Blog masonry

Background

International

183 Million Gmail Passwords Don Leak As Data Breach Burst Out

Gmail users don dey get serious warning make dem check dia accounts after dem steal over 183 million passwords for one massive data breach. Australian cyber expert, Troy Hunt, wey first reveal di matter, describe am as one “vast corpus” of leaked data wey reach 3.5 terabytes e talk say na di same size like 875 full HD movies put together. According to Hunt, all di major email providers dey affected no be only Gmail, but Outlook, Yahoo and di […]

todayOctober 28, 2025 10

Entertainment

Rapper Ice Prince Don Share Him Inspiring Fitness Journey Before Him Birthday

Nigerian rapper Ice Prince don open up about di big change wey don happen for him health and how e decide to live clean life before him birthday wey go shele on October 30. For one heartfelt post wey e drop for X (wey dem formerly call Twitter), di Oleku crooner talk say e be like e wan explode no be say sickness dey worry am o, but na bad habits and poor lifestyle choices. E yarn say, “God so […]

todayOctober 28, 2025 71 5

National

Court Don Sentence Three Men To Death For Robbing 87-Year-Old Woman for Ekiti

Di Ekiti State High Court wey dey sit for Ado-Ekiti don sentence three people Shadrack Apos (30), Lucky Akpos (33), and Adunola Precious (24) to d3ath by hanging for robbing one 87-year-old woman. Dem arraign di trio for August 19, 2024, before Justice Lekan Ogunmoye on top two-count charge of conspiracy and armed robbery. According to di charge, dem rob Mama Victoria Folorunso for Ifaki Ekiti on June 12, 2024, collect ₦147,000 cash and one wristwatch. Di woman talk say […]

todayOctober 28, 2025 12

Lagos

Lagos Boxer Kill Carpenter Over Burst Ball For Ikorodu

One professional boxer wey people sabi as Bintin don allegedly punch one local carpenter, wey dem call Yellow, die for Adamo area of Ikorodu, Lagos, after dem quarrel over one burst football. Witnesses talk say wahala start after Yellow mistakenly burst di ball wey belong to Bintin pikin. Di boxer wife quickly call her husband, and as e reach house, e vex go meet Yellow accuse am say e burst di ball on purpose. Dem begin argue, and e later […]

todayOctober 28, 2025 60 2

Lagos

Shortlet Agent Chop Diaspora Family ₦1.3m For Ikoyi

As Detty December dey near, wahala don start again as reports don show say many Nigerians wey dey live abroad don dey fall victim to fake shortlet agents for Lagos. One diaspora family don lose ₦1.3 million give one agent wey promise dem one fine apartment for Ikoyi. Di family see di agent page for Instagram wey full with luxury shortlet pictures for Ikoyi and Lekki, and e look legit. Dem even visit di house and one woman wey claim […]

todayOctober 28, 2025 24

International

Ouattara, 83, Don Win 4th Term As Ivory Coast President

Ivory Coast Presido, Alassane Ouattara, don win im fourth term after di presidential election wey happen for di West African country. According to di Independent Electoral Commission (CIE) wey announce provisional result on Monday evening, di 83-year-old leader grab about 89.77% (3.75 million votes), while businessman Jean-Louis Billon carry only 3.09%. Voter turnout reach 50.1%, and di final result go come out after di Constitutional Council finish to check any petition wey dem file. Meanwhile, opposition parties wey include Gbagbo […]

todayOctober 28, 2025 22

Sports

Oliseh Hail Iwobi As First Naija Player To Hit 300 Premier League Games

Former Super Eagles star, Sunday Oliseh don hail midfielder Alex Iwobi after e make history as di first Naija player wey don play 300 Premier League matches. Iwobi reach dis big milestone during Fulham weekend match against Newcastle United for St. James’ Park. Di 29-year-old start im Premier League journey for October 2015 when e debut for Arsenal against Swansea City, and since den, e don play for three clubs , Arsenal (100 matches), Everton (123), and now Fulham (77). […]

todayOctober 28, 2025 23

Sports

Super Falcons’ Michelle Alozie Make 2025 FIFPRO World XI List

Super Falcons defender Michelle Alozie don make di 26-player shortlist for di prestigious 2025 FIFPRO Women’s World 11 wey dem announce on Monday. Di nomination base on votes wey professional football players from around di world cast. Alozie get di nod after one hot year wey she shine for Nigeria’s strong campaign for 2024 Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) for Morocco. Di Houston Dash right-back be one of di key players wey help Super Falcons reach di final after […]

todayOctober 28, 2025 49

Lagos

Otti Hail Abia Biker We Ride From Lagos, Vow To Still Put People First

Governor Alex Otti don talk say him government no go gree make anything distract dem from giving Abia people di real dividends of democracy, as him still stand gidigba to better di welfare and well-being of di people. Di Governor yarn dis one when him receive one Abia-born cyclist, Mr. Wisdom Chisom, we ride bicycle all di way from Lagos reach Abia just to honour di Governor for him visible and impactful work wey don change di face of di […]

todayOctober 28, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app