Blog sidebar

Background

Lagos

Aspirants Accuse Speaker Obasa Of Cornering Election Results For Agege

By : Jolayemi Olajide Fresh wahala don burst inside Lagos APC as one House of Assembly aspirant for Agege Constituency II, Mutiu Oladebo, wey many people know as Okadigbo, dey accuse di Speaker, Mudashiru Obasa, say im corner di primary election results. Okadigbo claim say na im clear di direct primary election, but di Speaker use power from above change di game to give di ticket to another aspirant wey […]

todayMay 22, 2026 6

Sport Yarns

Lawal Tuk Say NPFL Players Must Use Dia Chance Well For Super Eagles

By : Jolayemi Olajide Former Nigerian international, Garba Lawal, don tell NPFL players say make dem no dull at all as dem get chance to wear Nigeria national football team jersey for di Unity Cup wey dey come. For siddon tuk show, Lawal yarn say make players use dis big chance to show wetin dem get for inside Super Eagles. Di Super Eagles go defend dia Unity Cup title for […]

todayMay 21, 2026 14

obodo oyinbo

Belle Dey SweetSake of Say Trump Wan Follow Am Yarn

By : Jolayemi Olajide Taiwan Presido, William Lai Ching-te don talk say him belle dey sweet am to yarn with US Presido, Donald Trump, say na move wey fit scatter over 40 years diplomatic protocol and fit vex China. Trump tell tori pipo on Wednesday say e go call Lai, as White House dey plan to sell heavy weapons and arms package giv Taiwan. Since Trump return from im meeting […]

todayMay 21, 2026 9

OBODO NAIJA

Na Only Pipo Wey No Understand Politics Go Believe Say I Be Tinubu Boy- Kwankwaso

By : Jolayemi Olajide Former Kano State Govo and National Democratic Congress leader, Rabiu Musa Kwankwaso, don deny claim say e dey secretly work for President Bola Tinubu ahead of 2027 presidential election. E talk dis one for TV siddon tuk, where e say people wey dey spread di talk no really understand politics at all. E still talk say him and him supporters dey work for NDC and for […]

todayMay 21, 2026 9

OBODO NAIJA

By : Jolayemi Olajide Newton Isokpehi, di officer wey spark outrage afta e threaten to shoot people wey record am, don post video on Thursday to beg Nigerians for forgiveness. E explain say im earlier threat happen out of frustration, and e clarify say e no truly get problem wit citizens recording police activities. Di officer use di video to showcase di many gunshot wounds wey e get from im […]

todayMay 21, 2026 12

OBODO NAIJA

Police Officer Threaten To Shoot Anybody Wey Record Am

By: Jolayemi Olajide Newton Isokpehi, one officer wey claim 26 years of service, spark outrage on Wednesday afta e threaten to shoot any person wey dare record am while e dey duty. Di viral video show as di officer angrily use Pidgin warn public members and senior colleagues against filming police operations. Dis incident erupt for social media wia di officer boldly declare im readiness to attack any person wey […]

todayMay 21, 2026 13

Lagos

Hamzat Win Big for APC primary as Sanwo-Olu tank Voters

By : Jolayemi Olajide Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu and his deputy, Dr. Obafemi Hamzat, don tank APC members well-well as dem come out for numbers to vote inside the party primary election wey happen across the state. Inside the peaceful voting wey happen for all the 377 wards, party members pick Dr. Hamzat as dem consensus governorship candidate for the 2027 election, where him pack 2,210 votes for his […]

todayMay 21, 2026 6

obodo oyinbo

Marco Rubio Call For New Relationship Between United States

By : Jolayemi Olajide United State Secretary of State, Marco Rubio don bring new proposal for relationship between United States and Cuba, as e talk say dem fit give $100 million food and medical support. For video message wey e send go Cuban people on Wednesday, Rubio talk say dis plan fit open new door between Washington and Havana as di money go hellep solve food and drug wahala wey […]

todayMay 21, 2026 6

OBODO NAIJA

Road Clear For Ogundu Chinda, After Fubara, Others, Comot For Rivers Governorship Race

By : Jolayemi Olajide Di road don clear well-well for di 10th National Assembly lawmaker wey dey represent Obio/Akpor Federal Constituency, and kinsman of FCT Minister Nyesom Wike, Ogundu Chinda to carry di governorship ticket of All Progressives Congress (APC) for Rivers State. Di road clear after Governor Siminalayi Fubara, Alabo George-Kelly and Tonye Cole comot dia body from di APC Governorship primary race wey go hold on Thursday. Fubara, […]

todayMay 21, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds