Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Must Read: Di Truth About Marriage Wey Most Pipo No Understand

Marriage no be just about two pipo wey dey live under one roof. E dey involve trust, communication, friendship, sacrifice, patience and di ability to respect and protect each other, even when things hard. But wetin go happen when di trust disappear? Wetin go happen when suspicion replace communication, quarrel replace affection, and di pipo wey promise to protect each other begin to hurt each other?   Read dis story very well as e go giv us one painful answer: […]

todayAugust 15, 2026 68 10

obodo oyinbo

How Russia scarra Ukraine Port with beta bomb wey get odour

By: Kofoworola Olayinka Russia forces don carry bomb for Ukraine railway station for Izmail port and two tugboats near Mykolaiv for Ukraine, Russian Ministry of Defence yarn dis mata on Friday, say dem scara Izmail railway station  based on say dem dey use am load crude oil. Meanwhile, Ukraine sef do dia own, na so drones hit targets inside Russia, including Baltic oil export hub and warehouse near Moscow.

todayAugust 14, 2026 11

Sports

Joshua-Fury Fight Jam Rock say no place dey to fight di fight

By: Kofoworola Olayinka   Anthony Joshua and heavyweight fight don dey face wahala as promoter Frank Warren warn say dem don match break for di  November bout, say both team never agree wia dem wan fight. dem bin dey think say na Wembley Stadium dem go fight di fight before, like dis wi dey hear say na e Madison Square Garden for New York don become di new ring to fight dis fight. According to report Saudi boxing organiser, Turki […]

todayAugust 14, 2026 10

National

INEC Clear Ground Begin Share Election Materials For Osun Saturday Election  

By: Kofoworola Olayinka Osun state, don dey ready body to vote say INEC don start to distribute sensitive election materials to all di 30 local government areas for Osun on Thursday night ahead of Saturday gorfnorship election. Di distribution happen under di supervision of Osun Resident Electoral Commissioner, Oluwatoyin Babalola. Di process bin delay earlier after Federal High Court order INEC to include di Social Democratic Party for di ballot.

todayAugust 14, 2026 12

crime& security

Experts Say Maps Fit Help Police Stop Kidnap And Trafficking

By: Kofoworola Olayinka Experts say maps and location information fit help security people know where kidnapping and human trafficking fit happen. Dem talk this for GEOSON meeting to mark World Day Against Trafficking in Persons. Dr Ademola Adeyemi say this information fit help them know areas where traffickers dey operate, where victims dey vulnerable and roads wey dem dey use. He say GPS, drones, satellite pictures and computer technology fit help security agencies act early before crime happen.

todayAugust 14, 2026 13 2

Sports

Ajibade Beg Super Falcons To Prepare Better After WAFCON Defeat

By: Kofoworola Olayinka Super Falcon captain Rasheedat Ajibade say Nigeria must prepare better after losing 2-1 to South Africa for WAFCON. She say di team must stop complacency because women football for Africa don become more competitive. Ajibade say players must reflect, improve and demand more from themselves. Nigeria had earlier lost 1-0 to Cameroon, missing di WAFCON semi-finals for di first time.

todayAugust 14, 2026 14

Business

NUPENG Beg Tinubu To Stop Temporary Work For Oil Industry

By: Kofoworola Olayinka NUPENG President Salimon Oladiti don beg President Bola Tinubu to stop temporary work arrangements for oil workers. Oladiti make di request when NUPENG leaders visit Tinubu for Presidential Villa, Abuja. Tinubu say subsidy removal don help government pay salaries and fund major road projects across di country. He thank NUPENG for supporting government, saying di union play important role for Nigeria economy.

todayAugust 14, 2026 11

Politics

ADP Candidate Warns Against Secret Replacement

By: Kofoworola Olayinka ADP presidential candidate Abbas warn against any secret move to replace im without im consent and proper party process. Abbas make di statement on Friday through im media aide, Okpani Dickson, for Kaduna. He say any decision on di presidential ticket must follow Nigeria Constitution, Electoral Act, ADP rules and INEC procedures. Abbas also call on di party chairman and other leaders to protect di integrity of di nomination process.

todayAugust 14, 2026 13

Sports

Boxer Prichard Colón Dies After Years Of Health Struggle

By: Kofoworola Olayinka Former boxer Prichard Colón don die after years of living with serious injury wey e suffer during fight in 2015. Colón suffer repeated blows to di back of di head during fight against Terrel Williams for Virginia. Doctors later perform emergency surgery after dem find blood clot for him brain, and e spend 221 days in coma. Colón finish him career with 16 wins and 13 knockouts, while di incident later lead to new boxing safety rule […]

todayAugust 14, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds