Blog masonry

Background

Local

I Take Responsibility For Abuja–Kaduna Train Wey Commot For Track — NRC MD

The Managing Director of Nigerian Railway Corporation, Kayode Opeifa, talk say e don carry full responsibility for the Abuja-Kaduna train wey derail for Kaduna corridor on Tuesday. For Wednesday, as e dey answer questions for interview for Channels Television program 'The Morning Brief', Opeifa apologize to Nigerians and talk say as the Managing Director and Chief Executive, na him suppose take responsibility for safety matter. E also talk say the investigation wey dey go on no go hide anything or […]

todayAugust 27, 2025 31

Sports

Super Eagles B Captain Don Join Club for Iraq

Iraqi club, Erbil FC, don announce say dem don sign Remo Stars captain, Nduka Junior, wey also be Super Eagles B team skipper for CHAN tournament. Di strong defender go bring him experience and leadership to boost Erbil FC defence as dem prepare for di new Iraq Stars League season. Nduka lead Remo Stars to win their first-ever NPFL title for 2024/2025 season one historic achievement since di club start. Di centre-back na product of Sky Blue Stars, where e […]

todayAugust 27, 2025 23

International

California parents Don carry OpenAI go Court, As Dem Talk Say Na ChatGPT Cause their Pikin Death.

Parents of one 16-year-old boy wey commit suicide for California don drag OpenAI, di company wey make ChatGPT to court. Dem talk say ChatGPT talk plenty bad things to their pikin, Adam, for months before e take him own life. According to di lawsuit, for their last conversation, ChatGPT help Adam steal vodka from him parents and explain how him noose fit work to kill person. Adam die few hours after dat using the same method. Di parents talk say […]

todayAugust 27, 2025 36

National

Plenty Kidnap Victims Escape As Security People Burst Kidnappers’ Hideouts For Kwara

Dozens of people wey bandits kidnap for Baba-Sango hideout inside Ifelodun area, Kwara State, don run commot after security forces carry big raid against di criminals. One security officer wey confirm di matter for Ilorin talk say, even though di bandits try ambush government forces, di operation still na modest success. Plenty bad boys kill, and many kidnapped victims don scatter go safer places like Babanla and Shagbe. Di officer also talk say one forest guard wey dem think say […]

todayAugust 27, 2025 46

National

Edo Police Don Rescue 13 Kidnapped Passengers – CP

  Edo State Commissioner of Police, Monday Agbonika, don confirm say police don successfully rescue all 13 passengers wey gunmen kidnap for Ekhiadolor area along di Benin–Ore Expressway on Saturday afternoon. According to reports, di armed men attack one commercial bus, shoot di driver, leave am for road with blood, then carry di passengers enter bush. As di story spread, police mobilize special squad sharp-sharp, deploy drones and other equipment to comb di area. Di wounded driver wey dey critical […]

todayAugust 27, 2025 33

National

Tinubu Say Im Belle No Sweet Am As Abuja–Kaduna Train Comot Track, Promise Quick Repair

President Bola Tinubu don talk say him dey sad as Abuja–Kaduna passenger train derail, even though di president dey Brazil for official visit, him say reports about di accident don reach am sharp sharp and him go dey follow di matter closely till full details land. For him verified X handle, Tinubu say e pain am well-well say innocent people go through dat kind wahala. E send him prayers to di injured people, their families and all di passengers wey […]

todayAugust 27, 2025 40

Lagos

Lagos Call On Stakeholders To Join Body Tackle Construction Waste Wahala

Lagos State Government don call on construction companies, property managers, and all di people wey dey involved for building work make dem join body help tackle di wahala of waste wey dey come from construction, demolition and disaster activities. For one stakeholders’ forum wey happen on Tuesday, Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say Lagos dey urbanize fast, and if everybody no cooperate, di environmental impact go plenty. Di event, wey carry di theme “Building Responsibly and […]

todayAugust 27, 2025 49

Lagos

Sanwo-Olu Warn Developers Wey Dey Do Illegal Coastal Projects for Lagos – “Una Go Hear Am!”

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, on Tuesday waka go do surprise inspection for some riverine areas like Ibeshe, Kare, Inagbe and Ilashe, where e see say many developers dey build anyhow without regard for government planning rules. As e waka round with him deputy, Dr Obafemi Hamzat, and other government people, Sanwo-Olu vex say plenty of the buildings for the area no follow safety standard at all. E talk say some people don carry their projects pass where dem suppose […]

todayAugust 27, 2025 30

Sports

Super Falcons Star Rasheedat Ajibade Don Sign for PSG

Nigerian football star, Rasheedat Ajibade, don seal big move go French giants, Paris Saint-Germain (PSG) Féminines. Di Super Falcons forward go now wear PSG jersey till June 30, 2027, as she join from Spanish club, Atletico Madrid. Dis new chapter go also join her with fellow Naija baller, Jennifer Echegini, wey dey already ball for PSG. For her unveiling, Ajibade talk say she feel honoured to join one of Europe’s top clubs and she ready to give everything to win […]

todayAugust 26, 2025 52

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds