Blog sidebar

Background

Sport Yarns

Rice and Odegaard to Face Each Other for World Cup quarter finails On Saturday

By : Jolayemi Olajide Declan Rice of England and Martin Odegaard of Norway go meet each oda for di FIFA World Cup quarter-final. Di two players be teammates for Arsenal Football Club in London, where dem help di club win di Premier League title and reach di UEFA Champions League final. But now, dem go stand against each oda because Rice dey represent England, while Odegaard dey captain Norway. Both […]

todayJuly 10, 2026 12

obodo oyinbo

Zelenskyy Want Ukraine Start To Dey Produce Patriot Missiles

By : Jolayemi Olajide Ukraine President Volodymyr Zelenskyy don say im country must quick start to dey produce Patriot interceptor missiles after America agree to give dem licence for di production. Zelenskyy tok dis one after im return from NATO summit, saying President Donald Trump don already approve di plan and now na for technical teams to begin work sharp-sharp. According to am, local production go help Ukraine tackle shortage […]

todayJuly 10, 2026 14

Lagos

How Heavy Lagos Traffic Trap Drivers for Oshodi-Apapa Express

By : Jolayemi Olajide Nor be small tin sup for popular Oshodi-Apapa Expressway completely,  say traffic show  commuters and motorists beta shegge yesterday. According to aproko pipo say na di Nigerian Ports Authority (NPA), nor too coordinate tin naim cause di jogolo. Di whole expressway block after container trucks and fuel tankers line up anyhow to enter di nation’s busiest seaports and depots without any orderly arrangement. As at di […]

todayJuly 10, 2026 9

Politics

Police Raid House Thrice, Arrest Papa Of PFIPC Boss Over N1.3 Billion Budget Scandal!

By: Jolayemi Olajide Police  don raid di house of Pa Adetunji Adeniyi three times inside two days for Ogbomoso and arrest di old man as dem dey find him pikin son, Adeyemi, wey be di boss of di fake PFIPC agency. Dis raid happen after President Bola Tinubu give ICPC 30 days to investigate how di non-existent council take secure N1.3 billion allocation inside di 2026 budget. As di palava […]

todayJuly 10, 2026 11

OBODO NAIJA

Soldier-dem Belle Don Sweet As Federal Government Double Dem Minimum Monthly Salary To N100,000!

By:  Jolayemi Olajide Naija soldiers don dey jubilate now as di Federal Government don bless dem with massive alert after dem double dem minimum monthly salary from forty-nine thousand naira to one hundred thousand naira. Na di Minister of Defence, Christopher Musa, break dis beta tori during one television siddon-tuk for Abuja, where he clear mouth say di increment na to make our army get mouth and do well for […]

todayJuly 10, 2026 16

Sports

Rice And Odegaard Go Face Each Other For World Cup Quarter Finals

By Oluwatosin Ibrahim Declan Rice of England and Martin Odegaard of Norway go meet each other for di FIFA World Cup quarter-final. Di two players be teammates for Arsenal Football Club in London, where dem help di club win di Premier League title and reach di UEFA Champions League final. But now, dem go stand against each other because Rice dey represent England, while Odegaard dey captain Norway. Both players […]

todayJuly 10, 2026 13

Politics

Sign Audit Bill Inside Seven Days Or Resign Now! — Atiku Tell Tinubu

By: Jolayemi Olajide Di Former Vice President Atiku Abubakar on Friday give President Bola Tinubu seven days notice make he sign di Federal Audit Service Bill into law or pack his load comot from office. Atiku throw dis stones inside one statement wey his Senior Special Assistant on Public Communication, Phrank Shaibu, release for Abuja because Tinubu never act on di bill months after National Assembly send am give am. […]

todayJuly 10, 2026 12

OBODO NAIJA

Nigerians Dey Complain About Cooking Gas Price

By Oluwatosin Ibrahim Even though supply of cooking gas don improve after Federal Government intervene, many Nigerians don dey complain again say dem sti dey buy gass for ₦1,650 per kilogram. U sabi say, President of di Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, Edu Inyang, say government action help stop panic buying and make gas begin flow well again. Before di scarcity wey start for May, one kilogram of […]

todayJuly 10, 2026 10

south west

Gbege O! Kidnappers Threaten To Kpai Abducted Oyo Pupils And Teachers If Military Move!

By: Jolayemi Olajide Defence Minister Christopher Musa on Friday yarn say dangerous kidnappers don threaten to kpai di pupils and teachers wey dem carry for Oriire Local Government Area of Oyo State. Dis heavy threat land after di military try to go rescue di victims, but di kidnappers warn say dem go kpai everybody if soldiers advance any further. Di Minister explain for Abuja say dis bad boys dey use di […]

todayJuly 10, 2026 8

OBODO NAIJA

How Naija Gofnors Take Fry Mouth On Di Creation Of State Police Mata

By Oluwatosin Ibrahim On Thursday for Abuja, gofnors, lawmakers, security experts, and gofment officials meet to discuss state police reform for Nigeria. Supporters say state police go help fight kidnapping, terrorism, banditry, and other crimes by improving security for communities. Di meeting hapun after wi oga Presido, Tinubu set up a committee to create rules for di new policing system. Di law go allow states to get dia own police […]

todayJuly 10, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds