Blog masonry

Background

National

NURTW Beg Presido To Recognise Baruwa As Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Lawyer wey dey represent Comrade Ibikunle Baruwa, Tolu Babaleye, don call on Presido Bola Tinubu make im put bodi for di wahala wey dey shake National Union of Road Transport Workers, NURTW. Oga Laywer say gornment suppose recognise Baruwa as di real National President since courts don already rule in im favour. Babaleye yarn dis one for Abuja as e stand with Baruwa and im supporters. For di union dem says dem nor understand why one man […]

todayMarch 27, 2026 3

National

32 Governors, 8,450 Delegates Enter Abuja For APC Convention

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu say, im     go join im cabinet members, 32 state govos plus 8,453 delegates for Abuja today and tomorrow for di All Progressives Congress National Convention. Oga Minister of Information, Mohammed Idris, yarn for news tuk, tuk on Thursday. Idris say top party ogas and leaders from national, zonal, state and ward level go dey di convention as dem go elect new party leaders.  

todayMarch 27, 2026 4

National

Former Senate Presido Saraki Insist Say PDP Sti Get Life

By: Esther Ayoola Former Senate Presido, Bukola Saraki, say like dis now, di Pipos Democratic Party (PDP) sti  dey pull crowd wetin nor good and dat di parti nor scata anything. E yarn dis one for TV sit down tuk, say di parti sti get beta grassroot connect. According to am, say na quarrel dey cause di wrong impression, as plenty Nigerians sti dey support di party.

todayMarch 27, 2026 6

National

ASUU Give FG 4 Days To Start Paying Dia Agreed New Salary

By: Esther Ayoola Di Academic Staff Union of Universities, ASUU, don give Federal Gorment four days ultimatum to start to dey pay university lecturers with di new salary structure wey dem agree. ASUU Presido, Professor Christopher Piwuna, tuk dis one for one public lecture wey happen for Bauchi State. U sabi say Dem don agree on di new salary since December 2025, and e suppose start from January 2026. Piwuna say gorment never sti show workings following di new structure […]

todayMarch 27, 2026 3

National

Vice Presido Explain How FG See Energy Security

Vice Presido Kashim Shettima don sti tuk say wi Federal Gorment nor go play wit energy security, because future of di country depend on am. Him yan dis one for di opening of Naija Electricity Liability Management Company (NELMCO) headquarters for Abuja. Shettima say, NELMCO na promise to handle every every as e take concern energy security. E press tuk, say dis administration sabi say energy security na di koko wey go hold national progress gbam.

todayMarch 27, 2026 4

National

Vice Presido Shettima promise To Protect Nigerians Right

By: Esther Ayoola Vice Presido Kashim Shettima don go drop promise for international lawyers front, say Naija ready to protect human rights as e take dey inside constitution. Di Naija vice presido do dis one for Abuja on Thursday, when e dey open 2026 High-Level International Humanitarian Law Dialogue. Shettima say Naija ready every every, to collabo with other countries and follow International Humanitarian Law (IHL) for every conflict and ensure security.

todayMarch 27, 2026 3

National

Saint Kitts PM Drew Meet Tinubu For Abuja

By: Esther Ayoola Prime Minister of one ogbonge country for Caribbean, Saint Kitts and Nevis, Terence Michael Drew, yesterday meet wi oga Presido Bola Tinubu for State House, Abuja, salutate di senior man wetin nor good. Based on doings afta di meet, Oga Prime minister tell tori pipo say im dey feel baba Seyi doings oh particularly im collabo as African Union member. E sha explain why im come, say na to strengthen friendship and cooperation with Naija, and Tinubu […]

todayMarch 27, 2026 5

National

Oyo Gorment Promote Assembly Member, Ali And Two Chiefs, To Become Big Obas

Di Oyo State Gorment on Thursday, don approve say National Assembly member wey dey represent Oyo South, Sharafadeen Alli, plus High Chiefs Bolaji Adewoyin and Kola Babalola, go become Obas for Ibadan land. Di Commissioner for Local Gorment and Chieftaincy Matas, Ademola Ojo, konfam dis promotion inside memo wey gornment release for Ibadan. Dem promote Alli go Ekerin Olubadan, Adewoyin go Ekaarun Balogun, while Babalola go Ekarun Olubadan. Di gorment tuk say dis elevation na to recognize dia contributions and […]

todayMarch 27, 2026 3

Lagos

Tijani Fatai Begin Work As Lagos Commissioner Of Police

By: Esther Ayoola Tijani Fatai don officially take over as di 42nd Commissioner of Police for Lagos State Command. Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, ni Konfamate dis update for Ikeja on Thursday. Say im go replace Olohundare Jimoh wey serve as di 41st CP from February 18, 2025, to March 26, 2026, based on  new posting wey come from di police headquarters, Abuja. Fatai, wey be from Agege Local Government Area, Lagos State, attend Anwar-ul-Islam College, Agege between 1979 to […]

todayMarch 27, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app