back to win di match 2-1. Victor Samuel score di equaliser for Sporting Lagos before Gafar Olaniyan score di winning goal, wey give di […]

todayOctober 12, 2026 8

obodo oyinbo

One Kpai, 11 Wound For Saudi Airport Attack

One person don kpai, while 11 others don wound for attack on King Khalid International Airport for Saudi Arabia. Di attack happen hours after Houthi media report say airstrike hit airport for Sanaa, di capital of Yemen wey rebel dey control. Iran Foreign Ministry spokesperson, Esmaeil Baghaei, talk say Iran dey seriously worry about wetin dey happen for Arabian Peninsula. E say di way di wahala dey increase go only benefit Israel.

todayOctober 12, 2026 12

OBODO NAIJA

LCCI Beg Gornment Make Petrol Price Drop by 15 to 20 Per Cent

Lagos Chamber of Commerce and Industry, LCCI, don ask federal gornment make dem reduce petrol price by 15 to 20 per cent within six months, so e go reduce di heavy cost of fuel and transport wey dey affect businesses and ordinary Nigerians. LCCI Director-General, Dr Chinyere Almona, welcome gornment plan to control petrol price, including di proposed ₦1,350 per litre limit for petrol cost before e reach filling stations, but she tok say keeping price stable for high level […]

todayOctober 12, 2026 14

OBODO NAIJA

Chief of Staff, Segun Ogunwuyi, Resign From Hin Job 

Segun Ogunwuyi, wey be Chief of Staff to Oyo State Govo, Seyi Makinde, don resign from di gornment on Monday, October 12, 2026. For im resignation letter, Ogunwuyi say im resignation start to dey effective from di same day wey im write di letter. Ogunwuyi, wey don serve before as member of Oyo State House of Assembly and House of Representatives, na one of several aides wey don resign from Makinde gornment for di last two months. Im thank Govo […]

todayOctober 12, 2026 9

OBODO NAIJA

INEC Talk Say Governorship List For Six States Na Fake

By: Mariam Ajayi INEC don tok say one announcement wey dey waka online about governorship candidates for six states na fake. Di commission tok am on Monday for dia social media, say dem no release any list for Zamfara, Gombe, Delta, Plateau, Yobe and Kano states. INEC tell Nigerians make dem no mind di announcement because na fake news, e no come from dem. Dem beg Nigerians make dem no share di fake news, make e no go dey spread […]

todayOctober 12, 2026 10

OBODO NAIJA

Bayelsa Gofnor Order Free Medical Check Up Every Three Months

By: Mariam Ajayi Bayelsa Goment don order free medical checks for residents across all eight Local Gorment Areas Governor Douye Diri give di order on Sunday for St John’s Anglican Church, Olobiri, Kaiama, to help people wey no fit afford medical tests. Di checks go cover high blood pressure, high blood sugar and cancer for government secondary hospitals, while di Health Commissioner go announce when di programme go start. Diri also direct di Works Commissioner to submit plans to repair […]

todayOctober 12, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds