Blog masonry

Background

Sports

Super Eagles Still Ready For World Cup Playoffs – Ndidi

Super Eagles captain, Wilfred Ndidi, say im and im teammates go still play di world cup play off if , FIFA  favour dem ahead of DR Congo. Di super eagles miss automatic qualification, after losing 4–3 on penalties to DR Congo for African play-off final last November. Nigeria Football Federation don carry matter go FIFA, tsay some DR Congo players switch nationality wrongly, so dem dey hope say, dem fit get second chance. As e be now, FIFA never yarn […]

todayMarch 6, 2026 32

obodo oyinbo

Iran Fire Missiles Enter Tel Aviv, Cause Big Damage

Iran don fire cluster missiles reach Tel Aviv for new attack wey hit central Israel,  damage everywia. TV Channel 12 for Israel report say some missile pieces land for di city and areas around am. According to eye wey see, wey nor reach collect slap, for eyes, say properties wey destroy yakpa Say, Since February 28, Iran don dey fire missiles and drones enter Israel and Gulf countries wey get U.S. military base.

todayMarch 6, 2026 39

Sports

PSG And Bayern Munich Enter Race To Sign Victor Osimhen

Five big European clubs don enter serious battle to sign Victor Osimhen from Galatasaray as summer transfer window dey approach. Bayern Munich dey plan to bring Osimhen replace Harry Kane, as coach Vincent Kompany wey don watch am since im Belgium days don give green light for di move. Paris Saint-Germain also dey chase Osimhen because dem want strong striker for their attack, while Manchester United, Juventus and Atletico Madrid still dey monitor im form and contract matter. Di 27-year-old […]

todayMarch 5, 2026 25

Lagos

Lagos State Farmers Collobi FG Support To Boost Food Security

Federal Government don empower small-small farmers for Lagos State with farm inputs to help boost food production and improve food security for Nigeria. Di empowerment programme wey Federal Ministry of Agriculture and Food Security carry out happen for Agege, Lagos on Thursday, and dem give 68 farmers cooperatives farm materials. Agriculture Minister Abubakar Kyari, wey Dr Marcus Ogunbiyi represent, talk say di programme na part of Presido Bola Ahmed Tinubu Renewed Hope agenda to fight food shortage, reduce farming cost […]

todayMarch 5, 2026 44

obodo oyinbo

First Rescue Flights Carry Stranded Israelis Back To Tel Aviv

First two flights wey carry Israelis wey dey stranded for abroad because of Middle East war don land for Tel Aviv on Thursday, after airspace close when United States and Israel launch strike against Iran. Di  flights land for Ben Gurion Airport, wey still remain closed for commercial flight operations, as first flight wey El Al Airlines operate come from Athens, while second flight wey Israir Airlines operate come from Rome, and each flight carry 170 passengers. Transport Minister Miri […]

todayMarch 5, 2026 31

Sports

WAFCON 2026 Fit Hold For July

Di 2026 edition of WAFCON 2026 fit move go July as uncertainty still dey around di original schedule. Di tournament suppose hold between March 17 and April 3 for Morocco, but preparation and organization wahala don raise doubt  whether competition go start as plan. Even though Confederation of African Football never officially talk anything, reports say dem don internally decide to postpone di tournament, and dem now dey consider July 25 to August 16, after FIFA World Cup 2026 wey […]

todayMarch 5, 2026 40

obodo oyinbo

Iran Hit US Oil Tanker For Gulf – Reports

Iran state TV don yarn say dem fire missile on one United States oil tanker for Persian Gulf on Thursday, and di vessel dey catch fire for sea. Di Islamic Revolutionary Guard Corps talk say di strike happen for Northern Gulf, but independent sources never confirm di attack as tension still dey rise for di region. Di Guards still boast say dem don take full control of di Strait of Hormuz, wey dey link di Gulf to Indian Ocean where […]

todayMarch 5, 2026 36

OBODO NAIJA

President Tinubu Give Order To Stop Airport Cashless Policy

Wi oga Presido, Bola Tinubu don order make dem immediately stop di cashless payment system wey dey operate for federal airports. Dis decision come out after meeting of di Federal Executive Council on Wednesday. According to Aviation Minister Festus Keyamo, plenty passengers dey miss dia flights because di system dey cause serious delay. And dat like dis Because of di suffer, suffer wey Nigerians dey face, di Presido say make dem suspend am for now.  

todayMarch 5, 2026 37

Sports

Arsenal Win, Man City Drop Points For Wednesday EPL Games

Arsenal don extend dia lead for top of premier leage table beating Brighton  1-kondo for AMEX Stadium on Wednesday. Brighton play sha, but Bukayo Saka goal give Arteta boys beta advantage after Man City go play 2-2 draw with Nottingham forest For first minute, David Raya almost spoil game as im give Carlos Baleba, but Gabriel rush save am. After 9 minute, Saka con bend small beta shot beating Brighton goalie Bart Verbruggen.    

todayMarch 5, 2026 28

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds