Blog sidebar

Background

National

Defence Minister Drop Updates, Say Di Fight Against Terrorist Continues

By: Esther Ayoola Defence Minister, Christopher Musa, don tell Nigerians to hold di calm, dat gornment dey really battle terrorism. Na afta security meeting wey President Bola Tinubu hold for Aso Rock with service chiefs and new Police IGP Tunji Disu, Musa take dey tuk dis one E say di meeting na to update oga presido on di security situation, especially afta di deadly attack for Ngoshe community for Borno […]

todayMarch 13, 2026 4

National

Former IGP Egbetokun Hand Over To Disu As New IGP

By: Esther Ayoola Former Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun, don charge im successor, Olatunji Disu, make e carry Naija Police go higher level. Egbetokun tok dis one on Thursday during im pull-out parade wey hapun for Louis Edet House, Force Headquarters for Abuja. For im farewell speech, Egbetokun officially hand over leadership of di Force give Disu as di new IGP thank wella, wella.

todayMarch 13, 2026 4

National

FG Receive 371 Solar light From Gavi, UNICEF

By: Esther Ayoola Di Coordinating Minister of Health and Social Welfare, Prof Ali Pate, on Thursday for Abuja say di Global Vaccine Alliance and UNICEF don officially hand over Primary Health Cares Solarisation Project give wi Federal Gornment. According to am, di project wey di National Primary Health Care Development Agency organise say na to put solar light for 371 primary health centres across 17 states to hellep clinics. Pate […]

todayMarch 13, 2026 3

National

Police Commission Promote 13 CPs Go AIG Rank

By: Esther Ayoola Police Service Commission don approve promotion for 13 Commissioners of Police (CPs) go higher rank of Assistant Inspectors-General of Police (AIGs) afta dem pass written exam and interview for Abuja. Names of di promoted officers include Emmanuel Ado Christopher, Joseph Eribo, Dantawaye Miller, Uche Ifeanyi Henry and Olarenwaju Peter Ogunlowo among odas. For di same exercise, 17 Deputy Commissioners of Police (DCPs) sef don rise go Commissioners […]

todayMarch 13, 2026 3

obodo oyinbo

Oil Price Move Pass $100 As Iran Attack Gulf Ships

By: Esther Ayoola International Energy Agency (IEA) say oil price don high again oh, pass $100 per barrel on Thursday, as new attack for Gulf hit oil ships. Say, Strait of Hormuz, wey dey carry one-fifth of world oil, don almost close because Iran dey attack ships and dia Gulf neighbors. One oil tanker off Iraq explodes, one crew man kpai, and another cargo ship catch fire from shrapnel, di […]

todayMarch 13, 2026 3

obodo oyinbo

U.S Lawmakers Put Bill To Hellep Investigate How Israeli Forces Take Kpai Civilians For Gaza

By: Esther Ayoola Five U.S Democratic lawmakers don bring one ogbonge bill to make gornment investigate, who kill five-year-old Palestinian pikin, Hind Rajab, her family and di paramedics wey try save her. Senator Peter Welch and four oda representatives tuk say di bill go make Trump administration answer questions about di way civilians dey suffer for Gaza. Di bill come afta one video go viral of Hind Rajab, calling for […]

todayMarch 13, 2026 2

obodo oyinbo

U.S Police Gbab Suspected ISIS Bombers

By: Esther Ayoola Say Police don arrest two men wey bin dey try bomb for anti-Islam protest wey hapun Saturday outside Gracie Mansion, di official residence of New York City Mayor Zohran Mamdani. Di suspects, 18-year-old Emir Balat and 19-year-old Ibrahim Kayumi, reportedly prepare and throw two explosive devices, but thankfully none of dem blow. According to NYPD Commissioner Jessica Tisch, police later discover anoda bomb inside dia car. Authorities […]

todayMarch 13, 2026 4

Sports

3SC Shine For Ibadan, Beat Rivers United 2-1

By: Esther Ayoola Shooting Stars Sports Club (3SC) for Ibadan beat Rivers United FC 2-1 for dia rescheduled NPFL Match Day 24 game wey hapun for Lekan Salami Stadium on Thursday. Na dia 13th win dis season, wit 5 draws and 11 losses, now dem dey  6th position for di league table. For home matches, 3SC dey strong, with 11 wins, 2 draws, and 1 loss, but dia away form […]

todayMarch 13, 2026 2

Sports

Moffi Score, Sanusi Give Assist As FC Porto Beat Stuttgart 2-1

By: Esther Ayoola Terem Moffi score one goal and Zaidu Sanusi give assist as FC Porto beat Stuttgart 2-1 away for dia UEFA Europa League Round of 16 first leg game for Germany on Thursday. Moffi start di game but comot for 59th minute, while Sanusi play full 90 minutes. Moffi open scoring for di 21st minute, and later Sanusi set up Rodrigo Mora to make am 2-0. Stuttgart reduce […]

todayMarch 13, 2026 2

Sports

D’Tigress Lose 77-60 To South Korea For FIBA World Cup Qualifier

By: Esther Ayoola Naija’s D’Tigress don lose to South Korea 77-60 for dia second game for di qualifying tournament for di 2026 FIBA Women’s World Cup. Di last time D’Tigress lose na for quarter-final against United States for di Paris 2024 Olympics. Dem enter South Korea game on Thursday afta dem knack Colombia for dia first match for Wednesday. For di first quarter, South Korea  lead 20-16, and even though […]

todayMarch 13, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app