Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Plenti Flight Cancel Afta US-Iran Fire Each other

Flights don scatter everywhere, as thousands of passengers dey stranded as US and Israel attack on Iran make global air travel choke. Countries like Iran, Israel, Qatar, Iraq and UAE lock dia space for air as missile and strike action burst for Gulf region. Airlines from Europe, Asia and America cancel plenti flights as tension for Middle East still dey hot like fire. Iran sharpaly lock dia airspace until further […]

todayMarch 1, 2026 3

obodo oyinbo

Iran Strike Israel and US Base Afta Khamenei Kpai

Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei. Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation. […]

todayMarch 1, 2026 3

Sports

Crystal Palace Carry Head Enter Conference League Last 16

By: Esther Ayoola Crystal Palace don show beta character enter UEFA Conference League last 16, beating Zrinjski Mostar 2-0 for Selhurst Park. For first leg, dem draw 1-1 with di Bosnian team. Maxence Lacroix and Evann Guessand ni score di goals wey carry dem through. According to report, Dis win sef, dey timely, as e hellep to relieve pressure for coach Oliver Glasner, wey don tuk say e go leave […]

todayFebruary 27, 2026 9

Sports

Arthur Okonkwo Get Clearance To Play For Super Eagles

By: Esther Ayoola Wrexham goalkeeper Arthur Okonkwo don get clearance from FIFA to play for Naija. According to report, di 24-year-old fit now join Super Eagles for di March international window tournament wey go shelle for Amman, Jordan. Na Iran dem go play first on March 27, den Jordan four days later for Amman International Stadium. Okonkwo clearance dey land just as first-choice goalkeeper Stanley Nwabali waka comot im club […]

todayFebruary 27, 2026 4

Sports

Super Eagles Coach Chelle Explain Why Im Ask For $130k Salary

By: Esther Ayoola Super Eagles coach, Éric Chelle, don defend why e dey ask Naija Football Federation (NFF) for $130,000 pay raise. Right now, him dey collect $50,000 per month, however, Chelle dey say di $130,000 no be just for him own pocket, e go also help pay him five-man technical staff, including assistant coach, physical trainer, goalkeeper coach, and personal assistant. E sti say today players dey need special […]

todayFebruary 27, 2026 8

obodo oyinbo

China Remove 19 Lawmakers, 9 Na Military Men, Before Big Election Meeting

By: Esther Ayoola China don shake table, remove 19 people, including nine military officers, from lawmaker list before dia big political meeting next week. National People's Congress Standing Committee konfamate di removal, but no share any reason for di removal. Dis one dey hapun soon afta President Xi Jinping remove Zhang Youxia, him top general and close ally. Some people dey tuk say Xi dey fight corruption, but others tuk […]

todayFebruary 27, 2026 8

obodo oyinbo

Pakistan Fire Kabul, Kandahar Afta Taliban Attack Border

By: Esther Ayoola Pakistan gornment don konfamate dia doings, say dem fire Afghan cities, like Kabul and Kandahar, all collect for early Friday, afta Afghan Taliban attack Pakistani border soldiers late Thursday. Taliban tuk, tuk put for X say, dem fire back for Pakistan border, but di post, dem don delete am. Both Pakistan and Taliban dey claim say, dem sactta ground, despite ceasefire tuks since last October.

todayFebruary 27, 2026 3

obodo oyinbo

US-Iran Make Big Progress For Nuclear Tuk

By: Esther Ayoola Omani foreign minister Badr Albusaidi, say US and Iranian officials don make “big progress” for nuclear tuks for Geneva dis week. Badr clear tori pipo on Thursday afta di meeting for Geneva, say dem plan to continue tuks  sha  afta dem go back dia countries, and technical-level discussion go hapun for Vienna next week. Iran foreign minister Abbas Araghchi sef clear mata say dem agree for some […]

todayFebruary 27, 2026 3

National

How Gunmen Use AK-47 Kpai Kpai 150 Pipo For Yelwata

By: Esther Ayoola Federal High Court for Abuja hear word yesterday oh, dem hear word say more than 100 AK-47 gunmen attack Yelwata community for Guma Local Government Area, Benue State, kpai over 150 pipo and burn house dem. Di court, wey Justice Joyce Abdulmalik dey hear, remand nine pipo, Ardo Lawal Mohammed Dono, Ardo Muhammadu Saidu, Alhaji Haruna Abdullahi, Yakubu Adamu, Musa Mohammed, Abubakar Adamu, Shaibu Ibrahim, Saleh Mohammed, […]

todayFebruary 27, 2026 3

National

NNPP Chief Galadima Advice APC On Security

By: Esther Ayoola One Senoir man for New Naija Peoples Party, Buba Galadima, don shake table jigijigi say boys fit serious with 2027 election, sake of say, dem nor dey get am clear for di President Bola Tinubu gorment. Di NNPP senior man dey yan dis one for TV sit don tuk on  Thursday, say, if Nigerians fit comot President Goodluck Jonathan from office dat time because of security, dem […]

todayFebruary 27, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app