Blog masonry

Background

Lagos

Two Kpai, Six Wunjor For Lagos Road Accident

By Ebi Oboko Unto badness wey sup on new year day, say na Two people na kpai and at least six others wunjor for different road accident wey happen for Lagos on New Year’s Day. According to Lagos state Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) oga, Adebayo Taofiq, say, one crash happen for Iyana Itire, Oshodi side, when Volkswagen commercial bus jam Toyota Sienna, wey make two people die. For inside statement wey dem post for x on new year […]

todayJanuary 2, 2026 8 2

National

Ondo Govo ginger mehn police to Guide Area

By  Ebi Oboko Ondo State Governor, Lucky Aiyedatiwa, dey vex serious, say jaguda boys dey worry pipo, so like dis im don send security make dem double for all communities and forest areas, after New Year attack for Ipele police station for Owo LGA. The attack happen Wednesday night as plenty people dey attend night service to welcome 2026. Di Govo say, di mata nor dey let am sleep, so im don put call to police and army brigade commander […]

todayJanuary 2, 2026 8

foreign

Big Fire kpai 40+ for Swiss Ski Resort Bar

By Ebi Oboko Nor be small tin for Switzerland, say Swiss ski resort Crans-Montana, say nor nor small hell fire burn for dia, kill about 40 people and wunjor more than 100 for bar wey people dey celebrate New Year. The Fire start for Le Constellation bar around 1:30am, when plenty people dey inside. Police tuk say, wetin cause the fire, nbodi knw yet, and fire spread very fast. Swiss officials call am “embrasement generalise,” wey mean fire fit blow […]

todayJanuary 2, 2026 11

International

Israeli Soldiers Kill Pikin For Gaza Even After Ceasefire

By Ebi Oboko For Gaza, Israeli soldiers don kill one pikin wey dem dey call Youssef Ahmed al-Shandaghli for north side Jabalia an-Nazla. According to report, mehn, wimehn and childresis for Gaza dey suffer seriously because Israel nor gree make pipo con help dem for the gaza. Even with one ceasefire wey US help arrange for October, Israel still dey attack Gaza wetin nor gud, don kill over 400 Palestinians. Pipo dey fear say things go worse as wunjored and […]

todayJanuary 2, 2026 6

Sports

Tobi Amusan, Naija Athletes Shine for 2025 World Athletics Rankings

By Ebi Oboko Beta start for Tobi Amusan as she begin di new year as one of di top-three for World Athletics ranking for 2025 season. She join two oda Naija athletes – Ezekiel Nathaniel and Chukwuebuka Enekwechi – wey sti dey top 100 for world. Tobi wey be hurdling queen collect silver medal for 100m hurdles for Tokyo 2025 World Athletics Championships. She gather 1,430 ranking points, just dey behind Ditaji Kambundji from Switzerland and Grace Stark from America.

todayJanuary 2, 2026 7 9

Sports

Adebayor: AFCON Don Grow with Stronger fighting Spirit

By Ebi Oboko Former Togo striker Emmanuel Adebayor tuk say Africa Cup of Nations don change now, say now, e don dey more comeptitive. Adebayor wey play for AFCON back in the day talk say the tournament no be just football match again. E yan dis one give CAF online, in those day, e dey more raw and simple, but passion still dey strong. Now e don change well well, but the love for the game still dey sharp like […]

todayJanuary 2, 2026 7 12

Lagos

Lagos First Lady Waka Hospital To Welcome Lagos First Pikin Dem For 2026

By Ebi Oboko First Lady of Lagos State, Dr Ibijoke Sanwo-Olu, on Thursday waka go different public hospitals for Lagos to welcome the first babies of 2026. She and Deputy Govo wife, Oluremi Hamzat, celebrate three newborns, Baby Oluwadare, Baby Adegeye-Abiodun and Baby Daramola for Ibeju-Lekki, Imota and Gbagada General Hospitals with prayer and gift presentation. Dr Sanwo-Olu tuk say pikin wey dey come for beginning of new year, na sign of hope and reminder say everybody get role to […]

todayJanuary 2, 2026 11 2

Sports

EPL Result For New Year Day, Draw Full Ground

By Ebi Oboko Thursday for English Premier League, plenty teams no fit score as draw plenty. Brentford vs Spurs, Liverpool vs Leeds  match end 0-0, while Sunderland hold Man City 0-0. Crystal Palace and Fulham share point after 1-1 draw, same time Chelsea draw 2-2 with Bournemouth. Arsenal beat Aston Villa 4-1, and Newcastle waka pass Burnley 3-1. West Ham and Brighton end 2-2, Manchester United and Wolves draw 1-1, while Everton carry win come home against Nottingham Forest 2-0.

todayJanuary 2, 2026 11 9

Local

First Lady Welcome Nigeria First Pikins dem for 2026

By Ebi Oboko First Lady of Nigeria, Senator Oluremi Tinubu, don welcome Nigeria first pikin of the year, baby girl Enekole Zion Adakole, wey born exactly 12:00 midnight for FMC Jabi, Abuja, January first. The baby mama na 26-year-old first-time mother, Omeyi Patience Adakole, with her husband Celestine Adakole, as Madam First Lady present official birth certificate from National Population Commission give the newborn. She also celebrate Blessing Oragwu wey born triplets two boys and one girl, after 13 years […]

todayJanuary 2, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app