Blog sidebar

Background

National

INEC Arrange Mehn For Voters Registration

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission (INEC) don resume nationwide voter registration again and say dis na di second phase of Continuous Voter Registration for di obodo Naija. Chief Press Secretary to INEC chairman, Na Adedayo Oketola, confirmation dis particular mata give tori pipo on Monday Dis new phase come afta the first round of CVR wey end officially on December 10, 2025. INEC dey ginger say Nigerians […]

todayJanuary 5, 2026 7 6

National

FG Roll Out New Plan To Stop Exam Malpractice

By: Esther Ayoola Wi Federal Government don roll out new plan to fight mangomango for WAEC and NECO exams starting from 2026. Di announcement drop on Monday for Abuja, as Education Minister Maruf Alausa and Minister of State Professor Suwaiba Ahmed troway di mata comout. Dem tuk say di new move go tighten monitoring from start to finish and block every backdoor wey pipo dey use cheat for exams. Government […]

todayJanuary 5, 2026 6 2

National

President Tinubu select For Senator Magnus Abe Chairmo Of NUPRC

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don nominate former Senator, Magnus Abe as chairmo of di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC), plus 20 other pipo for boards of key oil agencies. Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk  for statement on Monday say Abe go lead NUPRC board together with other non-executive commissioners like Paul Jezhi and Sunday Babalola. Tinubu also nominate […]

todayJanuary 5, 2026 5

Lagos

Lagos Police Face Accusation Say Dem Collobi Sombodi ₦3.3M

By: Esther Ayoola Say accusation reach Police officers for Area H Command, Ogudu Lagos, head dat dem collect about ₦3.3 million ($2,000) from one couple wey dem wrongfully arrest early mor mor, for December 18, 2025. Some independent investigators ni touchlight dis mata dey tuk say afta di mata trend for X, di police return ₦2.2 million but dey beg make dem keep ₦1 million, say di money dem don […]

todayJanuary 5, 2026 10 10

obodo oyinbo

US Commandos Grab Maduro, Carry Am Go New York Court

By: Esther Ayoola Dem don carry comot former Venezuela president, Nicolas Maduro, reach New York court on Monday, few days afta US military grab am for Caracas. US say dem arrest am and him wife, Cilia Flores, because of drug trafficking case. Soldiers use helicopter, fighter jet and navy take dem comot Venezuela on Saturday. Meanwhile, interim leader Delcy Rodriguez don soften stance and tuk say she fit work with […]

todayJanuary 5, 2026 3 4

National

Sowore Drag Mata Say New Tax Law Go Suffer Pipo

By: Esther Ayoola Di 2023, African Action Congress, AAC, presidential candidate, Omoyele Sowore, don raise concern say Nigeria new tax reform no good for poor pipo. Sowore dey tuk for TV sitdon tuk, Nigerians don already suffer well-well and adding more tax go only make life harder for dem. Sowore say government suppose focus on bringing more pipo into di tax net instead of taxing pipo wey already dey manage […]

todayJanuary 5, 2026 8 6

Sports

EPL: Man U Appoint Fletcher As New Coachie After Amorim Sack

By: Esther Ayoola Unto update from Old Trafford, say Manchester United don appoint  U18 coachie,  Darren Fletcher as replacement of Amorim, to take charge di senior team until further notice, to steady things for club. According reports, Amorim meet director of football Jason Wilcox and CEO Omar Berrada early mor mor on Monday, wia dem serve breakfast say dem nor want am again. Nor be small tin dis dey cause […]

todayJanuary 5, 2026 9 4

National

SEMA: Yobe Boat Tumbo Kill 29

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Yobe, boat get accident kill 29 pipo, and dem still dey find about 10 wey lost for water. Secretary of di State Emergency Management Agency (SEMA), Mohammed Goje tell tori pipo on Monday dat, rescue work still dey go on, as dem dey try find di remaining people. According to reports say na overloading ni cause di problem, but dem […]

todayJanuary 5, 2026 10

National

Makinde Shake Oyo Cabinet, Sack SSG Adeyemo

By: Esther Ayoola Oyo State Govo Seyi Makinde don announce cabinet reshuffle, on Monday, say im dey observe some kpiance doings. For di move, e sack Secretary to di State Government, Prof Olanike Adeyemo, with immediate effect, According to statement wey im media aide Sulaimon Olanrewaju release for Ibadan, Governor Makinde appoint Prof Musibau Babatunde as di new Secretary to di State Government. E still move Barrister Temilolu Ashamu from […]

todayJanuary 5, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app