Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

Some Students Fit Collect NELFUND Money Without Parents Knowing

Finance Minister Taiwo Oyedele say for Abuja on Wednesday say some students fit don collect NELFUND money without dia parents knowing. Oyedele talk dis one after one audience member say im three children never receive NELFUND support and dem no know anybody wey collect am. Di minister tell di journalist make e ask im children whether dem apply and demand proof of dia applications. Oyedele say e possible say di […]

todayAugust 20, 2026 12

OBODO NAIJA

Adeleke Announce N500m Fund For Election Violence Victims

Osun State Govo, Ademola Adeleke, don make everywia stew say na automatic scholarship to university level for children and dependants of pipo wey lose dia lives during violence before di August 15 gornorship election. Adeleke make di announcement on Wednesday for Labour movement celebration rally, shortly after he collect certificate of return from INEC. He also promise say Osun State Gornment go establish N500 million Election Violence Victims Endowment Fund […]

todayAugust 20, 2026 13

Lagos

Court Jail Three Suspects Say Dem Import Gun 

Senior Man judge for Federal High Court inside  Lagos don cut pipo joy short, order make three suspects wey Customs gbab over alleged unlawful importation of pump-action rifles remain for Correctional Centre for 15 days. Na Justice Friday Ogazi give di order on Wednesday against Kenneth Mbonu, Kenneth Agwu and Choima Onuoha, pending di completion of investigation into di case. Di suspects go remain for custody until September 1, 2026, […]

todayAugust 20, 2026 9

Sports

Haaland Lead Race For Premier League Golden Boot

By: Mariam Ajayi Erling Haaland go enter di new Premier League season as di biggest favourite to win Golden Boot after e score 27 league goals last season. Di Manchester City striker don win di award three time for four season and e dey target fourth Golden Boot. Liverpool forward, Alexander Isak dey among di main player wey fit challenge Haaland, although injury affect im campaign last season. Brentford striker, […]

todayAugust 19, 2026 25

Politics

Fayose Claim Say Accord Spend N40bn for Osun Election

By: Mariam Ajayi Former Ekiti State Gofnor Ayodele Fayose, claim say Accord Party spend at least 40 billion Naira for di August 15 Osun State gofnorship election. Fayose make di claim for video interview with TVC journalist,  Nifemi Oguntoye wey dem post for X on Wednesday. Dis statement come after Davido allege say APC spend N110 billion on vote-buying during di election. Davido, wey be Accord candidate, Ademola Adeleke nephew, […]

todayAugust 19, 2026 21

National

Wike Ban Cars For Abuja Green Areas

By: Mariam Ajayi FCT Minister Nyesom Wike don order immediate ban on cars and other unauthorised business for green area, park and garden across Abuja. Wike also order di touchlighting into civil servant wey allegedly dey approve conversion of recreational and protected area into car dealership. Di FCT Administration announce di directive on Wednesday, saying di move dey aimed at enforcing Abuja Master Plan and stopping illegal development. Di decision […]

todayAugust 19, 2026 25

OBODO NAIJA

Naija Begin Send Onion Give Ghana

By: Mariam Ajayi Nigeria don lift suspension on onion exports to Ghana, clearing di way for immediate resumption of cross-border onion trade between both country. Di National Onion Producer, Processor and Marketer Association of Nigeria say di decision follow consultation with trade pipo, diplomatic authority, ECOWAS and other stakeholder. NOPPMAN President, Alhaji Aliyu Isah Maitasamu, na im announce di decision for public notice dated August 19, 2026. Di association say […]

todayAugust 19, 2026 17

obodo oyinbo

US Coast Guard Comot 12-Year Restriction On Top Nigerian Ports

By; Mariam Ajayi Nigeria don score major victory for maritime sector as United States Coast Guard don lift 12-year security restriction wey dey affect vessels coming from Nigerian ports. Minister of Marine and Blue Economy, Adeboyega Oyetola, say di development show say Nigeria don make serious progress in maritime security and implementation of international port safety standards. Di restriction wey start for 2014 had made vessels wey call at Nigerian […]

todayAugust 19, 2026 16

obodo oyinbo

Drone Strike kpai Six Pipo For Gaza

By: Mariam Ajayi Gaza City don turn scene of panic after drone strike knack one police post, kpai about six pipo,  and wunjure several others. Di attack happen for busy hours for central city, close to di municipality and one park wey childrensis and other residents dey gather. Local paramedics say di casualty figure fit rise as emergency workers dey rush victims wey wunjure for treatment. Earlier, another attack knack […]

todayAugust 19, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds