Blog masonry

Background

National

Police Clear Air On Bagudo Hospital Explosion

By: Rilwan Agbomeji Kebbi State Police don share correct update say di wahala wey happen for General Hospital, Bagudo no be bomb or air strike. Di gbege happen early Tuesday, people fear well, well but no person loss im life. Police talk say na fire wey explode from AC and fridge gas cylinders because of heat, na im make di loud explosion. EOD-CBRN experts and Police Tactical Team confirm say no bomb or aerial activity dey inside di mata and […]

todayDecember 30, 2025 18

foreign

Iran Tell U.S, Try Us Again, You Go Regret Am

By: Rilwan Agbomeji Iran don finally respond to Donald Trump say dem go give am hot, hot, back to sender, if  America or anybody try attack dem again. Dis one come afta US presido Donald Trump threaten say America fit strike Iran if dem try rebuild nuclear or missile programme. Iran presido Masoud Pezeshkian clear tori pipo for office, say any aggression go bring serious regret, as Iran no gree negotiate missile marras. Di talk don raise fear of anoda […]

todayDecember 30, 2025 12

Business

Dangote Giv 10-Day Credit, Free Delivery For Dealers

By: Rilwan Agbomeji Unto updates for business, say like dis, like dis, Dangote Group don announce new supply plan for petrol station owners and dealers. According to report from aproko pipo, Dem go give 10-day credit wey get bank guarantee for people wey dey buy petrol. Di company say but Dealers wey join dis scheme must order at least 5,000 litres, plus free direct delivery go soon start. Dangote don call all petrol station owners and dealers make dem register […]

todayDecember 30, 2025 15

Sports

Liverpool Part Ways With Coach Aaron Briggs

By: Rilwan Agbomeji Liverpool Football Club don  share surprise update, dat Aaron Briggs, wey join di club as individual development coach for July 2024, go leave im role with immediate effect. Di club post for dia official website on Tuesday dat, Briggs dey important part of Arne Slot backroom staff and e help Liverpool win last season Premier League. Dem nor  really give full gist on why im dey comot, but dat im work for player development and support behind […]

todayDecember 30, 2025 19

National

Amotekun Catch 39 Sokoto Jaguda Pipo For Ondo Forest

By: Rilwan Agbomeji Amotekun for Ondo State don catch 39 people wey dem say na from Sokoto State, wey dem hide for forest afta US-backed military strike against ISIS for North. According to report, say dem catch dem for Elegbeka area for Ose Local Govment, wey don long dey known as place wey bad people dey. State Commander, Adetunji Adeleye, talk say dem dey hide for forest, and dia cars dey park far from where dem dey hide. Amotekun yarn […]

todayDecember 30, 2025 17

National

Court Arrange Room For Former-Agf Malami, Pikin And Wife For Kuje

By: Rilwan Agbomeji Federal High Court for Abuja don order make dem remand former Attorney-General of di Federation, Abubakar Malami, for Kuje Correctional Centre. Di court also send im pikin and one of im wife, Bashir Asabe, go Kuje prison pending when dem go hear dia bail matter. Justice Emeka Nwite give di order afta e hear argument from lawyers for both defence and prosecution. EFCC dey charge Malami and im family with 16-count money laundering case.

todayDecember 30, 2025 23

Sports

FRSC Investigate Joshua Road Crash

By: Esther Ayoola Untop di updates of di accident wey involve Nigerian boxing star Anthony Joshua, say di federal road safety don dey touchlight di mata unto wetin really cause di accident Di Federal Road Safety Corps (FRSC) yarn on Tuesday say dem dey wait full technical report to know di exact reason for di crash. Untop yanings for TV sitdon tuk, FRSC spokesperson Olusegun Ogungbemide tuk say preliminary assessment show say excessive speed fit be main reason, and dis […]

todayDecember 30, 2025 31

Sports

British Deputy Head Visit Anthony Joshua For Lagos Hospital

By: Esther Ayoola Di Deputy Head of Mission for British High Commission, Simon Field, don visit world heavyweight boxing champion Anthony Joshua for hospital after di deadly road accident for Lagos–Ibadan Expressway. According to statement from Special Adviser on Information and Strategy to Ogun State Governor, Kayode Akinmade, dis one hapun on tuesday. Say, Field also meet Ogun State Governor Dapo Abiodun and Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu to discuss di matter. According to report, British officials dey closely monitor […]

todayDecember 30, 2025 26

National

Kebbi Police Take Over Bagudo Hospital Afta Explosion For Bagudo

By: Esther Ayoola Di Kebbi State Police Command don assure residents say security don return to normal afta one loud explosion happen for General Hospital, Bagudo, early Tuesday morning. Di assurance come from di Police Public Relations Officer, SP Bashir Usman. Police tuk say joint security team wey include Nigeria Police, military, and local vigilante dem quickly block and secure di area. Dem also send Explosive Ordnance Disposal and CBRN specialists to check di scene properly.

todayDecember 30, 2025 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds