Blog masonry

Background

Sport Yarns

World Athletics Block IOC Move, Hold Ban on Belarus Sports Return

By : Jolayemi Olajide World Athletics don reject International Olympic Committee recommendation wey talk say Belarus athletes and teams fit return to compete under dia national flag for international events. Dis mata sef dey come after IOC executive board meeting on Thursday ginger sports bodies to allow Belarus back, but still maintain restriction on Russia because of Ukraine war. Both Russia and Belarus bin dey banned from Olympic competition since 2022, although dem later allow athletes to compete as neutral […]

todayMay 8, 2026 24

Entertainment

Shakira Link Up Burna Boy, Tease New World Cup Gbedu “Dai Dai”

By: Jolayemi Olajide Colombia music queen, Shakira don drop  2026 World Cup gbedu, dem title “Dai Dai”, shoot small video for Brazil Maracana Stadium yesterday. Di Colombian singer wey sing 2010 “Waka Waka”,  team up with Nigerian artiste Burna Boy to produce di song. For di 67-second video, Shakira enter di  pitch of Maracana for Rio de Janeiro, after she perform free concert for Copacabana Beach last Saturday. Di song go officially drop on May 14, according to her social […]

todayMay 8, 2026 113

Sport Yarns

Trump Reject $1,000 World Cup Ticket, Say E Too Expensive

By: Jolayemi Olajide US Presido, Donald Trump don scata table say, even im sef nor go pay $1,000 ticket price to watch USA vs Paraguay for 2026 World Cup opener. Di tournament go start June 11, with US, Canada and Mexico as co-host, while USA go begin dia campaign for Los Angeles on June 12. Trump tell media say im no even know say ticket reach dat amount, but im  go like watch di  match, just say price too high. […]

todayMay 8, 2026 29

Sport Yarns

Aston Villa Wipe Forest 4-0, Enter First European Final In 44 Years

By: Jolayemi Olajide Aston Villa don qualify for dia first European final in 44 years, beating Nottingham Forest 4-0 for dia Europa League semi-final second leg on Thursday. Dem overturn di 1-0 first leg loss as Ollie Watkins score before half-time, while Emiliano Buendia add another one through penalty after di break. Captain John McGinn finish di job with two late goals to seal di win for Villa wey end 4-1 on aggregate. Dem go now face German side Freiburg […]

todayMay 8, 2026 30

obodo oyinbo

Germany Finance Minister Blame Trump Iran War As Tax Revenue Go Down For Germany

By : Jolayemi Olajide Germany finance minister Lars Klingbeil like dey vex wetin nor good dat, Donald Trump “ war for Iran”  dey scata tins for dem, say na wetin cause big drop for germany expected tax money. Di German Finance minister yarn dis one for news tuk on Thursday, dat, di US presido action don really bring global energy down and e dey affect economy worldwide. Say Germany don cut dia tax revenue forecast for 2026–2030 by about €70bn […]

todayMay 8, 2026 19

obodo oyinbo

US Top Diplomat Rubio Enter Vatican Meet Pope Leo XIV To Tuk About Iran War

By : Jolayemi Olajide US Secretary of State Marco Rubio don finally enter Vatican on Thursday go meet Pope Leo XIV, wey be di first US pope. Dis meeting sef dey follow tension between White House and Vatican over Pope position on di war for Iran. Rubio, wey be Catholic, on clear mata “say na serious tuk” e wan do with di Pope and Vatican top diplomat Pietro Parolin. Vatican side say, dem ma go just listen to wetin Rubio […]

todayMay 8, 2026 25

Lagos

Lagos To Do Prayer Meeting For Tinubu’s Re-Election

By: Esther Ayoola Say like dis Lagos Religion pipo wam enter prayer, dat, nothing less dan 55,000 Nigerians naim go gather for Tafawa Balewa Square on Sunday for special prayer for Naija and President Bola Tinubu re-election. Di Director-General of Renewed Hope Network for Lagos, Mohammed Danmole, naim tuk dis one for press briefing for Ikeja on Thursday. Say di prayer go bring Muslims and Christians together to ask for peace, progress and beta life for di country. Di group […]

todayMay 8, 2026 22

Lagos

NSCDC Warn Lagos School Pikins Against Cultism, Crime

By: Esther Ayoola Naija Security and Civil Defence Corps Lagos State Command don warn students across obodo Lagos to stay clear from cultism, bullying and other bad characters. Di State Commandant, Adedotun Keshinro, naim give dis advice during dia anti cultism sensitisation programme wey hold for NSCDC headquarters for Alausa, Lagos. According to NSCDC tuk, tuk, Oluwaseun Abolurin,  di session na to teach pupils how to stay safe and aware for school environment. Di command sti promise say dem go […]

todayMay 8, 2026 18

south west

Ogun State Catch 45 Pipo Say Dem Park Dirty For Road

By: Esther Ayoola Ogun State Waste Management Authority officials don arrest and sentence not fewer than 45 residents to community service because say dem dump dirty anyhow for roadsides and public places. According to di Ogun state waste management pipo, di arrest hapun for Quarry Road and Kolobo area. Konfaming di report, Agency adviser, Farook Akintunde, say di action na to end yangayanga throwing of dirty for Ogun state and dat e dey spoil environment, affect public health, and fit […]

todayMay 8, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds