Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Iran Drone Hit UK Base For Cyprus, Germany Warn Say NATO Fit Collect Too

Germany foreign minister Johann Wadephul  say attack fit hit NATO country after Iranian drone go hit British air base for Akrotiri, Cyprus. Im tell tori pipo, say, two oda drones sti try attack but dem  intercept dem. According to report, UK don dey do defensive military work for Middle East against Iran to protect dia forces. Wadephul explain to Deutschlandfunk say Germany soldiers fit defend demself, if dem come under attack.

todayMarch 3, 2026 36

Sports

Galatasaray Rest Victor Osimhen For Turkish Cup Match

Say Galatasaray nor go use Victor Osimhen for tonight Turkish Cup match against Alanyaspor, dem say e dey on “active rest.” Other players like Uğurcan Çakır, Davinson Sanchez, Mario Lemina, Roland Sallai, Yunus Akgün, and Mauro Icardi sef no dey di squad because of small injury or special training. U sabi say, Osimhen  score one goal and give one assist for same Alanyaspor game last weekend. Say im go return for Besiktas match dis weekend, as e don score 17 […]

todayMarch 3, 2026 42

obodo oyinbo

IMN Protest For Lagos Condemn US, Israel Strike

Members of di South-West leadership of di Islamic Movement for Nigeria don hold peaceful protest for Lagos. Dem dey condemn United States and Israel for killing Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei. Dem also talk say im wife, Mansoureh Khojasteh Bagherzadeh, sti kpai from wunjuries wey she suffer for di recent attacks for Tehran, say di waka nor make brain at all. Reports talk say Khamenei sef die on Saturday, February 28, during di US and Israeli strikes.

todayMarch 3, 2026 25

Lagos

How Lagos Assembly Take Approve LASUSTECH Land Compensation

Lagos State House of Assembly don approve Committee on Rules and Business recommendation wey concern land wahala between Eyingbala family and LASUSTECH, Ikorodu. Majority Leader and Chairman of di Committee, Noheem Adams, tell House yesterday say di Eyingbala pipo na be di original owners of di land wey dey inside LASUSTECH premises, and dat gornment suppose give dem 50 hectares as compensation. Di decision follow long-standing petition wey di family submit to make government recognize dia ownership and settle matter […]

todayMarch 3, 2026 72

Lagos

Governor Sanwo-Olu Promise Package For State Retirees

Governor Babajide Sanwo-Olu say Lagos State gornment go continue to respect retirees and treat dem with dignity, fairness, and equality. Im tuk dis one during a courtesy visit by PTAD Executive Secretary, Tolulope Odunaiya, for Lagos House, Marina. Sanwo-Olu also explain oh, say dem don do reforms for pension system to reflect di reality of today so dat retirees go benefit wella. E add say, im gornment dey serious to make life beta for residents, especially retirees, through fair policies […]

todayMarch 3, 2026 33

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Direct Private Sector To Package Naija Gas infrastructure

Wi oga Presido, Bola Tinubu don clear wi Infrastructure Concession Regulatory Commission say make dem run di National Gas Infrastructure Command Centre (NGCC) as Public-Private Partnership (PPP) way, say gorment nor wan put serious money for di project. DG of di commission, Dr Jobson Ewalefoh, na im dey conversate dis mata inside for dia first Project Steering Committee meeting. NGCC na big national plan wey go monitor and manage Nigeria gas infrastructure in real-time, and private company go fund am […]

todayMarch 2, 2026 38

OBODO NAIJA

2 Kpai, 14 Wunjor As One 3-Storey Building Collapse For Lagos

Lagos State Emergency Management Agency, (LASEMA), don rescue six pipo afta one building collapse for House 29, Oriwu Street. Di workers wey dey di site na labourers, and di building collapse happen around 4 pm, cause still dey under investigation. Untop yarnings with tori pipo, Lagos State Police tuk, tuk, Benjamin Hudenyin, konfamate say na two pipo don kpai and dem recue 14 and  carry dem go Lagos Island General Hospital for treatment.

todayMarch 2, 2026 28

Sports

Temitope Adeshina Make History, Win Third Big 12 Indoor High Jump Title

Texas Tech high jumper, Temitope Adeshina, don win her third Big 12 indoor high jump title straight. According to report, She jump 1.96m wey be di second-best for her school history. Dis jump still break di old meet record wey Akela Jones and Destinee Hooker set. Temitope na di first woman for Big 12 to win three indoor high jump titles back-to-back since Rylee Anderson between 2021-2023.

todayMarch 2, 2026 39

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds