Blog sidebar

Background

National

NNPP Clear Marras On Who Be Dia Party Leader

By: Esther Ayoola National Vice Chairmo of New Nigerian Pipo Party  for Northwest, Sani Danmasani, don reveal tuk say oga Govo of Kano state, Abba Yusuf, na be di real leader of di party, no be Rabiu Kwankwaso. Im sukili dis one for inside statement, say according to NNPP constitution, anybody wey be sitting governor and party member automatically be leader, and na why Abba Yusuf take get dat position […]

todayJanuary 6, 2026 5

Sports

Chelsea Carry Liam Rosenior E As New Head Coach

By: Esther Ayoola Chelsea don carry Liam Rosenior to con be dia new men head coach, say dem wan build strong team and return to top football. Di Club confamate dis report for dia official website, say Rosenior sign contract wey go run reach 2032, afta e do well for France with Strasbourg and carry dem enter Europe for first time in 19 years. Chelsea tuk say Rosenoir show beta […]

todayJanuary 6, 2026 5

National

APC National Secretary, Wike No Be Our Member

By: Esther Ayoola APC National Secretary, Ibrahim Abdullahi Basiru, tuk say former Governor Nyesom Wike no be member of APC, so e no get right to interfere for party affairs. E yarn dis one for official APC X page afta Wike warn am make e no touch Rivers politics. Basiru tuk say as National Secretary, e get duty to protect APC and all im members and structures. E add say […]

todayJanuary 6, 2026 7

National

Minister Of Information Declare Say Tinubu Reforms Wan Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Information and National Orientation Minister, Mohammed Idris, tuk say dis year budget na to make sure President Bola Tinubu reform dem dey yield better result. Idris yarn dis one for one ogbonge paper, wey dem call “A Defining Moment for Nigeria: Why Staying the Course Matters.” E tuk say di budget na to support wetin dey work and make sure plenty Nigerians fit enjoy better life faster. […]

todayJanuary 6, 2026 8

National

Ondo Govo Ginger Im Mehn To Deliver Key Projects

By: Esther Ayoola Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, enter area oh dey ginger mehn for all ministries, departments and agencies say make dem show workings, deliver projects and programmes wey people dey expect. Him yarn dis one on Monday for Ondo First Working Day Prayer Meeting for 2026 for Governor’s Office, Akure. Governor Aiyedatiwa sha beg citizens make dem support government by dey patriotic and responsible.

todayJanuary 6, 2026 6

Lagos

Lagos Pastor Nor Show Face For Police Station Over Rape Case

By: Esther Ayoola Police say Senior Pastor of Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, no honour invitation wey dem give am to report on Monday by 10am for State CID, Panti, Lagos, over alleged rape and other offences. Police Public Relations Officer, Abimbola Adebisi, tuk on Sunday say di invitation na order from Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, afta several complaints reach police. According to police, dem invite […]

todayJanuary 6, 2026 12

Sports

Anthony Joshua Dey Consider Quit Boxing

By Ebi Oboko Former world heavyweight champion Anthony Joshua say, like dis, dey plan to quit or to continue boxing. According to im uncle, Adedamola Joshua wey conversate dis marra give tori pipo, say, after di tragic car accident for Nigeria wey kill two of im close friends, Joshua tell im family say e wan stop while people still dey greet am. Di uncle tuk say di family sef dey […]

todayJanuary 6, 2026 14 3

Lagos

Governor Sanwo-Olu Do Give away for Lagos Military Veterans

By Ebi Oboko Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don do give away with N100 million, four two-bedroom houses for Ajara, and two pick-up vehicles to Lagos Chapter of Nigerian Legion. Im tuk dis one on Monday during State Executive Council meeting for Lagos House, Ikeja, as part of the launch for 2026 Armed Forces Remembrance Day Emblem. Di Govo say, him dey do dis to remember fallen heroes wey serve […]

todayJanuary 6, 2026 12 1

Sports

Super Eagles Mash Mozambique 4-0, Enter AFCON 2025 Quarterfinals

By Ebi Oboko Nigeria show beta character hammer Mozambique 4-kondo for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16 for Fez, Morocco, comot for quarterfinals. Ademola Lookman score first goal for 20th minute come still assist Victor Osimhen make e double the lead. Osimhen score again for second half, before Akor Adams finish quick counter make am  4-0. Super Eagles dey ginger for their chase of fourth AFCON title as […]

todayJanuary 6, 2026 8

foreign

Maduro Cry Kidnap, as US Drag Am Go Court

By Ebi Oboko Venezuela Presido, Maduro, 63, don go tell one US court for New York say dem kidnap am comot Venezuela, and say e no guilty, as e still dey claim say e be president. Im wife, Cilia Flores, too talk say she no do anything bad, as both of dem appear for court. US commandos carry dem early Saturday, and later President Donald Trump announce say America don […]

todayJanuary 6, 2026 8 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app